20-05-2025
'Who I offend, wetin I do?' - Papa of student wey police allegedly kill for Ibadan tok how e happun
Viral videos and fotos of a young boy wey police officer allegedly shoot for Ibadan, Oyo State southwest Nigeria don spark serious anger online and gbege within di region.
Tori be say on Tuesday 20 May, 2025, police officer for Ibadan, Oyo state bin open fire while dem dey chase a particular around a popular market for di city.
Sadly, di bullet bin hit a young student wey dey inside im papa car as e dey on di way to school.
Di incident happun early morning, wen di young boy dey on im school uniform wit im twin broda.
According to reports wey we still dey try independently confam, di boy bin die from di gunshot wey hit am.
Some eyewitness say dem sharply carry di boy go hospital but dem declare am dead on arrival.
We dey update dis tori