Latest news with #vaccinehub


BBC News
2 days ago
- Business
- BBC News
Wetin hapun as India Prime Minister Narendra Modi make historic visit to Ghana
Indian Prime Minister Narendra Modi say im kontri dey try to deepen ties wit Africa and ensure shared growth and prosperity, as im start a tour of five kontris. Di PM wen im visit Ghana, sign plenty agreements wit di kontri President John Dramani Mahama wia dey aim to make trade and business better. Im describe India-Ghana relationship say "e don sweet pass sugarloaf pineapple." President Mahama bin announce during one press conference say dem bin sign healthcare agreement to "promote traditional medicinal education, training and research." Im also tok say dem sign oda agreement to promote cultural exchange wit anoda one to "enhance quality of di trade between di two kontris." Di one wey pipo sabi say na ogbonge agreement na di one wey India go support Ghana to build vaccine manufacturing and production hub. President Mahama tok say "dis agreement wey we don sign go help our dreams and push our aspirations for cooperation across di economy like agriculture, energy, manufacturing, infrastructure development and security." Ghana and India bin get relationship since Ghana im first President Dr Kwame Nkrumah bin take inspiration from Mahatma Gandhi wen im form non-violent movement wey fight for independence for India from di British for 1947. Ghana also bin gain her independence ten years afta India for 1957. Since den, both countries don dey make dia relationship strong; na so dem get vibrant Indian community of more dan 15,000 pipo for Ghana. Out of dis number, 3,000 dey hold Ghana nationality. Plenty businesses wey India pipo dey run for Ghana dey employ many young pipo, na so goment say make more companies enta di kontri to do business. PM Modi for one address for di Ghana parliament tok say "India go waka shoulder to shoulder wit Ghana as committed partner for dis journey." India bin dey support Ghana since - for 2008, dem bin give Ghana moni through di exim bank to build di presidential candidate palace at di time Ghana bin dey celebrate 50 years of independence. Dis $135m project now be di kontris seat of goment. For 2021, Ghana na one of 150 kontris wey India bin support wit AstraZeneca vaccines during di Covid 19 pandemic. For November last year, Ghana goment bin commission one 97.7km Tema-Mpakadan railway line wia dem construct wit $447m India export-import bank credit facility. Prime Minister Modi explain say dis projects don dey show India im commitment to Africa. "We don dey spread our diplomatic presence to 46 countries across Africa wia we don support ova 200 projects for di continent to boost connectivity and industry." Im add say India go support Africa development framework agenda 2063 to make sure say di continent get bright future. "Di goals of Africa na our priority, we dey hope to grow togeda as equal." Indian dey try to soon become di third largest economy for di world, according to di PM. "India na tech and innovation hub, wia pipo don recognise us as di pharmacy of di world, wia we also bin get women wey dey do ogbonge tins for science, aviation and sports." "Di pipo of India don tok say dem go make di kontri become developed kontri by 2047, di time wia we go celebrate 100 years of independence." PM Modi go continue im 5-nation tour to Namibia, Trinidad & Tobago, Argentina and Brazil wia im go attend di Brics summit between 5-8 July. Ghana President John Mahama carry di country ogbonge award take celebrate di India PM. Dis na 'di officer of di order of di star of Ghana', one award wey dey recognise pesin wey don do many many tins to contribute to di country or di world. During im two-day visit for Ghana, PM Modi bin visit di tomb of Ghana first President Dr Kwame Nkrumah, wia im lay wreath for im graveside.


The Independent
3 days ago
- Business
- The Independent
What AstraZeneca could cost London's stock market if it moves to US
AstraZeneca 's CEO, Pascal Soriot, has reportedly held private discussions about moving the pharmaceutical firm's stock market listing from London to the US. The potential move is primarily driven by the CEO's long-standing frustrations with UK regulations, including restrictions on new medicines and pricing structures. Such a shift would represent a significant blow to the London Stock Exchange, as AstraZeneca is currently its largest listed company with a market capitalisation exceeding £161bn. The US is AstraZeneca's largest revenue source, contributing $21.8bn (£15.3bn) of its $54bn (£39bn) total revenue in 2024, highlighting the market's importance to its growth strategy. The company previously abandoned plans for a £450m vaccine hub near Liverpool, citing 'timing' and a funding gap, amid ongoing discussions with the UK government regarding pharmaceutical industry support.


Bloomberg
4 days ago
- Health
- Bloomberg
Ghana to Seek India's Backing for Vaccine Hub as Modi Visits
Ghana plans to ask India for support to develop a vaccine hub when Prime Minister Narendra Modi visits the West African nation this week. The two countries are expected to hold talks and sign agreements covering agriculture, defense and a vaccine hub, Foreign Affairs Minister Samuel Okudzeto Ablakwa told reporters in the capital, Accra. The African nation, which aims to become self-sufficient in inoculations by 2030 and a hub for vaccine production will seek to capitalize on the South Asian country's vast experience in pharmaceuticals, he said.