15-07-2025
As E Dey Happen, Body of Late Mahammadu Buhari arrive Katsina airport
Life and times of former Nigerian leader Muhammadu Buhari
55 minutes wey don pass Life and times of former Nigerian leader Muhammadu Buhari
Wia dis foto come from, Muhammadu Buhari
Nigeria President Muhammadu Buhari, wey die at di age 82 na one former military ruler and self-styled converted democrat wey return to power through elections but struggle to convince Nigerians say e fit deliver on di change e promise.
E no be natural politician, pipo see am as pesin wey dey difficult and pesin wey no send anybody.
But e get reputation for personal honesty – one rare character of a politician for Nigeria.
Afta three failed attempts, Buhari bin achieve ogbonge historic victory for 2015, as e become di kontri first opposition candidate to defeat incumbent. For 2019, e dey re-elected for anoda four-year term.
Buhari always dey popular among di poor pipo wey dey north (wey dey known as di "talakawa" for Hausa language) but for di 2015 campaign, e bin get di advantage of one united opposition wey tanda strong for im side.