Latest news with #veincondition


Daily Mail
3 days ago
- Health
- Daily Mail
EXCLUSIVE Doctors reveal why Trump's vein condition may deteriorate faster than White House says
President Donald Trump has been diagnosed with a vein condition that explains recent photos showing his ankles looking unusually swollen. The President has chronic venous insufficiency (CVI), where veins in the legs struggle to send blood back to the heart, causing it to pool.


BBC News
4 days ago
- Health
- BBC News
Trump dey diagnosed wit vein condition
Donald Trump dey suffer from one chronic vein condition, di White House announce on Thursday, 17 July. Dis dey come days afta rumours spread afta fotos show bruises for di US president hand. Recently, e bin experience swelling for im hands, and Oga Trump undergo one "comprehensive exam" wey include vascular testing, according to White House Press Secretary Karoline Leavitt. Leavitt say di president bruised hand na normal tin sake of "tissue damage from regular handshaking" plus di aspirin e dey take, wey she say dey "part of standard cardio-vascular prevention regimen". 79-year-old Trump, regularly dey boast of im good health. E once describe imself as "di healthiest president wey ever live". Di name of di President recently discovered vein condition na chronic venous insufficiency. E dey occur wen di vein for di leg fail to pump blood to di heart, dis dey cause am to pool for di lower limbs, wey fit make di leg swell. Veins and valves dey "push di blood up and out of di leg" and back toward di heart, Dr Meryl Logan, assistant professor of vascular surgery for di University of Texas for Austin tell BBC. Di blood wey dey flow from di legs to di heart dey move against gravity, wey fit make dat process dey more difficult. "So wetin chronic venous insufficiency be, na wen those veins and valves stop to dey work and blood dey go back of di legs," she tok. Oldest US president ever inaugurated Leavitt tok say "no evidence dey of deep vein thrombosis or arterial disease" plus all di results from di test bin dey "within normal limits". According to one note from White House physician Sean Barbabella wey e release to reporters, di condition na "benign and common", especially for pipo ova age 70. Additional testing no show " signs of heart failure, renal impairment, or systemic illness" in Trump, Barbabella for di note, wey confam di information from Leavitt earlier briefing. Overall, Trump dey in "excellent health", di doctor write. Photographers capture wetin be like Trump swollen legs during di Fifa Club World Cup final for New Jersey on 13 July, plus subsequent photos dem take earlier dis week wey show im bruised hands during one meeting wit Bahraini Prime Minister, Salman bin Hamad bin Isa Al Khalifa for di White House. Foto bin don previously show one bruise on di president hand during one meeting wit French President Emmanuel Macron for February. Im swollen legs and bruising bin lead to online speculation and rumours say di president fit dey suffer from one sickness wey e neva make public. Afta one annual physical exam for April, Barbabella bin write say Trump "show cognitive and physical health". Trump dey 78 years and seven months old wen e dey sworn in for im second term for January, wey make am di oldest president dem go ever inaugurate as US leader. Wetin to know about chronic venous insufficiency Doctors tell BBC say dem agree wit Barbabella assessment on top di seriousness of di chronic venous insufficiency. "E fit dey associated wit serious conditions, but in and of itself, no be serious condition, and e dey very common," Dr Matthew Edwards, chair of di Department of Vascular Surgery at Wake Forest University, tell BBC. "Pipo for im age (group), I go say probably somewhere between 10 and 35% of pipo go get am." Experts say oda risks include being overweight, pesin wey get history of blood clots, and get jobs wey require patients to tanda on dia feet for long durations. Wearing custom-made medical-grade compression stockings fit help manage di condition, and experts also recommend say make patients dey carry dia legs up for night. "I tell my patients to rub good creamy lotion all ova dia legs and feet every day, and then controlling oda potential risk factors like obesity," Dr Logan tok. Di president bruised hand Chronic venous insufficiency dey only affect di lower part of di body, so di condition no relate to di bruising wey dey di president hand, wey bin generate tok-tok recently. Di president doctor say di bruising na sake of handshaking and di side effect of di aspirin wey e dey take, one melecine wey fit help prevent heart attacks, blood clots, and strokes. Dr Edwards tok say im agree wit White House doctor explanation say Trump aspirin intake plus im age fit dey responsible for di bruising. "We are all more prone to bruising as we get older, and you go see plenty pipo wey dey take aspirin plus oda blood-thinning agents." "I dey sure say if pesin squeeze your hand hard enough, (you fit get bruise)," Dr Edwards tok. "Dat go be very stiff handshake."