logo
#

Latest news with #nigerian

Wetin dey inside Davido '5ive' album
Wetin dey inside Davido '5ive' album

BBC News

time18-04-2025

  • Entertainment
  • BBC News

Wetin dey inside Davido '5ive' album

Grammy award nominee and popular afrobeats star David Adeleke wey pipo sabi as Davido dey make headlines sake of im new album. For im bio on im official X page Davide write "5ive out now" Nigerian multi awards winner release im fifth studio album wey im title '5ive' Tori be say di album na to give im fans small of wetin go dey inside di main album wen im finally release am. Davido bin don drop some singles wey dey inside di album wia im do collabo wit some ogbonge nigerian artistes like Chike, Odumodublvck and YG Marley. Im also feature artistes like Chris Brown, Victony, Omah Lay inside di album. Di album '5ive' dey come two years afta im last studio album 'Timeless', wey bin reach number one for Billboard World Albums Chart. Wetin dey inside dis album For inside dis album wey get 17 tracks Davido bin tok say im put all im heart for di songs wey dey inside di album. Na for December, 2025 im bin tok about di energy wey dey inside di album. "Di journey continue for 2025 wit my new album, 5IVE!! Dis one na straight from di heart - my story, my truth, my growth." Na for inside dis post im bin also annound say im dey release di single wey im title "Funds" wia im do collabo wit Odumodublvck and Chike. Davido bin add say di album na for go getters and pipo wey dey ride wit am. "Dis one na for dreamers, di go getters and everyone wey dey pursue wetin be dia own!.im write. How fans react to dis new album Davido fans react to dis album since e first announce am for December, 2024. For some of di fans, dem believe say di album na di best wey Davido drop while odas still take time to tok about di about di are work wey dey on top di cover say e make sense gan but weda di music also make sense, na music lovers go determine. Davido na one of Nigeria best music exports to di world. E don perform for big stages wey include di 2022 Fifa World Cup closing ceremony for Qatar.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store