logo
#

Latest news with #mosquefire

Court sentence man wey burn mosque for Kano to death by hanging but e go first chop 150 strokes of cane
Court sentence man wey burn mosque for Kano to death by hanging but e go first chop 150 strokes of cane

BBC News

time26-05-2025

  • BBC News

Court sentence man wey burn mosque for Kano to death by hanging but e go first chop 150 strokes of cane

One Shari'a Court wey siddon for Kano, on Monday, don sentence one 38-year-old, Shafi'u Abubakar, to death by hanging and 150 strokes of cane for setting one mosque on fire and killing pipo. Di court charge Abubakar wit culpable homicide, attempted murder, causing grievous hurt and mischief by fire. As di judge dey give judgment, Malam Halhalatu Khuza'i-Zakariyya tok say out of di seven witnesses wey di prosecution bring, na only di testimonies of two witnesses prove di case well-well. Di judge sentence di defendant to death by hanging for murder and 100 strokes of cane for attempted murder. E still order di defendant make e pay fine of N1,500 for causing grievous hurt and 50 strokes of cane for mischief by fire. Khuza'i-Zakariyya still order say make di state goment collect di defendant tricycle and sell am to repair di mosque e burn. Di Director of Public Prosecution for Kano State Ministry of Justice, Salisu Tahir, tok say di defendant commit di offence for Gadan Larabar Abasawa Village, Gezawa Local Goment, Kano, on May 15, 2024. Di defendant, however, bin plead guilty to all di charge dem dey accuse am. As e respond, di Defence Counsel, Hasiya Muhammad-Imam, beg for mercy on behalf of Abubakar, and beg di court make dem transfer am go Maximum Security Custodial Centre Janguza for Kano. You go recall say di incident happun on May 15, 2024 wen the worshippers dey do early morning prayers. About 11 pipo die immediately while 12 odas die later for Murtala Muhammed Specialist Hospital, Kano. Wetin happun bifor Dis incident happun for May 15, 2024 wen di worshippers dey do early morning prayers for for Gadan Larabar Abasawa Village, Gezawa Local Goment, Kano. Na bout 11 pipo die immediately while 12 odas die later for Murtala Muhammed Specialist Hospital, Kano. Imam wey dey lead di early morning prayer and three odas na im die afta di attack on di mosque. Di man wey im identity no dey known dat time bin set fire on di mosque for Laraba Abasawa wey dey for Gezawa Local goment area. Di incident wey happun early on Wednesday make pipo begin run upandan for di area to find how to save and rescue pipo wey dey trap inside di mosque. One pesin from di community bin tell BBC News Pidgin say di man allegedly pour petrol and set fire for di mosque wen about 40 pipo dey pray - e den lock di mosque. Di chief medical director, Murtala Muhammad Specialist Hospital, Dr Hussaini Muhammad, wey bin attend to di patients, tok say 24 pipo na im dem carry come di hospital. E add say, one of dem bin don die bifor dem reach di hospital. "My broda die instantly afta we carry am come hospital". Brother of di deceased worshipper, Muttaka Halliru, tok. Haliru add say "At di time wen di fire happun, I dey house dey prepare to go for Sub'h prayer, den I hear Sulaiman dey shout fire for mosque." "Di remaining 22 pipo, get serious injury, sake of say plenty of dem get burn from head reach toe, while di oda one get burn for im back and hand," e tok. However, Kano Police tok say dem don arrest one man wey dem believe say na im set di mosque on fire during di early morning Sub'h prayer. Dem tok dis one for one statement wey Police tok-tok pesin SP Abdullahi Haruna Kiyawa release for im social media. Di suspect wey be 38 years, claim say im action na sake of wahala wey e dey get wit im family members sake of inheritance. E tell police pipo say im family dem no share di inheritance well, and those wey e believe say cheat am be di pipo wey dey for mosque wen e bin torch am, di statement tok. SP Abdullahi Haruna Kiyawa tok say dem dey hold di suspect for police station as dem kontinu to investigate di matter.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store