15-07-2025
Meet di grandpa dem wey dey run car wash for Enugu Nigeria
Emeka Ede, now 70 years old bin enta car wash business wen e fin work many years ago but e no see and e decide to join di group of car wash for Enugu, Southeastern Nigeria.
"I be 70 years now and 42 years for car wash and e make me to dey strong, if I no work for one day, two days, I no go get myself."
Dis na true life tori of one old man wit im oda colleagues about how dem dey live dia life for many years.
For dis car wash wey dey along Nkpokiti road for Enugu Nigeria, na old men dey work for dia and dem dey enjoy wetin dem dey do.
BBC News Pidgin enta Enugu to meet and speak to dis men to know wetin dey build and fuel dia energy for di car wash business despite dia age.
Dis group of older men wey dey ova 70 and 80 years come togeda to form Ochomma association of car wash.
Dem say dem dey do di car wash business to keep fit and make money to fit feed dia families.
I sidon for hours wit dis men to see how dem dey operate, how dem dey get customers and run dia jobs evri day.
E dey surprising to find say dis men stand for long sake of say dem gatz hustle for customers wey dem go wash dia car.
All thru our stay wit dem, dem no quarrel and nobodi abuse di oda - but dem gada dey work togeda and help each oda.
Mr Emeka tok say im don spend 42 years for car wash business inside Enugu wia e join im oda mates to dey wash vehicles evriday.
"We get law say if you see motor wey dey come, first to rush go be di one to wash di motor. And we no dey allow all dose small boys to come here," Mr Emeka tell me.
E say di work dey make am fit and im dey take am as exercise for im bodi.
Anoda memba of di carwash team na Mr Ferdinand Okoye wey be 81 years old. E surprise me to see pesin of im age to dey do di car wash business but e say im like am.
"For this business ehn, pipo don tell me say how I like to dey wash car for dis age. I tell dem say well, I like am," Mr Okoye tok.
For Mr Okoye, e fit wash up to three to four cars in one day and dat go fit put food for im table for di day.
E dey sweet Mr Okoye for belle say di work dey make am fit and di only reason im no go come work any day na if e no well.
"You know say na part of exercise wey we dey do. Na im make me like dis work."
Dis car wash get about ova 20 old men wey dey work for dia, and according to dem, na means to make dia daily bread and also keep dia bodi fit.