25-07-2025
'We don make statement wit SIN'
Filmmaker and entrepreneur Jim Iyke say im latest movie na di "boldest action thriller to ever come out from dis side".
Iyke wey siddon wit BBC News Pidgin to tok about di new film - SIN - say, di film take three months to film for three different kontris and about 2,000 actors work for am on di set wit over 168 crew members.
"Nobody go fit tok now say we no fit do am, e no be great feem but na statement and nobody go fit challenge our worth and skill anymore".
Iyke tok, as e say e don make statement wit di film to showcase wetin Africa dey made of, to di world.