2 days ago
Police takeover PDP secretariat sake of NEC meeting, wetin cause kasala for Nigeria main opposition party?
Kasala burst for di Peoples Democratic Party [PDP] secretariat on Monday afta security pipo allegedly harass official s of di party wey wan attend dia National Executive Council meeting.
One video wey di PDP post for dia official social media page show how men wey appear to be police be like say dem dey carry pipo up and force dem out of di premises.
However, oda local media dey report say policemen mount guard for di gate of di hall wey di NEC meeting suppose hold.
Tori be say police officer no allow members of di PDP Board of Trustees [BoT] enta di venue of di meeting.
BBC Pidgin tok to former National Secretary of di Peoples Democratic Party, Kola Ologbondiyan wey confam say armed policemen block di headquarters of di Peoples Democratic Party secretariat for Abuja so dat di NEC meeting no go hold.
"Dem no disrupt di meeting becos di meeting bin neva start, na wetin don already start dem dey disrupt, but wetin happun be say dem no even allow di meeting start, so we don change venue, make una help us ask police who give dem di order to stop members and workers of di PDP?"
Tori be say di police no even allow di BoT members to hold dia meeting wia dem suppose happun ahead of di expanded caucus meeting.
Channels Television report say di former National Secretary of di PDP, Umar Tsauri, tok say di police stop di BoT members, im say dem dey act based on an "order from above".
Even though some staff members of di party bin enta di secretariat freely, police later pursue di staff and journalists from di secretariat.
Wetin dey cause di current wahala
Di former National Secretary of di Peoples Democratic Party, Kola Ologbondiyan explain to BBC Pidgin say di implications of dis two meeting be say "For di last meeting wey happun on May 27, Nec bin hold meeting wia dem bin agree to meet again today June 30.
Unfortunately di Damagun side of di party wey dey work wit some members wey no be part of di national Working Committee [NWC] come up wit decision say dem need to postpone di Nec or change am to a stakeholders caucus meeting."
Im tell BBC Pidgin say nothing like stakeholders caucus meeting dey for di PDP Constitution.
According to him, na Damagun faction dey call for stakeholders caucus meeting now while di oda faction no gree, dem match leg for ground say nothing like stakeholders meeting dey dia constitution and dem go uphold di decidion of diNec meeting wey bin hold of 27 May, wey be di second highest organ of di party.