logo
Corp member wey call Tinubu 'terrible president' break any law? - Wetin NYSC Bye-Law tok

Corp member wey call Tinubu 'terrible president' break any law? - Wetin NYSC Bye-Law tok

BBC News17-03-2025
Di question on weda corps members fit come out to tok dia mind on di situation of di kontri or not na im dominate tok-tok for Nigeria social media space ova di weekend.
Di mata turn hot debate afta one corps member wey dey serve for Lagos state, Nigeria biggest commercial city, for one video wey don go viral now, lament di high cost of living for di kontri, plus di economic challenge di kontri dey face.
Di corper also for di video condemn President Bola Tinubu administration, as she call di presido "terrible leader".
She also add say Lagos na "smelling state", wey don generate plenty gbasgbos on social media.
Dis her tok don provoke plenty reactions for di kontri as some Nigerians dey of di position say she no get right as corper to openly kick against di goment according to di National Youth Service Corp (NYSC) handbook. Odas dey of di opinion say she get di right to express her grievance as she be Nigerian and she get di right to exercise di freedom of speech as e dey for di Nigeria constitution.
Some pipo also argue say she be employee of di Nigerian goment, therefore, she no get right to chook mouth for wetin dey happun for di kontri. Odas argue say NYSC na para-military, and so, na no go area.
Although di National Youth Service Corps (NYSC) neva comment on di mata, di corper allege say some NYSC officials don call to threaten her sake of wetin she tok.
Wetin di corper tok wey lead to gbasgbos for di kontri
For di video post wey don go viral for social media now, di corps member lament di economic condition of di kontri.
She say prices of food dey go up every week and question wetin goment dey do to reduce di high cost of living. She describe President Tinubu as a "terrible president" sake of di worsening economic palava.
"I just wan tok say our president, I no know if any oda president dey wey terrible pass you. But you be terrible president."
Afta dat video go viral, di corper post anoda video on her TikTok account wia she allege say one NYSC official call and threaten her to delete di video. But she insist say na di truth about di kontri situation she tok.
Di corper post say, "Dear Nigerians, NYSC board don dey threaten me say make I stop to dey tok on dis issue. In less dan 24 hours, goment don already dey threaten me, starting wit di NYSC board!
"Why I no fit speak up? Becos I be NYSC corper no mean say I no get right to complain.
"Why goment no wan listen to di criticisms of dia citizens? Dem believe say dem get chain on me, wey be NYSC, and dem dey use am to hold me. #officialasiwajubat I no do anything wrong. I criticise your goment, and I demand say make dem hear us."
Wetin NYSC law and di Nigerian constitution tok about di mata?
No specific section for di NYSC Bye-Laws outrightly ban corps members from calling out di goment. However, one clause dey, wey indirectly regulate how corps members fit express themselves publicly.
According to Section 3 (i) of di NYSC Bye-Laws Code of Conduct (2011),
"Any member wey address di press on any policy issue without di written consent of di State Coordinator go dey tried by di Camp Court and, if found guilty, e go dey liable to extension of service for thirty (30) days on half pay."
Dis one mean say if any corps member wan make public statement, especially di one wey go criticise goment policies, technically, dem suppose get clearance from NYSC officials first.
Dis na one of di unclear rules wey NYSC officials dey often use to silence corps members wen dem speak out.
However, wetin di bye law possibly dey refer to na official press engagements, wia di corper go follow tori pipo tok, no be di one dem go post on dia personal social media account.
One Human Rights Lawyer, Inibehe Effiong wey chook mouth for dis mata clear am say no provision dey for di NYSC Act wey subject corps members to civil service Rules. "Criticizing di President or di goment no be offence under di NYSC Act (See Section 13). E also no be offence under di NYSC Bye Laws (Section 4 of di Revised Bye Laws, 2011).
Oga Effiong say im don watch all di videos of di lady wey pipo dey debate on top and im no see anytin slightly partisan for her comments.
E say she only express her justified frustrations wit di situation for di kontri, particularly di impact of di inflation on her and oda Nigerians, wey dey within her constitutional right to freedom of expression as guaranteed by Section 39 of di Constitution of the Federal Republic of Nigeria, 1999 (as amended).
Di lawyer also clear am say corps members no be civil servants or public servants. Section 2 of di NYSC Act tok say every eligible Nigerian go dey called-up to serve for a continuous period of one-year national service. Na National Service, no be federal or civil service. Di NYSC na agency of di Federal Government, but corps members no be employees of di federal government or staff of di NYSC.
Also, di Certificate wey corps members dey get afta dem complete dia National Service as prescribed in Section 11 of di NYSC Act na Certificate of National Service, no be certificate of employment. Federal or state goments no dey issue employment letters give corps members.
Amnesty international, odas react
Amnesty International, one ogbonge human rights group for one post on X, tok say di corp member dey perfectly within her right to express her discontent peacefully.
Di rights groups say make authorities prioritize addressing di kontri economic woes instead of her life wey dem dey threaten.
"Make di Nigerian authorities stop to dey respond wit violence and threats to individuals and groups wey express dissenting opinions — in utter disregard for Nigerian constitution and international law. Holding and voicing different views no be crime."
President of di Trade Union Congress (TUC) Festus Osifo, for im reaction tok say di corp member bin tok out of frustration and advise di goment say make dem no go afta her but dey "tolerant of critics."
Oga Osifo wey react on di trending mata on one television programme say goment need to understand say pipo dey para.
"Di goment need to understand say pipo dey frustrated, pipo dey hungry, pipo don tire. So, if dem decide to para, I strongly believe say goment no suppose personalise am and come afta such individuals.
Imagine a young lady wey dey carry out her NYSC function, wetin she really fit do to bring down di goment? Na her personal frustration she air."
One former Nigeria Vice President Atiku Abubakar post say, "I deeply admire her boldness and wisdom—her fearless resolve to speak truth to power, undeterred by di weight of opposition."
E say instead of di hostility wey she don receive, she deserve encouragement and support.
E also be like say human rights activist and presidential candidate for di 2023 general election, Omoyele Sowore, dey rally support for Ms Uguamaye, as e post on X say im go follow her go her NYSC Local Government Inspector office alongside a team of lawyers in case.
Sowore tok say wen dem reach di LGI, no official turn up throughout dia stay.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Candidates react afta WAEC reopen portal for WASCCE 2025 results
Candidates react afta WAEC reopen portal for WASCCE 2025 results

BBC News

time5 days ago

  • BBC News

Candidates react afta WAEC reopen portal for WASCCE 2025 results

Di West African Examinations Council (WAEC) don announce say di results portal for di 2025 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) results wey dem withdraw sake of technical glitch don dey open again. According to WAEC candidates fit recheck dia results to see wetin dem get. Di exam body bin announce say dem dey investigate technical issues inside di recently released 2025 WASSCE results. So dem bin temporarily deny access for candidates to check di 2025 result for dia portal. However, WAEC don tok sorry for dia action and beg Nigerians for di mistake wey dem do for di results mata. "Di result portal don dey open again, candidates fit access am now, check and recheck dia results for di WASSCE (SC), 2025." "Once again, we truly dey sorry for di wahala and appreciate your understanding and support," WAEC tok for dia post for Friday night on X. Wetin don change? Afta di announcement of WAEC say dem don reopen di result portal, candidates don begin dey login to check wetin don change for dia results. Some of di candidates say dia results still dey show dia former grade score, while some say dia own result score don change, afta WAEC do di review. One candidate post wit screenshot say e own result dashboard dey show 'error' message. For di screenshot wey e post, di 'error' message say "results no dey available for dis candidate for di specified year and exams diet". Anoda candidate wey reply to WAEC post for X, say im own 'error' message dey show say e don use im result checker card pass di normal time. E post im error message wey read, "di card usage don pass di maximum wey dey allowed. Abeg buy anoda card". Several oda candidates also comment say dia result checker card dey show say dem don reach limit wen be say na only one time dem don use am. Meanwhile, some oda candidates wey chook mouth inside di result review mata say some of dia results don change. One candidate lament say her English Language result neva change wia she add say na dat result dey hold her back from admission. She say she no fit go for admission screening sake of di 'D7' wey she get for her English Language, and upon dat, her card don expire join. "Noting don dey rectified, my English still dey D7, my card don expire too. Please dem don invite me for screening to study nursing now my English na di only tin wey dey hold me back. I no fit go for di screening wit dis D7," she write for X. While dis problem no be one sided issue, WAEC expect make dia candidate dey 'check and recheck' dia result portal to see di review wey dem do ontop di results. Also, some Nigerians don sama knock give WAEC say dat kain issue no suppose hapun as dem get enough time to work on di results. Why WAEC review 2025 WASSCE results Di national examination body for one statement on dia X account tok say during one internal review, one internal post result release procedure reveal some technical bugs for di results. Waec bin say sake of di review, dem don decide to urgently review and correct di technical glitches wey lead to di situation, as a result, access to di WASSCE (SC) 2025 results don dey temporarily denied on di result checker portal. Dem say make pipo wey don check dia result before, make dem go back afta 24 hours to re-check. Di council say as part of efforts to check examination malpractice, dem bin embark on one innovation (paper serialization) wey di national examination body bin already deploy. Dem carry out di paper serialization in Mathematics, English Language, Biology and Economics, but one internal post result release procedure bin reveal some technical bugs for di results. Di national examination body say sake of dat, dem bin get to shut down di result checker portal and try resolve di mata wit "transparency and urgency" within di next 24 hours. How WAEC candidates perform for WASSCE 2025 Na on Monday, 4 August, Waec release di results of di 2025 West African Senior School Certificate Examination. But in comparison to previous results, dis na di worst results in five years. Di Head of Nigeria's Office (HNO) of Waec, Amos Dangut, bin tok say dis year result record 33.8 per cent decrease in performance compared to 72.12 per cent wey dem record for 2024. "Out of di total number of candidates wey sit for di examination for Nigeria, 1,517,517 candidates, wey represent 77.06 per cent, get dia results fully processed and released while 451,796 candidates, wey represent 22.94 per cent, get one or more of dia subjects still under processing sake of some issues to dey resolved," e tok. Amos Dangut say Waec don withhold results of 192,089 candidates sake of different reported cases of examination mago-mago. Dis number represent 9.75 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination. According to Dangut, di figure represent 2.17 per cent decline if you compare wit di 11.92 per cent wey dem bin record for di 2024 edition of di same examination.

Kemi Badenoch's God Delusion
Kemi Badenoch's God Delusion

Spectator

time6 days ago

  • Spectator

Kemi Badenoch's God Delusion

Conservative leader Kemi Badenoch has given a wide-ranging interview to the BBC's Amol Rajan in which she touched upon her Nigerian upbringing, her feeling of identity and she even revealed she called out a peer for cheating at school. But perhaps her most interesting comments came when she revealed how she lost her belief in God. The Reverend Fergus Butler-Gallie, author of Twelve Churches, and Tim Shipman join Oscar Edmondson to discuss Kemi's comments. Is it credible to call yourself a 'cultural Christian'? And, with both an atheist Prime Minister and agnostic Leader of the Opposition, is the decline of religion in politics inevitable? Plus: with the news that Germany will suspend weapons exports to Israel, following Benjamin Netanyahu's announcement that Israel will pursue a full takeover of Gaza, will the UK follow suit? Produced by Patrick Gibbons.

Kemi Badenoch's failure to relaunch
Kemi Badenoch's failure to relaunch

New Statesman​

time6 days ago

  • New Statesman​

Kemi Badenoch's failure to relaunch

Photo byKemi Badenoch is relaunching. The Conservative leader has made a number of brand-aware media interventions recently. First, she said she intended to be Britain's Javier Milei, the chainsaw-wielding (literally) 'anarcho-capitalist' Argentinian president whose political mission is to slash public spending. This was followed by the revelation that she no longer identifies as Nigerian. (As a reminder, Badenoch was born in the UK to Nigerian parents and spent most of her childhood in Lagos, before coming to London to study for her A-levels.) Then she went to war with Liz Truss (as discussed earlier this week), finally putting a bit of distance between herself and the least popular Conservative prime minister. Now, the notoriously media-adverse Tory leader has done a wide-ranging interview with the BBC's Amol Rajan, in which she discusses how she once got another pupil expelled for cheating while at school around aged 15 and lost her Christian faith after reading how the Austrian Josef Fritzl man raped his captive daughter for 24 years. These anecdotes are, to be honest, a bit odd. On the cheating one, Badenoch said that when people (it's unclear whether she means her classmates or her teachers) asked why she had got the other boy into trouble, 'I said 'because he was doing the wrong thing'.' She clearly thinks this makes her sound moral and just, as somebody who cannot abide rule-breakers. That Badenoch also said she 'didn't get praised for it' implies she expected praise; again, suggesting she believes the anecdote puts her in a positive light. Whether most Brits, thinking back to their teenage selves, will be able to imagine doing as she did or consider it worthy of praise is more dubious. As for her faith, Badenoch's position that she is a 'cultural Christian', even if she no longer believes in God, is hardly unusual for a Conservative leader. Liz Truss said similar when she was appointed PM. David Cameron, meanwhile, borrowed Boris Johnson's line that his 'religious faith is a bit like the reception for Magic FM in the Chilterns: it sort of comes and goes'. Nor is the reasoning she gives for atheism all that startling. Lots of people find their belief in a higher power waning when confronted with tragedies, whether natural disasters, personal grief or horrific news stories. But just read Badenoch's description of her thought process: 'I was praying for all sorts of stupid things and I was getting my prayers answered. I was praying to have good grades, my hair should grow longer, and I would pray for the bus to come on time so I wouldn't miss something… Why were those prayers answered, and not [Elisabeth Fritzl's] prayers?' Leaving aside the simplistic theology, the Fritzl case hit the news in 2008, when Badenoch was 28. Praying for longer hair or for a bus to come on time does not exactly chime with the average adult experience (most of whom no longer have to worry about getting good grades, either). This isn't the first time Badenoch has given details of her life or thinking that make her seem eccentric. Her insistence that she never makes gaffes springs to mind, as does her tirade against sandwiches (in particular, moist bread). She still clings to the origin story of the 'poverty of low expectations' she encountered at school in London, when teachers discouraged her from applying to Oxbridge or medical school. Her lacklustre A-level results (B, B, D) suggest there may be more to this discouragement than unthinking racial prejudice. So do the comments from her former head teacher – whom Rajan quotes in the BBC interview when she retold that story – which refute her assessment. But that doesn't fit into the Badenoch world-view. Subscribe to The New Statesman today from only £8.99 per month Subscribe Seeming normal is both a crucial skill in politics and one that many politicians struggle with. Those who reach the upper echelons of politics are rarely 'normal' in any real sense – the key is how well they are able to hide their various oddities. Once the public (or the media) decides you are a bit weird (Ed Miliband eating a bacon sandwich), it's hard to recover. Unless you lean in and make weirdness your brand (Boris Johnson painting cardboard boxes to look like buses). Voters are on the lookout for 'gotcha' moments when they detect a whiff of inauthenticity (David Cameron forgetting who his favourite football team was), while the reality of being a front-line politician can make even genuine sentiment appear manufactured (Keir Starmer's love of Arsenal). The challenge Badenoch has is that she has not yet properly introduced herself to the British public. While she might be a Big Name In Westminster, according to YouGov one sixth of voters don't actually know who she is – putting her below Nick Clegg, Diane Abbott and Suella Braverman. It takes time to introduce an opposition leader to the British public, but there does need to be a strategy. As one former Tory adviser told me in March: 'When David Cameron was four months in… he was hugging huskies. All anyone knows about Kemi is she wants to cut maternity leave and hates bread.' Now they know she hates bread and loves snitching. Badenoch is in catch-up mode. One way to address that is to make big, attention-grabbing statements: like no longer identifying as Nigerian, or starting some blue-on-blue infighting by provoking Truss. Another is to try to win people over by opening up about issues of faith and ethical stances (the cheating example). But the latter only works if those stories are relatable. And their relatability isn't exactly helped by a simultaneous comparison with a far-right Argentinian with a chainsaw. All of this should be seen in the context of the Tories languishing on 18 per cent in the polls, during a summer recess in which Reform's crime campaign has sucked up all the political oxygen – and with just three months until Badenoch's immunity runs out, when Conservative MPs can trigger a leadership challenge. The need for some kind of relaunch is clear. But it's hard to see how her recent interventions are meant to help, and she risks affirming her reputation for weirdness before the public knows much else about her. After all, it's not like Miliband chose to get the bacon sandwich expelled. This piece first appeared in the Morning Call newsletter; receive it every morning by subscribing on Substack here [See also: Keir Starmer would be a much happier politician in Japan] Related

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store