a day ago
'Na my mama wrapper I take start' - Nigerian man wey dey twist bodi like who no get bone
Tosin Olumade na twenty-seven-year-old aerialist and contortionist wey im kind of art dey totori pipo on social media wia e dey share im videos.
While some pipo dey wonder di kain flexible bodi wey im get, Tosin say odas dey say na AI im dey use for di videos.
Di self-taught contortionist say e dey always try to prove to pipo say im art no be AI.
E say na im mama wrapper im bin dey use to train imsef wen im start im first art.
"If pipo dey tok say dis tin wey I dey do na lie, na AI, which App I use do am? e dey always pain me, and na insult to wetin I do dey do," e tok.
"I start dis tin wit my mama wrapper, I dey always wan to prove dem wrong. Na like dis I dey put my leg, na like dis I dey put my hand."
Tosin say, "I get one act wey be say, if I don put my head for rope pipo dey feel like say dis guy wan take im own life. Evribodi don know say dis particular trick, na Boneless be dat."
Di contortionist tok say wen im bin start for 2022, im dey spend three hours to train im bodi flexibility and e bin hard am to perform den but now wey im don master im trick, im dey spend one hour forty-five minutes to practice.
Tosin tok say im develop im talent from several hours of practice from watching YouTube videos.
"I start dis art for 2022, but my first time no dey easy but di determination don dey dia. I still go di second time. Wen I first start am I dey spend three to four hours but now my warn-up no dey too pass one hour, forty-five minutes," e tok.
Di challenges Tosin bin face
Tosin say one of di challenges wey e don face for di art na wen pipo bin tink say im bin wan take im own life sake of di art.
"Dem call di whole community say I wan take my own life, kon gada around me. How far, wetin dey do you? Dem wan almost beat me. I kon show dem videos for my phone say I dey do exercise."
E say di most challenging part of im art na di use of im teeth wen im dey perform.
"Anytime wey I wan do am, I dey try watch wetin I dey chew."
Tosin tok say im dey highly inspired by di work of America's Got Talent winner, Aidan Byrant and na dat time im kon see di opportunity wey dey in performing as contortionist.
Na Idara Monday film and edit am