logo
Court sentence man wey burn mosque for Kano to death by hanging but e go first chop 150 strokes of cane

Court sentence man wey burn mosque for Kano to death by hanging but e go first chop 150 strokes of cane

BBC News26-05-2025

One Shari'a Court wey siddon for Kano, on Monday, don sentence one 38-year-old, Shafi'u Abubakar, to death by hanging and 150 strokes of cane for setting one mosque on fire and killing pipo.
Di court charge Abubakar wit culpable homicide, attempted murder, causing grievous hurt and mischief by fire.
As di judge dey give judgment, Malam Halhalatu Khuza'i-Zakariyya tok say out of di seven witnesses wey di prosecution bring, na only di testimonies of two witnesses prove di case well-well.
Di judge sentence di defendant to death by hanging for murder and 100 strokes of cane for attempted murder.
E still order di defendant make e pay fine of N1,500 for causing grievous hurt and 50 strokes of cane for mischief by fire.
Khuza'i-Zakariyya still order say make di state goment collect di defendant tricycle and sell am to repair di mosque e burn.
Di Director of Public Prosecution for Kano State Ministry of Justice, Salisu Tahir, tok say di defendant commit di offence for Gadan Larabar Abasawa Village, Gezawa Local Goment, Kano, on May 15, 2024.
Di defendant, however, bin plead guilty to all di charge dem dey accuse am.
As e respond, di Defence Counsel, Hasiya Muhammad-Imam, beg for mercy on behalf of Abubakar, and beg di court make dem transfer am go Maximum Security Custodial Centre Janguza for Kano.
You go recall say di incident happun on May 15, 2024 wen the worshippers dey do early morning prayers.
About 11 pipo die immediately while 12 odas die later for Murtala Muhammed Specialist Hospital, Kano.
Wetin happun bifor
Dis incident happun for May 15, 2024 wen di worshippers dey do early morning prayers for for Gadan Larabar Abasawa Village, Gezawa Local Goment, Kano.
Na bout 11 pipo die immediately while 12 odas die later for Murtala Muhammed Specialist Hospital, Kano.
Imam wey dey lead di early morning prayer and three odas na im die afta di attack on di mosque.
Di man wey im identity no dey known dat time bin set fire on di mosque for Laraba Abasawa wey dey for Gezawa Local goment area.
Di incident wey happun early on Wednesday make pipo begin run upandan for di area to find how to save and rescue pipo wey dey trap inside di mosque.
One pesin from di community bin tell BBC News Pidgin say di man allegedly pour petrol and set fire for di mosque wen about 40 pipo dey pray - e den lock di mosque.
Di chief medical director, Murtala Muhammad Specialist Hospital, Dr Hussaini Muhammad, wey bin attend to di patients, tok say 24 pipo na im dem carry come di hospital.
E add say, one of dem bin don die bifor dem reach di hospital.
"My broda die instantly afta we carry am come hospital". Brother of di deceased worshipper, Muttaka Halliru, tok.
Haliru add say "At di time wen di fire happun, I dey house dey prepare to go for Sub'h prayer, den I hear Sulaiman dey shout fire for mosque."
"Di remaining 22 pipo, get serious injury, sake of say plenty of dem get burn from head reach toe, while di oda one get burn for im back and hand," e tok.
However, Kano Police tok say dem don arrest one man wey dem believe say na im set di mosque on fire during di early morning Sub'h prayer.
Dem tok dis one for one statement wey Police tok-tok pesin SP Abdullahi Haruna Kiyawa release for im social media.
Di suspect wey be 38 years, claim say im action na sake of wahala wey e dey get wit im family members sake of inheritance.
E tell police pipo say im family dem no share di inheritance well, and those wey e believe say cheat am be di pipo wey dey for mosque wen e bin torch am, di statement tok.
SP Abdullahi Haruna Kiyawa tok say dem dey hold di suspect for police station as dem kontinu to investigate di matter.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'
Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'

BBC News

time7 hours ago

  • BBC News

Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'

Di number of pipo wey don die from di attacks on Gwer West and Apa Local Goment Areas of Benue State don rise to ova 50 local authorities tok. Suspected herdsmen attack residents of Tse-Antswam for Naka town, wey be headquarters of Gwer West LGA and Edikwu Ankpali for Apa local goment area of Benue state. Tori be say many pipo die, as oda pipo run to save dia lives. According to di Chairman of Gwer West Council Mr. Victor Ormin and di traditional council, Chief Daniel Abomtse bin confam say dem bin recover 21 deadibody on Sunday. Chief Abomtse di Ter Nagi, tok say di attackers bin come in guerrilla style wen dem attack Tse Antswam. Im add say many pipo get different degree of injuries. "In fact, di way dem butcher some of di pipo I doubt if dem go survive, we still dey search becos many pipo bin run inside bush wit gun wounds and some also enta inside well to escape di herdsmen," di monarch tok. According to Chief Abomtse, di community wey dis attack happun dey directly opposite di military check point along Naka/ Makurdi road. Edikwu record 37 deaths Meanwhile for Edikwu Ankpali for Apa Local Goment Area, di causality figure hit na 37. Di Chairman of Apa Local Goment Area, Adam Ogwola, wey confam di tori say dem still dey expect di number of death victims to increase as dem still dey search and dem dey see more deadbody. "Di attack dey devastating" "Di pipo wey wound dey for general hospital already and dey get medical attention". One community leader, John Ikwu also confam say dem bin see 25 deadbody on Sunday for Edikwu Ankpali. Di community leader say time don reach wey dem go begin confront di jaguda pipo as im describe di killing as barbaric and unwarranted. Im say na heartless killers dey attack dia communities evriday without control. For statement wey di Benue State Police Command release on Monday, through dia tok-tok pesin Udeme Edet, dem say di Commissioner of Police, Emenari Ifeanyi don relocate di Area Commander to Apa. Im also direct di tactical team to take over Naka as im deploy resources to flash points for di state including Apa and Gwer-west Local Goment Areas. For police statement, dem tok say na ten and twelve pipo die for di two attacks and five odas bin dey hospital. "For di last one month, personnel wey we post to dis areas don dey fight wit dis attackers and dem don suppress dem for most areas. Unfortunately, dis bandits dey search for vulnerable pesins and attack dem, dem kill some pipo on 1st June, 2025." Di CP dem redeploy personnel to cover up entries and exits to flash points. In di last two weeks, tori about different type of death don full for social media and news channels. Benue state na one of di flash points wey suspected herders dey attack communities and kill pipo. For April, di number of death for Benue herdsmen attack on Logo and Gbagir rise to 56. Even though di govnor bin don condemn dis attacks many times, e still dey happun.

Nigeria's defence chief proposes fencing borders to curb insecurity
Nigeria's defence chief proposes fencing borders to curb insecurity

Reuters

time8 hours ago

  • Reuters

Nigeria's defence chief proposes fencing borders to curb insecurity

ABUJA, June 3 (Reuters) - Nigeria's defence chief on Tuesday called for the country's borders with its four neighbours to be completely fenced to curb the entrance of armed groups amid escalating insecurity. Nigeria's military has been strained by widespread security issues, particularly a 16-year insurgency in the northeast led by Islamist militant group Boko Haram and its offshoot Islamic State West Africa Province. Security forces and civilians have been attacked and killed and tens of thousands of people have been displaced. Defence Chief of Staff, General Christopher Musa, who spoke at a security conference in the capital Abuja, said "border management is very critical," citing Pakistan's 1,350 km (839 miles) fence with Afghanistan and Saudi Arabia's 1,400 km barrier with Iraq as successful precedents. This is the first time a top Nigerian official has publicly suggested such a measure. "Other countries, because of the level of insecurity they have, had to fence their borders," he said. Nigeria borders Niger Republic, Cameroon, Benin, and Chad, which are all grappling with escalating militant campaigns across the Sahel. Nigerian authorities often attribute its prolonged insurgency, including recent attacks on military stations, to foreign fighter infiltration. Nigeria's longest border (1,975 km) is with Cameroon in the northeast, a Boko Haram hotspot. It also shares 1,500 km with Niger and 85 km with Chad, nations that have lost territory to armed groups. Musa warned Nigeria's perceived wealth makes it a target. "It is Nigeria that everybody is interested in. That is why we need to secure fully and take control of our borders," he said. "It is critical for our survival and sovereignty."

Britons accused of smuggling cocaine in Angel Delight sachets could face death penalty
Britons accused of smuggling cocaine in Angel Delight sachets could face death penalty

Sky News

time8 hours ago

  • Sky News

Britons accused of smuggling cocaine in Angel Delight sachets could face death penalty

Three Britons could face the death penalty in Bali after appearing in court charged with smuggling nearly a kilogram of cocaine into Indonesia. Jonathan Christopher Collyer and Lisa Ellen Stocker were arrested on 1 February after customs officers stopped them at an X-ray machine after finding suspicious items in their luggage, prosecutors claimed. A lab test result confirmed that 10 sachets of Angel Delight powdered dessert mix in Collyer's luggage and seven similar sachets in his partner's suitcase contained 993.56g, or over 2lbs, of cocaine, worth an estimated 6bn rupiah (£272,000), prosecutor I Made Dipa Umbara told the District Court in the regional capital Denpasar. Phineas Ambrose Float, 31, was arrested two days later after police set up a controlled delivery in which the other two suspects allegedly handed him the drug in the parking area of a hotel in Denpasar. He is being tried separately. The drugs were brought from England to Indonesia via Qatar, Mr Umbara said. The group had successfully brought cocaine into the country twice before, Ponco Indriyo, the deputy director of the Bali Police Narcotics Unit, told reporters in February. The trial was adjourned until next week, when the three-judge panel will hear witness evidence. About 530 people, including 96 foreigners, are on death row in Indonesia, mostly for drug-related crimes, according to figures from the country's ministry of immigration and corrections. One of them, Briton Lindsay Sandiford, now 69, has been on death row for more than a decade after 3.8kg of cocaine was found in her luggage in 2012. Despite its strict laws, Indonesia is a major drug-smuggling hub, the UN has said, partly because international syndicates target its young population. Just last week, Thomas Parker, from Cumbria, was sentenced to 10 months in jail in Bali for drug offences after a charge that could carry the death penalty was dropped. He was accused of collecting a package containing MDMA from a motorcycle taxi driver on a nearby street. During the police inquiries, the 32-year-old electrician was able to prove he did not order the package but that it was sent by a drug dealer friend, identified only as Nicky, whom Parker had known for about two years and with whom he communicated via the Telegram messaging app. Police reduced the initial charge of drug trafficking, which potentially carries the death sentence, to the less serious offence of hiding information from authorities. An Australian man, Lamar Aaron Ahchee, 43, from Cairns in north Queensland, was arrested on 22 May after police allegedly seized 1.7kg (3.7lbs) of cocaine during a raid on his rented home in Kuta Beach. A police chief said anti-drug surveillance teams reported Ahchee had received two suspicious packages sent by mail to Denpasar from England. He too could face the death penalty.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store