logo
#

Latest news with #highlife

Gentleman Mike Ejeagha wey sing 'Gwo gwo gwo ngwo' don die
Gentleman Mike Ejeagha wey sing 'Gwo gwo gwo ngwo' don die

BBC News

time3 days ago

  • Entertainment
  • BBC News

Gentleman Mike Ejeagha wey sing 'Gwo gwo gwo ngwo' don die

Nigeria highlife music legend, Mike Ejeagha, don die at di age of 95. Di ogbonge musician, wey dem sabi as 'Gentleman Mike Ejeagha,' bin popular for many years sake of im high-quality music wey im bin take tell different kain of . Im son, Emmanuel Ejeagha, tell BBC News say im papa die for 82 Division Hospital for Enugu, around 8:00 p.m. on Friday, June 6, 2025. Mike Ejeagha die afta one long sickness, wey im family bin no tok im name. Ejeagha blow for Nigeria music for di 1980s sake of how im music style take dey unique. For 2024, Nigerian skit maker Brain Jotter, bring di ogbonge highlife singer Ejeagha back into di limelight again wen e make popular one line, 'Gwo gwo gwo ngwo' from di singer song, "Ka Esi Le Onye Isi Oche," na song for Mike Ejeagha 1983 album. Di dance to di song go viral and bin make pipo remember di ogbonge singer. Celebrating di legend Pipo from different levels of society dey celebrate di late music legend for im unforgettable work, even as dem dey condole im family. Di Enugu State Govnor, Peter Mbah describe di late Ejeagha as "easy personality" wey im fans "cut across boundaries." Im talent show for how im take simple folktales and turn dem into songs wey you no go fit forget, and wey pipo from different cultures fit understand. Atiku Abubakar, former Nigeria Vice President post for social media X say: "E dey heartwarming to note say thanks to Brain Jotter, highlife maestro Mike Ejeagha bin get im 'Gwo gwo gwo ngwo' encore dance before di curtain drop down. Rest in music, Gentleman Mike Ejeagha."

How ogbonge Ghanaian musician Dada KD die a week bifor London show
How ogbonge Ghanaian musician Dada KD die a week bifor London show

BBC News

time17-05-2025

  • Entertainment
  • BBC News

How ogbonge Ghanaian musician Dada KD die a week bifor London show

Ghana entertainment industry dey mourn di death of one ogbonge highlife artiste, Dada Kwaku Duah wey pipo sabi well-well as Dada KD. Di cause of im death neva clear but im management wey announce im passing tok say na Friday, 16 May e die. Dada KD die ahead of one concert wey e suppose headline for London on 25 May. Di group wey dey organise di concert, DME Group Limited for statement also confam im death, and say dem go go ahead wit di event as na di best way to honour im legacy and to pay tribute to im extraordinary contributions to music. "Dada KD suppose perform for di highly anticipated Celebrating Hiplife and Highlife Legends in London" event on May 25, 2025, for Dominion Centre. While im absence dey deeply felt, we believe say di best way to honour im legacy na to continue wit di celebration, pay tribute to im extraordinary contributions to music. "For DME Group Ltd, we dey committed to ensuring say dis event go serve as a heartfelt homage to Dada KD. Im music, spirit, and impact go deybe woven into di fabric of di evening, as fellow artists and fans gada to celebrate im life and di rich musical heritage e champion," DME Ltd tok for statement. Videos wey begin trend on social media afta im passing show say e dey excited about di event and ready to attend. Dada KD bin dey do well bifor im death – Manager Di highlife legend manager, King Pee for one interview wit Ghana Weekend wey Citinews report tok say di singer bin suddenly fall sick on Friday. E say e become inactive and bin no dey respond, wey make im househelp hala for help and dem rush am go hospital. E say na for night, dem later announce say e don die. "Dada KD no sick. E just suddenly go quiet, and wen we rush am go hospital, e no make am," di local tori quote King Pee. For di interview, di manager also clear some rumours wey dey fly for social media on top di highlife icon death. Video of one interview wey di musician bin do bin dey spread wey make pipo dey tok say e dey broke and dey dey battle wit psychological issues. King Pee clear am say di video na since five years ago and e no get any relevance wit im recent life. "Dada KD no dey broke. E dey do very well. E suppose submit im UK visa application today for a show next Saturday. E no get issues wit anyone. Pipo just dey post things online for attention." Di manager tok. Tributes for Dada KD Fans and celebrities don enta social media to pay tribute to di singer. Many describe am as legendary figure for highlife music, wey im artistry and influence don leave permanent mark for di industry. Gospel musician Empress gifty for her Instagram share foto of di late musician wit tearful emojis Another gospel musician Broda Sammy write "rest in peace champion musician Dada KD" Entertainment show host Nana Romeo wey share excerpts of im interview wit di late star tok say di "man get problems, rest well champ." US-based Ghanaian comedienne Afia Schwarzenegger pay tribute to di fallen musician and encourage prayers and support for im family. Who be Dada KD? Dada Kwakye Duah aka Dada KD NA contemporary highlife musician wey dey known for im love songs. E start to dey sing wen e be seven years old. By di time e reach 15-years-old, e don already dey play musical instruments. Dada K.D. travel go abroad for 1998 wen e see say di music industry for im kontri no dey rewarding. E don since release nine albums, including di hit album, 'Somgye'. Other albums to include 'Ebeboawo', 'Obiara Se Eye', 'Ode twe boom / NY goes boom boom' and 'Mewura / Odom u anigyebi.' E don play wit bands like Relatives for Germany, Kojo Antwi Band, Tropical Vibes and Amakye Dede Band. Ghana residents for Britain bin give am Best Male Vocal Artist (Ghana Music Awards) for Britain for 2004. Dada K.D. bin base for Germany for many years, but e dey often return to Ghana to promote im music. For one recent interview wit Accra FM, di musician bin tok why e no fit go back, e say im get small debts to clear and im dey fear make dem no arrest am. E say im bin borrow money to pursue im musical career for Germany but no fit pay back. "I fit return to Germany any time, my only problem na di little debts to my name, in dat case, if you get there you go dey arrested," e tell di host of di programme Nana Romeo. For some previous interviews, di musician tok say im dey frustrated about payment of royalties for di music industry, e also tok about emotional and psychological stresses. Reports wey BBC Pidin neva fit verity tok say on at least two occasions, e bin mention say im dey reason death, and im go soon join pipo wey don die for di entertainment industry.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store