05-08-2025
'To Kill A Monkey announce me'
Nollywood actor William Benson sidon wit BBC News Pidgin to share im experience wit di hit movie 'To Kill A Monkey'.
Di movie by ogbonge filmmaker Kemi Adetiba dey make wave for Nigeria after dem release am for Netflix and e don spark conversations online.
Di movie tell di tori of Efemini (played by Benson) a desperate programmer wey hardship push into cybercrime.
Di film show how e enta wahala after one of im old friends - Oboz wey Bucci Franklin play - wey be cybercrime kingpin for Lagos drag am inside a web of fraud, trauma and survival.
Na di lessons wey di movie dey try to bring out wey many Nigerians fit relate wit na im be topic of most of di hot takes online.
"Everibodi don watch di movie and afta dat, everibodi don turn analyst." Benson tok.
"Some go say na Efemini betray Oboz. But dem dey forget say Oboz know who put im pikin inside freezer."
Pipo dey also hail di ogbonge acting of di star actors for di film.
Benson explain say im get ogbonge training on how to take dey enter and come out from character after intense roles so e no go affect im real life.
"My background na say dem train me how to enter character and how to come out.
Di lesson wey I dey try pass across through my work, na lesson I dey hold well like dat scene wey e tell Oboz cut soap for me." Benson tok.
E also share lessons from anoda memorable scene from di film wia Nosa mama - im wife for di movie wey Stella Damasus play - dey always insult am. Benson use dat scene take pass message to mothers.
"E get some kind times wey man no get, no mean say e useless. Instead of insult, wetin e need na prayer and advice" im tok.
Benson also explain say na real-life pressure push Efemini for di film, pressure from family, society and life generally.
"Wen you look Efemini, na life dey fight am from evri angle.
If you combine all di lessons, e be pressure from pipo, family and society, e dey heavy sotey e fit shake pesin foundation."
Anoda tin na say, although Benson no be new actor, di movie don bring am more into di limelight and bring am new fans from everywhere wey bin no sabi am before.
Benson tok about di impact.
"Plenty tins don change. Before I fit call you make we go chop Amala or just waka for street.
But now since di movie come out, anywhere I go na, 'you be Efemini?' Dem go dey point."
Benson wey say im like im private space and no too dey dey social media before now say di movie don collect dat wan from im hand but time bin don reach.
"I bin dey feel say di time never reach. But good product dey announce imself. Now I no go private again."
Benson add say im plan no be to just stop here, na to go all di way to Hollywood.