logo
Police invite popular House On The Rock pastor to ansa question about viral video

Police invite popular House On The Rock pastor to ansa question about viral video

BBC News5 hours ago

Popular Nigerian pastor, Paul Adefarasin, don turn imsef in to di Lagos state police command to answer questions about one viral video wey show wia im hold object wey resemble firearm while driving.
Police tok tok pesin Benjamin Hundeyin tell BBC Pidgin on Tuesday say na dem invite di pastor sake of di viral video.
"We invite am and e honor di invite, e still dey wit us" na so Mr. Hundeyin tok.
E say detectives dey interrogate di pastor and dem don commence investigation into di viral video wey show wia im hold gun-like object against anoda road user and dey drive car without plate number.
Di video bin comot for social media two weeks ago and go viral. Di video show di pastor as e dey drive one SUV wey no carry plate number.
E raise plenti dust as pipo begin question why pastor go dey carry fire arm.
But Pastor Adefarasin bin debunk allegations say e carry firearm for di viral video.
During Sunday service same week, Pastor Adefarasin react say no be gun im carri.
"I dey assure you say dat tin no be firearm and I no point am on anybodi" na so e tok.
According to am na clickbaiters attack am in order to make more money.
E say "dem falsely accuse me say I carry firearm, say I point firearm on aggressive content creator wey come close into my personal space"
Pastor Adefarasin further add say im no get pistol license to carry firearm, im no get firearm and I no point firearm on any pesin".
After im response, some social media frenzy guys still feel say di pastor no clear di air properly as im no explain wetin im actually carry for di viral video.
Wen BBC Pidgin ask police wen dem go release di pastor, di tok tok pesin answer say for now, im dey wit dem and e no wan speculate di outcome of im visit.
Pastor Paul Adefarasin dey popular not only for Nigeria but across Africa and di world as im be di organizer of one of di biggest gospel music festival for Africa wey dem dey call The Experience.
Im be di lead pastor of popular House on di Rock Church wey get branches for major cities across Nigeria.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Boy, 12, rushed to hospital with serious injuries after being hit by car after school
Boy, 12, rushed to hospital with serious injuries after being hit by car after school

Daily Mail​

timean hour ago

  • Daily Mail​

Boy, 12, rushed to hospital with serious injuries after being hit by car after school

A 12-year-old boy has been seriously injured after being hit by a car after school. Emergency services rushed to a residential road in Weymouth, Dorset earlier this afternoon. A car had hit a pedestrian on Dennis Road at around 4pm, Dorset Echo reported. The pedestrian, a 12-year-old boy was rushed to hospital with serious injuries. His condition is not believed to be life-threating nor life-changing, police said. Road closures were put in place earlier this evening following the crash. His next of kin has been made aware, police said. Officers remain at the scene.

Benue killings: Timeline of attacks wey don lead to mass deaths for central Nigeria in di last 60 days
Benue killings: Timeline of attacks wey don lead to mass deaths for central Nigeria in di last 60 days

BBC News

time2 hours ago

  • BBC News

Benue killings: Timeline of attacks wey don lead to mass deaths for central Nigeria in di last 60 days

Tori of di latest attack for Benue state Nigeria wey lead to di deaths of over 100 pipo for Yelwata community for north central Nigeria dey trend for social media. Dis recent attacks, according to di National Emergency Management Agency, Nema, bin happun on Saturday, 14 June, 2025. Nema say dia early investigation show say more dan 100 pipo kpai for di attack including two sojas and one officer of di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC). "Dozens of pipo sustain injuries, and 46 individuals bin dey rushed to hospitals. Sadly, 20 of dem later die for hospital sake of di injuries wey dem sustain," di Nema statement read. But dis Yelwata killings no be di first in recent times, na di latest of di horrible attacks on communities for central Nigeria wey don claim di lives of hundreds of pipo in di last two months. Wen pipo relax wit hope say evritin don calm down, di jaguda pipo go waka go anoda community wey di villagers no expect. Men, children and women too don share di horrible experiences of rape from di herders hand be victims. Nigeria president Bola Tinubu don finally make promise say im go clear im schedule to visit Benue state on Wednesday 17 June 2025. Currently, Security oga dem move to end Benue killings as Tinubu prepare to enta Yelwata Earlier, Police tok-tok pesin for Plateau State, Fred Alabo for one interview wit BBC Pidgin tok say dem go do evritin legally possible to make dis jaguda pipo face di law. Dis na a timeline of di attacks fpr both Benue and Plateau State in recent weeks wey don kill hundreds and how e happun. Timeline of attacks and killings for central Nigeria March 2025 - For ending of March, about 52 pipo bin kpai for inside one attack for Bokkos local goment area of Plateau State. Di development bin make di National Security Adviser (NSA) Nuhu Ribadu to visit di area and tok say enough don dey enough for di killers, and e go make sure say di killings stop. Wit all di ginger wey dat tori bin make di killings still dey go on. April 2025 - Anoda attack bin happun for Bassa local goment area of Plateau State, north-central Nigeria, according to wetin residents bin tell BBC Pidgin. Di attack bin happun for di early hours of Monday, 14 April between 1:00am and 2:00am. Yakubu Ventim wey be tori pesin for di state bin tok say di chairman of Bassa local goment area, Joshua Sunday Riti, bin carry some TV tori pipo wit plenty security to di community wia di attack bin happun. "Na about 38 to 50 pipo dem bin massacre for di village dis morning. "Dem ambush di community and kill mostly women and children," oga Ventim tok. May 2025 - At least 10 pipo die sake of kasala between herders and farmers for Riyom Local Goment Area of Plateau State. Tori pipo Channels Television bin report say from wetin start from farm destruction, cattle rustling, and attacks on livestock, pipo from both Fulani and Berom communities clash. Dem add say statement from Operation Safe Haven, confam say di insecurity for di council area bin start on Monday, May 12, 2025, wen suspected youths bin slaughter and rustle cattle wey bin enta dia farms for Dayan village, Riyom Local Goment Area. To take revenge, di herders attack Danchindo village on di evening of May 13, dem kill four people befor dem run as dem hear say police dey come. On May 14, di villagers bin kill 26 cows as dem dey para say dem kill dia pipo. Di herders later comeback again dat day, dem attack one settlement near Wereng Kam community, wia dem kill six locals. June 2025 - E be like say di month of June record di highest killings in recent times for Benue state. Di number of pipo wey die from di attacks on Gwer West and Apa local government areas of Benue State pass 50. Eyewitnesses bin also tok say some pipo still dey miss sake of say out of fear and to run for dia lives some pipo jump inside well. Suspected herdsmen bin attack residents of Tse-Antswam for Naka town, wey be headquarters of Gwer West LGA and Edikwu Ankpali for Apa local goment area of Benue state. According to Nema first report on Monday 16 June, 2025 na 100 pipo die, and 6,500 displaced for Benue attack. But locals and oda tori pipo tok say di number dey around 200. Ova di years, kasala between herders and farmers na regular tin for many parts of northern Nigeria including Plateau and Benue states. In reality, na di whole kontri dey feel di heat as e dey disturb farming and cause insecurity wey dey affect local food production and farm produce. Residents for northern Nigeria dey also face issues of banditry and oda criminalities. Who dey carry out dis attacks? Recently, di Govnor of Plateau State, Caleb Mutfwang, tok say dis regular attacks wey dey happun for di state don pass herdsmen and farmers fight and add say wetin dey happun now na terrorist attacks and "genocide". Mutfwang tok dis one for interview wit BBC as e lament say di killings don too much despite all di efforts wey di state goment dey do to make sure say peace dey. "I dey tell you for all honesty say I no fit find any explanation wey pass say dis na genocide wey terrorists dey sponsor. Di question na who be di pipo wey dey behind di organisers of dis terrorism? Dis na wetin di security agencies need to help us to reveal," di govnor tok "As I dey tok to you, e no dey less dan 64 communities wey don dey taken ova by bandits for Plateau between Bokkos, Barkin Ladi, and Riyom local goments. Dem don take di communities ova, rename dem, and pipo dey live dia comfortably on top lands wey dem pursue pipo comot and occupy." Also Benue State Govnor Hyacinth Alia tell tori pipo Arise TV for live interview on Tuesday 17 June say di recent attacks for Benue na acts of terrorism, as e don go beyond farmer-herder clashes "Of late, wetin we experience and wetin we see dey see dey appalling. E strong well-well, way beyond farmer-herder crisis. Di attacks na by bandits and terrorists." im tok. Youths of Benue State do we no go gree waka on Sunday for di state sake of di killings wey dey too much. ''We don taya, we dey helpless, we don become weak, we dey broken, we dey powerless becos goment no dey help us''. Di protest come less dan 24 hours afta suspected herders enta Yelwata community in di early hours of Saturday. Dem begin kill pipo and burn houses. Di number of pipo wey don die from di attacks wey just hapun for Yelwata community for Benue state fit still go up as Nema say di current figures still dey inconsistent sake of di volatile security situation and limited access to di affected areas. As e be now, more dan 6,527 pipo don run comot for dia house for Yelwata and dem dey take shelter for Internally Displaced People Camps. Dis include "1,768 females; 759 males; 657 children under 18 years; 1,870 adults above 18; 252 breast feeding mothers; 82 pregnant women; and 91 elderly persons". According to Nema, hospitals for Makurdi dey call for urgent blood donations for di pipo wey injure for di attack, and also for humanitarian support for di pipo wey dey IDP camps.

All new Facebook videos to be classified as Reels soon, Meta says
All new Facebook videos to be classified as Reels soon, Meta says

Reuters

time2 hours ago

  • Reuters

All new Facebook videos to be classified as Reels soon, Meta says

June 17 (Reuters) - All new videos uploaded on Facebook will soon be classified as Reels, simplifying how users publish visual content, social media giant Meta Platforms (META.O), opens new tab said on Tuesday. The Instagram parent said Reels on Facebook will no longer have length or format restrictions, and include all types of video content — short, long and live. Previously uploaded video content will remain as such on the platform while videos posted after the change will be classified as Reels. The company will also rename the Video tab as Reels tab. As part of the update, users will be prompted to confirm their audience setting or select a new one if their feed posts and Reels currently have different settings. The update will also give users access to more creative tools. Meta said it will gradually roll out these changes globally to profiles and pages over the coming months.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store