
How pilot wey dey do air show crash wit plane inside water for Durban
According to local tori pipo, News24, dem quote di South African Civil Aviation Authority say, di aeroplane wey be ZS-AEC Extra 300 bin dey part of airshow for di North Beach. Dem bin dey perform dia final display wen e crash.
Di team from di Metro Police search and rescue team, di South African Police Service and di National Sea Rescue Institute don dey search around di beach togeda wit paramedics, fire department and oda emergency services.
News24 see search crews dey carry doti from wreckage wey include di fuselage parts and di plane wheel.
Na high tide dey affect di efforts to find di pilot bodi and oda parts of di plane. Di NSRI say di 61-year-old pilot for Johannesburg still dey miss.
Pesin wey dey di event tell News24 say, "dem pack here and school pikin gada to see di show. Di airplane bin move normal-normal for di air and evribodi dey ginger. All of a sudden, e just swing too fast but we bin reason say e dey part of di show. But wen e dey go move inside di wata, pipo start to shout and den e crash"
KwaZulu-Natal SAPS tok-tok pesin Robert Netshiunda say di pilot wey dey also fly commercial flights na di only pesin wey dey di aeroplane.
Times Live report say friends and family don dey post tributes for di pilot wey dey di accident.
Di accident wey happun for display and air show for di youth and public bin dey organised by di Civil Aviation Authority afta three day aviation global summit.
KwaZulu-Natal Transport MEC Siboniso Duma tok say di accident na unfortunate end to successful event.
E say dem don tell di family wetin happun but dem say as di mata dey sensitive dem go do proper analysis by di right time.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


BBC News
13 hours ago
- BBC News
Plane lands in cornfield near Cromer after hitting turbulence
A plane landed in a cornfield after hitting turbulence, an investigation found. On 10 June 2024, an Aeroprakt A32 Vixxen, G-RASP, had been flying from Nottingham City Airport to Northrepps Airfield in Cromer, Norfolk, when it encountered difficult conditions while passing over trees. An investigation led by the Air Accidents Investigation Branch (AAIB) found the aircraft had experienced turbulence, and despite the pilot trying to correct its path, it started to rapidly descend. The plane had been carrying a 69-year-old pilot and passenger who were able to evacuate from the plane and were left with minor injuries. The aircraft was left with substantial damage to the airframe and propeller. The pilot said he had landed "many times" at the airfield in Cromer before; however, despite applying power and rudder to correct the disturbance, he was unable to stop it from landing heavily on its nosewheel. While he could have diverted to an airfield with a longer and more "in-to-wind" runway, he was concerned that any damage to the nose leg would make the plane collapse on touchdown, leading to unpredictable consequences. While the aircraft was fitted with a ballistic parachute recovery system, he was unwilling to use it due to an unknown outcome. Due to the passenger becoming distressed, the pilot said he conducted an immediate precautionary landing on the "softest soil and springiest crop" that he could find and turned the fuel and battery master off before touchdown. The pilot said that landing as slow as possible in the cornfield had achieved a "more predictable" and safer outcome than diverting or using the parachute system. Follow Norfolk news on BBC Sounds, Facebook, Instagram and X.


Reuters
a day ago
- Reuters
Five crew dead after helicopter crash in Pakistan
Aug 15 (Reuters) - A helicopter crashed in northwestern Pakistan during a relief mission, killing all five crew members including the two pilots, the provincial chief minister said on Friday.


BBC News
a day ago
- BBC News
How pilot wey dey do air show crash wit plane inside water for Durban
Police don reveal say dem still dey find popular pilot wey crash enta water near central Durban on Thursday afternoon. According to local tori pipo, News24, dem quote di South African Civil Aviation Authority say, di aeroplane wey be ZS-AEC Extra 300 bin dey part of airshow for di North Beach. Dem bin dey perform dia final display wen e crash. Di team from di Metro Police search and rescue team, di South African Police Service and di National Sea Rescue Institute don dey search around di beach togeda wit paramedics, fire department and oda emergency services. News24 see search crews dey carry doti from wreckage wey include di fuselage parts and di plane wheel. Na high tide dey affect di efforts to find di pilot bodi and oda parts of di plane. Di NSRI say di 61-year-old pilot for Johannesburg still dey miss. Pesin wey dey di event tell News24 say, "dem pack here and school pikin gada to see di show. Di airplane bin move normal-normal for di air and evribodi dey ginger. All of a sudden, e just swing too fast but we bin reason say e dey part of di show. But wen e dey go move inside di wata, pipo start to shout and den e crash" KwaZulu-Natal SAPS tok-tok pesin Robert Netshiunda say di pilot wey dey also fly commercial flights na di only pesin wey dey di aeroplane. Times Live report say friends and family don dey post tributes for di pilot wey dey di accident. Di accident wey happun for display and air show for di youth and public bin dey organised by di Civil Aviation Authority afta three day aviation global summit. KwaZulu-Natal Transport MEC Siboniso Duma tok say di accident na unfortunate end to successful event. E say dem don tell di family wetin happun but dem say as di mata dey sensitive dem go do proper analysis by di right time.