4 days ago
Ghana Airforce helicopter disappear
Di Ghana Armed forces don confam say one of dia aircrafts don miss.
Inside one statement di Armed forces say "di GAF helicopter Z9 wey bin take off Wednesday morning at 9:12 AM from Accra bin dey go Obuasi don currently dey off radar."
"We dey do evritin to establish contact wit di helicopter at dis time."
Inside di statement Captain Veronica Adzo Arhin wey be tok tok pesin for di Ghana armed forces tok say "na three crew and five passengers bin dey on board di helicopter as e don comot Accra."
Tori be say some govment officials dey inside di helicopter bifor e don comot di radar.
For Obuasi for di Ashanti region, eye witnesses tok say one helicopter crash for di Adansi Amrofuom District, Wednesday morning.
Dem tok say di aircraft burn beyond recognition.
Govment pipo dey prepare to address di kontri about di latest kasala and to confam di pipo wey bin dey inside di military helicopter togeda wit di three crew members.
We go update dis tori...