logo
#

Latest news with #corpmember

Anambra authorities, police condemn treatment of corps member wey security operatives strip naked inside viral video
Anambra authorities, police condemn treatment of corps member wey security operatives strip naked inside viral video

BBC News

time2 days ago

  • BBC News

Anambra authorities, police condemn treatment of corps member wey security operatives strip naked inside viral video

Di video of one young lady wey dem identify as corp members for Anambra state wey vigilante operatives bin assault tearing her clothes along wit odas don go viral. According to di video wey go viral, men wey wear mufti wit heavy guns bin enta into one compound beating a lady. Dem tear her clothes and drag her left and right till dem push her out. Wit di video wey dey go viral for social media, di security operatives wit dia guns bin join hand beat di young female corp member wit slaps, blows and di gril dey shout 'please' but dem no leave her. Di incident happun for Oba, Idemili South local govment area of Anambra State, and e don cause serious tok tok for social media. According to di police for Anambra state, na di Aguechemba vigilante group bin carry out di assault. Howeva, Anambra authority condemn di act sat na unfortunate incident wey no suppose happun. Anambra authority react to di corps members assault video Di special adviser to Governor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi don react to di trending video wia vigilante operatives bin assault di female corper and odas. E say di operatives bin dey carry out operation wen di incident happun but e dey veri sad say dat kain tin happun. "Wetin happun for dat incident dey veri unfortunate. We no rule out dis unfortunate incident wey happun, we get di report and di step we take be say we arrest di operatives wey dey involved for di act." "We detain dem, invite di victim wit di NYSC state coordinator. Den we say, our men wey go dat place, dia action dey unacceptable." Di special adviser to Anambra state govnor tok for di interview wit ChannelsTV say na men of di local security outfit Agunechemba bin carry out di operation. E say dem bin dey pursue some suspected cultist wey run inside di compound wey di mata happun. According to Emeakayi, Udo Ga-Achi na di operational code name wey di operatives dey take carry out di operation. E say di operation get di police, DSS, army, civil defence and all di security agencies for Anambra state but Agunechemba na di state security outfit wey be say na di law create of homeland security law create am. According to di community security adviser for Anambra state, na di law of di state empower di Agunechemba security outfit 'to enta any compound wey any questionable pesin run into wen dem dey pursue am.' E say di Agunechemba security outfit fit form squad for di purpose of tackling kidnapping, banditry, cultism, and any oda vices. For dis video wey dem naked di female corper and beat odas, e say di Agunechemba security outfit bin purse suspected cultist into di compound and dem begin search di building. E say na wetin carry di operatives go dat building be dat. "Di Agunechemba for Oba town bin dey chase group of cultist guys wey dey ride for motorcycle. During dat period, di suspected cultist run into one isolated area and into some houses." "Di operatives pursue dem into di compound, wia some pipo run into different houses and di operatives enta dia to bring dem out to screen and identify dem." Howeva, e condemn di action of di security operatives wia e tok say dat assault no suppose happun. Police react to assault of corp member Meanwhile, di Anambra State Police Command don condemn di sad incident wia vigilante bin naked di young female corpr member. "Di assault dey carried out by vigilante operatives. Following di incident, we don identify di suspects wey dey involved." According to di statement by di Anambra state police tok tok pesin, SP Tochukwu Ikenga, e say di reason why di case neva move forward since e happun na becos say di victim dey unavailable. E say dem don begin investigation into di case, and dem no go gree for any form of assault becos say na criminal offence under Nigerian law. "Any form remain criminal offence under di Nigerian Law and get di right to take necessary legal action to help di court proceedings while we dey wait for di victim." Police also cut warning give vigilante groups say make dem stop dey use brutality and abuse of authority during dia operation. We don reach out to di Anambra state NYSC make dem tok dia own side of di mata and wetin do di victim wey dem naked for di video. Also, we don reach out to di lawyer wey dey represent di young lady wey security operatives bin assault, to hear her own account.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store