Latest news with #goment


BBC News
6 days ago
- Politics
- BBC News
Nigeria goment withdraw charges against Ibom air passenger Comfort Bob, restore license of valueJet pilot
Nigeria goment don withdraw di cherges against Ibom Air passenger Comfort Bob. We dey update dis tori...


BBC News
30-07-2025
- Health
- BBC News
Why Nigerian nurses dey strike and how e fit affect medical care
Nurses and midwives for Nigeria don start industrial action [strike] across di kontri. Di National Association of Nigeria Nurses and Midwives [NANNM] announce say di warning strike go last for 7 days. Di strike go affect only federal goment hospitals and facilities. Di strike dey come afta di association give Nigeria goment 15 days ultimatum to address all di issues wey dey disturb dem. For letter wey di General Secretary of di association Dr. Shettima sign, di nurses association tok say dem dey give goment 15 days ultimate to meet dia demands. "Afta plenti tok-tok by di NEC-in session on di issues wey dey at stake, di house don resolve to give 15-day ultimatum to di Federal Ministry of Health so dat dem go address di demands wey we give dem." Di strike wey suppose start on Monday 14 July, 2025 don start on Wednesday 30 July, 2025. "If di goment fail to do di needful bifor di ultimatum expire, di association go start warning strike for 7 days," di nurses association bin tok. Why di nurses and midwives association dey para For di letter wey give goment notice about dia planned strike, di association say goment don neglect di needs wey di profession get for many years. Dem say even though di association bin dey veri "understanding wit goment and employers to ensure say dem work togeda well for di past four decades", dia employers for all levels don remove di respect wey di profession get. According to dem e don lead to "gross insensitiveness" to di legitimate demands of dia members and anytime dem wan go on strike dem dey tink about di needs of patients and clients. "And e dey make us to painfully avoid di only language [strike] wey goment dey understand." We go dey update dis tori