Latest news with #Stonebwoy


BBC News
10-05-2025
- Entertainment
- BBC News
Who go win Artiste of di Year for 2025 Ghana Music Awards?
Na dat time of di year again, as di music industry for Ghana go crown ogbonge artiste wey bin work hard for di last one year. Di Ghana Music Awards na di kontri flagship award wia im dey reward artistes, producers and oda pipo. Last year, afro-dancehall artiste Stonebwoy bin win Artiste of di Year, na so im still dey for dis year category. Dis year na di 26th year of di Ghana Music Awards, wia no musician don win Artiste of di Year two times in a row. Ahead of di event wey go happun on 10 May 2025, organisers bin do plenti activities; from pre-awards high school tour to music masterclass and oda tins, wia di time don reach to know who go win what for di night. For di category - artiste of di year, seven musicians and groups dey nominated. Stonebwoy, King Promise, King Paluta, Black Sherif, Kweku Smoke, Team Eternity (gospel group) and Joe Mettle (gospel musician) na di nominees for artiste of di year. But out of dis five, so far three be favourites to win, according to sabi pipo. Na so di three camps bin dey pursue fans and citizens to vote for dia favourite to win. Music fans, di board of di Ghana Music Awards scheme, and di awards academy dey responsible to vote for who go win. Who be di favourites to win artiste of di year? King Promise Di singer na di favorite to win di award according to sabi pipo like Arnold Asamoah Baidoo. "I believe say na di year for King Promise to win dis award, sake of im work hard thru di year," oga Arnold tok. Im tok say Stonebwoy and King Paluta also bin work hard but King Promise dey ahead. Since 2021, King Promise bin dey drop hit songs wia im get plenty nominations. But for di last one year, di musician get four hit songs from im True to self album - "Paris" "Continental" "Sexy" and "Favouite Story". All dis songs also bin dey nominated. Dis songs don trend on top social media, for di streets, for clubs, events and many oda places. King Promise also do international collaborations, wia im na one of di artistes wia pipo don stream im songs across all di streaming platforms. Dem nominate King Promise for music video of di year, album of di year, best Afro beat song, song writer of di year, international collaboration and most popular song of di year. Stonebwoy Di Afro-dancehall artiste na di reigning artiste of di year, afta im beat King Promise to win di award for 2024. Stonebwoy afta dat award, neva rest as im drop im "Up and Running" album. On top dat album im get some hit songs wey bin dey play for clubs, pubs, events and oda places. Songs like "Jejereje" "Jiggle & Whine" Psalm 23" "Memories" "Beta Tin" na di hits from dat album wey dey on top pipo dia playlist. Stonebwoy feature Jamaican dancehall queen Spice on top im 'Jiggle & Whine' song wia trend for di kontri. Im also get some streaming numbers wia im play shows outside di kontri wey include im sold-out London concert for im 'Up and Running" album tour, di 2024 Cali Vibes festival for California among odas. Stonebwoy im tok tok pesin, Vida Adutwumwaa bin tok say "di artiste im consistent work, street credibility and international success dey make im strong contender to win di award." She also believe say sake of di dancehall artiste get di most nomination for dis year awards (9) e mean say im work hard. Apart from artiste of di year category, im dey nominated for album of di year, reggae/dancehall artiste, reggae/dancehall song, most popular song, best music video, international collaboration and most popular song. Stonebwoy already bin win artiste of di year two times (2015, 2024), im believe say for 2019, na im win di prize again but organisers charterhouse bin suspend di announcement sake of fight don happun for di awards night between Stonebwoy and im rival Shatta Wale and dia fans. Di event organisers now ban di two artistes for di role dem play for dat confusion dat day until dem lift di ban on di two artistes for di year 2021, na so Stonebwoy don begin to dey file nominations but Shatta wale tok say im no wan dey part of di awards scheme. If Stonebwoy win di artiste of di year dis year, e go mean say ma im be di artiste wit di most artiste of di year awards (3), but na di votes of di public, di board and di academy wey go show who go win am las las. King Paluta King Paluta for 2024 bin win new artiste of di year and hiplife song of di year for di Ghana music awards UK and Europe. For di 2025 awards, King Paluta get five nominations (popular song of di year, highlife song, best hiplife artiste of di year, and album of di year. Di artiste im hit songs "Aseda" "Apicki" na songs wey bang well well across di kontri for political platform, parties, club and oda places. Di artiste im manager, Cofy Dela tok say "by di records, Paluta deserve to win artiste of di year sake of di impact im make for di industry wia im dominate everywia." "Paluta get three hit songs during di year under review, wia di songs bang for evriwia, na street anthems wia dem play dem on di radio," im manager tok. Oda pipo like gospel musician Joyce Blessing bin support di Makoma hit-maker to win di award dis year. King Paluta apart from di political rallies, also perform for plenty events and schools for di kontri wia im dey nominated for di category of best hiplife/hiphop artiste. Im also perform for some events for di US and UK. Odas for di artiste of di year category Black Sherif na one of di musicians for di artiste of di year category but many pipo tink say im no work to reach di level of king promise and Stonebwoy and King Paluta for dis year. But im be ogbonge musician wia im still get hit songs and some collaborations wit Burna Boy, Fire boy and odas. Even tho im neva be favourite to win dis awards, im get oda nominations like best hiplife/hiphop artiste, best hiphop song, best hiplife song. For 2023, Black Sherif win artiste of di year for di awards wia im go look forward say im go fit to win am again next year. Joe Mettle - Oga Mettle na ogbonge gospel artiste for di kontri. Im also bin win artiste of di year bifor for di year 2017. Bifor Joe Mettle bin win artiste of di year, no gospel musician for Ghana bin win dat award. But sabi pipo tok say for di year under review, even tho Joe Mettle get personality and history, im no work like di oda pipo for dat category. Di gospel artiste get oda nominations for di awards like best vocal performance and best urban gospel song. Team Eternity - Di oda gospel group wey dey di category of artiste of di year also dey di category for most popular song of di year, and gospel song of di year wit dia hit song "Defe defe". On top all Christian events, dem play dis song, wia Team Eternity also bin perform di song for plenty events. Some pipo tink say dem fit win artiste of di year but dia chances dey slim. Kweku Smoke - even tho di artiste no get trending songs wey dey play on top radio and television, im dey popular for di streets. Im get at least two oda nominations for di music awards dis year. Pipo tok say im get talent wia im songs get good lyrics. Im play many shows wia fans don dey sing im songs word-for-word. For many pipo, Kweku Smoke na pipo pesin, but as to weda dat go make am win di ultimate award, time go tell. For pesin to win di artiste of di year award, im gat to dey adjudged by di academy, di board and di public as di artiste wit; - Di highest audience appeal and popularity for di year under review - Di artiste gatz release hit single/EP/Album - Di artiste gatz be one of di pipo wit di highest number of nominations for di year. Oda categories for di Ghana Music Awards Best new artiste Lali x Lola AratheJay Rap Fada Team Eternity Beeztrap Kotm Kwasi Amewuga Best male vocal performance Kofi Nuel - Do not fear Emmanuel Juddah - Aseda MoG Music - Ahuoden Fofro Ayisi - Can I live Joe Mettle - Obo Awon Oba Best female vocal performance Naana Asiedu - Defe Defe L'ordine the soprano - Simply trusting everyday Esther Goodwyll - I choose to praise Titi Owusu - Nobody Mima Afrika - On fire Best Hiplife/Hiphop ariste Amerado Beeztrap Kotm Kweku Smoke Black Sherif King Paluta Sarkodie Medikal Best rap performance Eno Barony Kweku Smoke Okyeame Kwame Sarkodie Lyrical Joe Flowking stone Best gospel artiste Piesie Esther Joe Mettle Empress Gifty Diana Hamilton Team Eternity MoG Music Best hiphop song Joey B - Princess Kweku Smoke - Holy Ghost Kwaw Kese ft Kofi Mole - Awoyo Sofo Black Sherif - Kilos Milos Sarkodie ft Beeztrap - Amen Beeztrap & Oseikrom Osikani - Fly Girl Best Afro beat song Olivetheboy - Asylum Lasmid - Puul Kidi ft Black Sherif - Lomo Lomo Mr Drew - Sneaky King Promise - Favorite Story Beeztrap Kotm - Yesu Best hiplife song Eno Barony ft King Paluta - Soja Go Soja Come Black Sherif - Rebel Music Tulenkey ft Beeztrap - Bad Feeling Okyeame Kwame ft Kuami Eugene - No competition Sarkodie - No sir Lyrical Joe ft Kuami Eugene - Enter Best highlife song Kuami Eugene - Canopy King Paluta - Aseda Fameye - Very Soon Amerado - Abronoma Rap fada ft King Paluta - Odo bi ye bad Kofi Kinaata - Effiekuma broken heart Best urban contemporary gospel Scott Evans - Call Joe Mettle ft Sandra Duah - Give me oil Nana Yaw Ofori Atta (Team eternity) - Defe Defe Kobby Salm - Cast your burden Ohemaa Mercy ft Kofi Owusu - Dry Bones Best traditional gospel song MoG Music - Wo Ye Diana Hamilton - The doing of the lord Mavis Asante - Victory Queendalyn ft Judikay - Omewoya Empress Gifty - Watch me Piesie Esther - Ateene Best Reggae/dancehall song Amerado ft Shatta Wale - Ankomoma remix Stonebwoy - Psalm 23 Ras Kuuku - Road to evil Samini - Chemistry Jupiter - I keep winning Moliy & Silent Addy - Shake it to the max Best reggae/dancehall artiste Jupiter Samini Ras Kuuku Epixode Stonebwoy Rocky Dawuni Songwriter of the year Ayisi Kofi Kinaata Okyeame Kwame Olivetheboy Team Eternity Telecel most popular song OliveTheBoy - Asylum Kidi ft Black Sherif - Lomo Lomo Lasmid - Puul King Paluta - Aseda Black Sherif - January 9 King Promise - Paris Team Eternity - Defe Defe Stonebwoy - Jejereje Di 26th Telecel Ghana music awards go happun live for di Grand Arena on Saturday 10 May at 7 PM GMT (8PM WAT). Refresh dis page for more updates.

Associated Press
14-04-2025
- Entertainment
- Associated Press
Stonebwoy to Headline 2025 HoodTalk Music Festival Unity Edition at Independence Square in Accra on May 9
A Global Music and Humanitarian Movement Calling Artists Worldwide to Raise $14 Million for Pediatric Clinics in Ghana—Broadcast to Over 250 Countries 'We plan to achieve SDG 3—health for children—for peace and prosperity. We focus on sustainable health infrastructure that gives every child a chance at life.'— Kofi Amoakohene, Co-founder of the DreamChild Foundation. ACCRA, GHANA, April 14, 2025 / / -- The DreamChild Foundation presents the 2025 HoodTalk Music Festival: Unity Edition, powered by Virtual Hub, StepNorth, Platinum Star Media Group, Inc., and Fly-Away Promotions, Inc., an international cultural phenomenon that unites music, mission, and movement for a powerful cause. This humanitarian event will be headlined by Ghana's global music icon Stonebwoy and broadcast live to over 250 countries on Friday, May 9, 2025, at Independence Square in Accra. With an expected turnout of 15,000+ in-person attendees, the festival calls on artists from around the globe to join the lineup and unite their voices to raise $14 million to build five pediatric clinics across Ghana. 'We plan to achieve SDG 3—health for children—for peace and prosperity,' said Kofi Amoakohene, Co-founder of the DreamChild Foundation. 'Our focus is on sustainable health infrastructure that gives every child a chance at life.' The Power of Unity Through Music Since its inception, HoodTalk has evolved from a grassroots initiative into a globally recognized festival with a purpose. The 2025 theme, 'Connecting Music, Heritage, and Humanity,' empowers youth, celebrates culture, and amplifies the collective voice of artists, creatives, and changemakers. This year's festival is co-hosted by: Dr. Marie Y. Lemelle, PhD, International Goodwill Ambassador for DreamChild Foundation and Platinum Star Public Relations, Inc. CEO. Dr. Hasaan Rasheed, an All-American track star turned actor and humanitarian, is the CEO of Fly-Away Promotions, Inc., whose next feature film—shot in Ghana—will premiere an exclusive trailer during the event. 'Where legends rise and voices unite: Join us as we craft a global crescendo. Your music deserves the world's ears,' said Dr. Rasheed. A Tribute and A Call to Action The 2025 HoodTalk Unity Edition also honors the victims of the May 9, 2001, stadium tragedy, when 127 lives were lost during a football match in Accra. The festival transforms tragedy into tribute, using music to inspire healing and hope. 'I call on the world's youth—particularly the youth of Africa—to play an active role in achieving Sustainable Development Goals (SDGs). The global goals are peace and prosperity for people and the planet. The world needs your creativity, knowledge, reach, and energy to help find innovative solutions to our world's challenges,' said H.E. Nana Akufo-Addo, who served as the 13th president of Ghana from 2017 to 2025. Two-Part Festival Experience The festival includes two key experiences: 1. The Youth Festival – A powerful platform for young voices to lead dialogues on climate change, sustainable development, and African innovation—powered by art, music, and creativity. 2. The CSR Fundraising Drive – The $14 million goal will support the construction and operation of five pediatric clinics in underserved regions of Ghana, ensuring access to critical care for thousands of children. 'Music is the universal language for healing, giving back, and making a difference,' said Dr. Lemelle, CEO/Founder of Platinum Star Media Group, Inc., a talent management company. 'Bring your voice to the world stage to help the children in Ghana have access to hospitals.' All Eyes on Ghana Top-tier hosts MC Merquary Quaye, MC Portfolio, and MC Tell will lead a high-energy celebration. The event will be covered by KGCV DTV, a channel dedicated to HoodTalk, and audiences worldwide can follow updates on: 🌍 📱 YouTube | Instagram | Facebook Among the talent lighting up the DJ booth is the breakout star Naomi Quartey aka DJ Spices, the youngest female DJ to take the stage—bringing fresh energy and representation to this global event. Be Part of the Movement Artists, performers, cultural groups, and changemakers worldwide are invited to apply to perform and support this vital cause. 📧 Performance inquiries and press and talent submissions: [email protected] or text to WhatsApp 1-213-276-7827 Send DM IG @platinumstarpr or @platinumstarmediagroup. 🌍 🌍 HoodTalk 2025 isn't just a concert. It's a movement for health, peace, and possibility—a moment to elevate your voice for the next generation. Dr. Marie Y. Lemelle, MBA, PhD Platinum Star Public Relations, Inc. +1 213-276-7827 email us here Visit us on social media: Facebook X LinkedIn Instagram Other Legal Disclaimer: EIN Presswire provides this news content 'as is' without warranty of any kind. We do not accept any responsibility or liability for the accuracy, content, images, videos, licenses, completeness, legality, or reliability of the information contained in this article. If you have any complaints or copyright issues related to this article, kindly contact the author above.