logo
#

Latest news with #UnitedStatesImmigrationandCustomsEnforcementandRemovalOperations

Nigeria give time first batch of  deportees from Trump US go land and oda details about di process
Nigeria give time first batch of  deportees from Trump US go land and oda details about di process

BBC News

time17-02-2025

  • Politics
  • BBC News

Nigeria give time first batch of deportees from Trump US go land and oda details about di process

Di Nigeria goment don announce say di first batch of Nigerians wey di US goment don deport, go arrive Nigeria dis Monday, 17. February 2025. Dis na according to Bianca Odumegwu Ojukwu, Minister of State for Foreign Affairs for one post wey she make on social media. Ojukwu say she meet wit di United States Ambassador to Nigeria, Richard Mills Jr, and she highlight di concern of di Nigeria goment about di decision of President Donald Trump to deport many Nigerians back to di kontri. "As at now, na about 201 Nigerians currently dey detained for US immigration centres, and about 85 (of dem don dey) cleared for deportation. Di figure dey expected to rise sharply," Madam Ojukwu tok. For her discussion wit di US ambassador, Ojukwu tok say she maintain say "dis deportations, particularly for individuals wey no get history of violent crime, no suppose dey traumatic or sudden and say di individuals need to dey given enough time to handle dia assets rather dan say dem go just bundle dem enta planes and repatriate dem". "Di forced removals of our citizens from US soil must dey in compliance wit internationally prescribed guidelines and established protocols in dis regard and a more humane process supposed dey followed," Ojukwu tok. She tok say di ambassador give am im word say "di repatriations go dey done wit dignity and respect for human rights". At least, ova 3,000 Nigerians wey no get legal documents to stay for America dey face risk of deportation, according to one document wey Fox News get from di United States Immigration and Customs Enforcement and Removal Operations (ICE). Fox News bin report on Tuesday 28 January, 2025 say di Nigerian immigrants don dey ICE non-detained docket wit final orders of removal since November, 2024. Reports say Nigeria na di second highest number of citizens wey dey scheduled for deportation for Africa, followed by Somalia, Ghana, Senegal, among odas. We dey update dis tori.

Di documents you need to stay legally for US as Trump mass deportation begin
Di documents you need to stay legally for US as Trump mass deportation begin

BBC News

time29-01-2025

  • Politics
  • BBC News

Di documents you need to stay legally for US as Trump mass deportation begin

At least, ova 3,000 Nigerians wey no get legal documents to stay for America dey face risk of deportation. Dis na according to local media reports wey quote one document wey Fox News get from di United States Immigration and Customs Enforcement and Removal Operations (ICE). Fox News bin report on Tuesday 28 January say di Nigerian immigrants don dey ICE non-detained docket wit final orders of removal since November, 2024. Di report add say Nigeria na di second highest number of citizens wey dey scheduled for deportation in Africa, followed by Somalia, Ghana, Senegal, among odas. Since President Donald Trump take ova office on 20 January, immigration enforcement operations don start across major US cities. One nationwide immigration crackdown on Sunday, 27 January bin lead to di arrest of 956 pipo. E follow di 286 arrests on Saturday, 593 arrests on Friday and 538 arrests on Thursday. As at November 2024, ova one million non-US citizens bin dey on di Immigration and Customs Enforcement non-detainee register and subject to one final order of removal. Di website say between 2023 and 2024, thousands of African nationals enta United States illegally through Nicaragua. Di first deportation flights wey carry hundreds of undocumented migrants dem deport from di US don land Guatemala and Mexico. Important documents you need to stay for US as legal migrants One cornerstone of Trump immigration policy na to remove unlawful migrants comot di US and di promise of "mass deportations". To stay legally for di US as a migrant, you go need di following documents wey include, valid passport, relevant visa depending on your reason for staying (work, family, asylum), proof of your relationship to a US citizen or sponsor (if applicable), and depending on di visa type. Additional documents like employment offers, birth certificate, marriage certificates, medical records, and financial statements to demonstrate your ability to support yourself for di US dey necessary. Key documents for different immigration pathways For Permanent Residency (Green Card) Di US dey give permanent residents valid Permanent Resident Card as proof of dia legal status for di US. Some pipo dey call am Green Card. To get di Green Card you go need di following. For Employment based-immigration: For Family-based immigration: For Non-immigrant Visas (temporary stay):

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store