logo
#

Latest news with #NationalYouthServiceCorps

Corp member wey call Tinubu 'terrible president' break any law? - Wetin NYSC Bye-Law tok
Corp member wey call Tinubu 'terrible president' break any law? - Wetin NYSC Bye-Law tok

BBC News

time17-03-2025

  • Politics
  • BBC News

Corp member wey call Tinubu 'terrible president' break any law? - Wetin NYSC Bye-Law tok

Di question on weda corps members fit come out to tok dia mind on di situation of di kontri or not na im dominate tok-tok for Nigeria social media space ova di weekend. Di mata turn hot debate afta one corps member wey dey serve for Lagos state, Nigeria biggest commercial city, for one video wey don go viral now, lament di high cost of living for di kontri, plus di economic challenge di kontri dey face. Di corper also for di video condemn President Bola Tinubu administration, as she call di presido "terrible leader". She also add say Lagos na "smelling state", wey don generate plenty gbasgbos on social media. Dis her tok don provoke plenty reactions for di kontri as some Nigerians dey of di position say she no get right as corper to openly kick against di goment according to di National Youth Service Corp (NYSC) handbook. Odas dey of di opinion say she get di right to express her grievance as she be Nigerian and she get di right to exercise di freedom of speech as e dey for di Nigeria constitution. Some pipo also argue say she be employee of di Nigerian goment, therefore, she no get right to chook mouth for wetin dey happun for di kontri. Odas argue say NYSC na para-military, and so, na no go area. Although di National Youth Service Corps (NYSC) neva comment on di mata, di corper allege say some NYSC officials don call to threaten her sake of wetin she tok. Wetin di corper tok wey lead to gbasgbos for di kontri For di video post wey don go viral for social media now, di corps member lament di economic condition of di kontri. She say prices of food dey go up every week and question wetin goment dey do to reduce di high cost of living. She describe President Tinubu as a "terrible president" sake of di worsening economic palava. "I just wan tok say our president, I no know if any oda president dey wey terrible pass you. But you be terrible president." Afta dat video go viral, di corper post anoda video on her TikTok account wia she allege say one NYSC official call and threaten her to delete di video. But she insist say na di truth about di kontri situation she tok. Di corper post say, "Dear Nigerians, NYSC board don dey threaten me say make I stop to dey tok on dis issue. In less dan 24 hours, goment don already dey threaten me, starting wit di NYSC board! "Why I no fit speak up? Becos I be NYSC corper no mean say I no get right to complain. "Why goment no wan listen to di criticisms of dia citizens? Dem believe say dem get chain on me, wey be NYSC, and dem dey use am to hold me. #officialasiwajubat I no do anything wrong. I criticise your goment, and I demand say make dem hear us." Wetin NYSC law and di Nigerian constitution tok about di mata? No specific section for di NYSC Bye-Laws outrightly ban corps members from calling out di goment. However, one clause dey, wey indirectly regulate how corps members fit express themselves publicly. According to Section 3 (i) of di NYSC Bye-Laws Code of Conduct (2011), "Any member wey address di press on any policy issue without di written consent of di State Coordinator go dey tried by di Camp Court and, if found guilty, e go dey liable to extension of service for thirty (30) days on half pay." Dis one mean say if any corps member wan make public statement, especially di one wey go criticise goment policies, technically, dem suppose get clearance from NYSC officials first. Dis na one of di unclear rules wey NYSC officials dey often use to silence corps members wen dem speak out. However, wetin di bye law possibly dey refer to na official press engagements, wia di corper go follow tori pipo tok, no be di one dem go post on dia personal social media account. One Human Rights Lawyer, Inibehe Effiong wey chook mouth for dis mata clear am say no provision dey for di NYSC Act wey subject corps members to civil service Rules. "Criticizing di President or di goment no be offence under di NYSC Act (See Section 13). E also no be offence under di NYSC Bye Laws (Section 4 of di Revised Bye Laws, 2011). Oga Effiong say im don watch all di videos of di lady wey pipo dey debate on top and im no see anytin slightly partisan for her comments. E say she only express her justified frustrations wit di situation for di kontri, particularly di impact of di inflation on her and oda Nigerians, wey dey within her constitutional right to freedom of expression as guaranteed by Section 39 of di Constitution of the Federal Republic of Nigeria, 1999 (as amended). Di lawyer also clear am say corps members no be civil servants or public servants. Section 2 of di NYSC Act tok say every eligible Nigerian go dey called-up to serve for a continuous period of one-year national service. Na National Service, no be federal or civil service. Di NYSC na agency of di Federal Government, but corps members no be employees of di federal government or staff of di NYSC. Also, di Certificate wey corps members dey get afta dem complete dia National Service as prescribed in Section 11 of di NYSC Act na Certificate of National Service, no be certificate of employment. Federal or state goments no dey issue employment letters give corps members. Amnesty international, odas react Amnesty International, one ogbonge human rights group for one post on X, tok say di corp member dey perfectly within her right to express her discontent peacefully. Di rights groups say make authorities prioritize addressing di kontri economic woes instead of her life wey dem dey threaten. "Make di Nigerian authorities stop to dey respond wit violence and threats to individuals and groups wey express dissenting opinions — in utter disregard for Nigerian constitution and international law. Holding and voicing different views no be crime." President of di Trade Union Congress (TUC) Festus Osifo, for im reaction tok say di corp member bin tok out of frustration and advise di goment say make dem no go afta her but dey "tolerant of critics." Oga Osifo wey react on di trending mata on one television programme say goment need to understand say pipo dey para. "Di goment need to understand say pipo dey frustrated, pipo dey hungry, pipo don tire. So, if dem decide to para, I strongly believe say goment no suppose personalise am and come afta such individuals. Imagine a young lady wey dey carry out her NYSC function, wetin she really fit do to bring down di goment? Na her personal frustration she air." One former Nigeria Vice President Atiku Abubakar post say, "I deeply admire her boldness and wisdom—her fearless resolve to speak truth to power, undeterred by di weight of opposition." E say instead of di hostility wey she don receive, she deserve encouragement and support. E also be like say human rights activist and presidential candidate for di 2023 general election, Omoyele Sowore, dey rally support for Ms Uguamaye, as e post on X say im go follow her go her NYSC Local Government Inspector office alongside a team of lawyers in case. Sowore tok say wen dem reach di LGI, no official turn up throughout dia stay.

Salome Adaidu murder: Suspect Timileyin Ajayi plead not guilty
Salome Adaidu murder: Suspect Timileyin Ajayi plead not guilty

BBC News

time27-01-2025

  • BBC News

Salome Adaidu murder: Suspect Timileyin Ajayi plead not guilty

Di High Court of Justice for Lafia, Nasarawa state don adjourn di trial of di suspected killer of di late Salome Adaidu to 17 - 20 March, 2025. Di alleged killer of di late Salome Adaidu, Timileyin Ajayi, plead not guilty to di one count charge of culpable homicide wey dey punishable by death, contrary to Section 221 of di Penal Code of Northern Nigeria. Timileyin Ajayi show face for di High Court of Justice, Lafia, di Nasarawa State capital wia dem arraign am on Monday 27 January, 2025. Na Justice Simon Aboki sitdown ontop di case for di arraignment. Channels report say di prosecuting counsel Stanley Nwaforagwu, afta di arraignment, tell tori pipo say "dem properly arraign di defendant, Timileyin Ajayi bifor di High Court of Justice, Lafia on a one-count charge of culpable homicide punishable wit death. Dem take im plea and im plead not guilty to di charge and dem set di date for trial. Di case dey adjourned to 17 - 20th March for trial." "Di court want make di trial happun sharp-sharp and na a welcome development. We get overwhelming evidence to sustain di charge and we dey optimistic say dem go do justice." Di Defense Counsel, Joseph Tukur, say, "today na basically for arraignment and as di law demand, im don enta im plea already. So, we don take a date for hearing. No be my place to prove di case, na my place to defend am, di work of di defence counsel na to make sure say di prosecution do dia work legally well wey go prove di case beyond a reasonable doubt. I dey here to make sure say di law dey fulfilled." According to local media, one Senior Advocate of Nigeria Jibrin Okutekpa wey lead di team of lawyers for di family of the deceased, tok say, "We dey watch in brief for di family of di deceased. We no dey here for di defendant and dis na serious mata of national importance and we dey here to see say dem do justice." On 17 January 2025, Justice Aboki of di High Court for Lafia, Nasarawa State bin adjourn di hearing of di alleged murder of National Youth Service Corps member, Salome Adaidu to 27 January, 2025. Timileyin Ajayi bin allegedly kill Salome Adaidu for early January. Police bin arrest am with di head of one National Youth Service Corps member, Salome Adaidu as e dey go Uke for Nasarawa State. Police also drag di 32-year-old gospel singer to court on a one-count charge of culpable homicide wey dey punishable by death. Court come give order make Ajayi, stay for prison. Justice Aboki give order make e stay for di correctional facility for Lafia sake of say im bin no fit take im plea becos im counsel (lawyer) bin no show face for court. Ajayi allegedly murder Salome wen she bin visit im house for di Papalana axis for New Karshi for Karu Local Goment Area of Nasarawa State. Police bin parade Ajayi wit di knife and machetes im allegedly use to commit di crime.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store