logo
Villagers tori how thousands turn refugees, communities become ghost town as notorious bandit Bello Turji give dem eviction notice for Sokoto

Villagers tori how thousands turn refugees, communities become ghost town as notorious bandit Bello Turji give dem eviction notice for Sokoto

BBC News13-05-2025

Pipo from several villages for Isa Local Government area for Sokoto State, northern Nigeria, don leave dia homes after dem say notorious bandit leader tell dem to comot witin few days or im go attack.
Di bandits tell dem to comot afta dem attack some villages for di local government on Saturday.
Di villages wey di bandits attack and sack for dia communities na Sududdubu, Galadima, Tsulawa, and Bafarawa, wey be village of former oGvnor of Sokoto State, Attahiru Bafarawa.
Reports say fear make some pipo for di communities comot go inside main town for Isa local goment for Sokoto, while odas run go Shinkafi local goment for Zamfara state as refugees.
According to one Bashir Altine, wey dey live around Isa local goment area, e tok say di bandits attack na revenge for recent army attacks on bandits for di area.
"Bello Turji and im boys dey in control of Sabon Birni and Isa local goments, and dem don dey terrorise dat area for years."
"I fit tell you say more dan 30 villages don become ghost communities sake of di fear for dia lives," Altine tok.
E add say, "na di bandits demself come direct to those villages come tell dem say make dem comot."
Anoda resident for one of di villages tell BBC Pidgin say na Bello Turji pipo come dia village dey collect anytin wey get value and tell dem say make dem comot before dem come back.
'Afta soldiers comot, Bello Turji pipo come our village dey collect anytin wey get value from our hand. And dem tell us say make we comot if we wan live.'
E add say, 'Di bandits kill seven to eight pipo during dia attack, while 20 odas bin injure.'
"We don already tell di authority our situation sake of say we no get any security personnel for our village."
According to di pipo wey comot from dia villages, dem tok say dem don dey live in fear for di past years becos of plenty attacks from bandits for dia region for Sokoto State, northern Nigeria.
Police tok-tok persin for Sokoto, Rufa'i Ahmad, tell BBC Pidgin say di police no receive any official complaints from dat area, but e tok say deployment dey for di area.
"Regarding dia mata, we never receive any official complaints from di pipo for dat area," Ahmad tok.
But e add say since last week, Thursday and Friday, deployment don dey for dat area.
Ahmad add say, "Since before dis incident wey pipo dey tok, deployment don already dey dat area. Sometin new fit happun wey we no know, dat na why e dey very important for residents to update us on wetin dey happun for dia areas."
"As I dey now, we dey work and collaborate wit oda security personal to tackle insecurity kasala for dat region"
E urge pipo for areas wey dey experience insecurity to dey update security pipo with informant so dem fit help dem well.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'
Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'

BBC News

time10 hours ago

  • BBC News

Benue attacks: 'Dem come guerrilla style and begin dey butcher pipo'

Di number of pipo wey don die from di attacks on Gwer West and Apa Local Goment Areas of Benue State don rise to ova 50 local authorities tok. Suspected herdsmen attack residents of Tse-Antswam for Naka town, wey be headquarters of Gwer West LGA and Edikwu Ankpali for Apa local goment area of Benue state. Tori be say many pipo die, as oda pipo run to save dia lives. According to di Chairman of Gwer West Council Mr. Victor Ormin and di traditional council, Chief Daniel Abomtse bin confam say dem bin recover 21 deadibody on Sunday. Chief Abomtse di Ter Nagi, tok say di attackers bin come in guerrilla style wen dem attack Tse Antswam. Im add say many pipo get different degree of injuries. "In fact, di way dem butcher some of di pipo I doubt if dem go survive, we still dey search becos many pipo bin run inside bush wit gun wounds and some also enta inside well to escape di herdsmen," di monarch tok. According to Chief Abomtse, di community wey dis attack happun dey directly opposite di military check point along Naka/ Makurdi road. Edikwu record 37 deaths Meanwhile for Edikwu Ankpali for Apa Local Goment Area, di causality figure hit na 37. Di Chairman of Apa Local Goment Area, Adam Ogwola, wey confam di tori say dem still dey expect di number of death victims to increase as dem still dey search and dem dey see more deadbody. "Di attack dey devastating" "Di pipo wey wound dey for general hospital already and dey get medical attention". One community leader, John Ikwu also confam say dem bin see 25 deadbody on Sunday for Edikwu Ankpali. Di community leader say time don reach wey dem go begin confront di jaguda pipo as im describe di killing as barbaric and unwarranted. Im say na heartless killers dey attack dia communities evriday without control. For statement wey di Benue State Police Command release on Monday, through dia tok-tok pesin Udeme Edet, dem say di Commissioner of Police, Emenari Ifeanyi don relocate di Area Commander to Apa. Im also direct di tactical team to take over Naka as im deploy resources to flash points for di state including Apa and Gwer-west Local Goment Areas. For police statement, dem tok say na ten and twelve pipo die for di two attacks and five odas bin dey hospital. "For di last one month, personnel wey we post to dis areas don dey fight wit dis attackers and dem don suppress dem for most areas. Unfortunately, dis bandits dey search for vulnerable pesins and attack dem, dem kill some pipo on 1st June, 2025." Di CP dem redeploy personnel to cover up entries and exits to flash points. In di last two weeks, tori about different type of death don full for social media and news channels. Benue state na one of di flash points wey suspected herders dey attack communities and kill pipo. For April, di number of death for Benue herdsmen attack on Logo and Gbagir rise to 56. Even though di govnor bin don condemn dis attacks many times, e still dey happun.

Nigeria's defence chief proposes fencing borders to curb insecurity
Nigeria's defence chief proposes fencing borders to curb insecurity

Reuters

time11 hours ago

  • Reuters

Nigeria's defence chief proposes fencing borders to curb insecurity

ABUJA, June 3 (Reuters) - Nigeria's defence chief on Tuesday called for the country's borders with its four neighbours to be completely fenced to curb the entrance of armed groups amid escalating insecurity. Nigeria's military has been strained by widespread security issues, particularly a 16-year insurgency in the northeast led by Islamist militant group Boko Haram and its offshoot Islamic State West Africa Province. Security forces and civilians have been attacked and killed and tens of thousands of people have been displaced. Defence Chief of Staff, General Christopher Musa, who spoke at a security conference in the capital Abuja, said "border management is very critical," citing Pakistan's 1,350 km (839 miles) fence with Afghanistan and Saudi Arabia's 1,400 km barrier with Iraq as successful precedents. This is the first time a top Nigerian official has publicly suggested such a measure. "Other countries, because of the level of insecurity they have, had to fence their borders," he said. Nigeria borders Niger Republic, Cameroon, Benin, and Chad, which are all grappling with escalating militant campaigns across the Sahel. Nigerian authorities often attribute its prolonged insurgency, including recent attacks on military stations, to foreign fighter infiltration. Nigeria's longest border (1,975 km) is with Cameroon in the northeast, a Boko Haram hotspot. It also shares 1,500 km with Niger and 85 km with Chad, nations that have lost territory to armed groups. Musa warned Nigeria's perceived wealth makes it a target. "It is Nigeria that everybody is interested in. That is why we need to secure fully and take control of our borders," he said. "It is critical for our survival and sovereignty."

'Man Utd or Barca' - wia Osimhen dey go next?
'Man Utd or Barca' - wia Osimhen dey go next?

BBC News

time16 hours ago

  • BBC News

'Man Utd or Barca' - wia Osimhen dey go next?

Nigeria boss Eric Chelle dey expect Europe top sides to show interest for Victor Osimhen afta di striker help fire Galatasaray win di Turkish title. Di 26-year-old dey set to return to parent club Napoli afta e score 37 goals for 41 games during dis season loan spell wit di Istanbul giants. E get one year remaining for im contract for Italy, but e dey expected to leave Napoli as e no dey part of coach Antonio Conte plans. Wit im future undecided, Osimhen don dey left out of di Super Eagles squad for di international friendly away against Russia on Friday. "Victor is, for me, di best striker for di world," Chelle tell BBC Sport Africa. "For am e dey difficult to come for dis game becos e play a season wit a lot of pressure. "Di reality na say transfer window dey. During dis time, a player like am no dey focused at 100%. "I need to protect am physically and mentally, becos maybe e go [and get a transfer move]. "Maybe a club like Manchester United. Or maybe Chelsea, Barcelona or Real Madrid. So e need to dey focused on dat." Osimhen wan score 'even wen e dey sleep' Osimhen, an Under-17 World Cup winner for 2015, na second on Nigeria all-time list of top scorers wit 26 goals. E spearhead di Super Eagles attack for di 2023 Africa Cup of Nations, wia di West Africans finish as runners-up, and e dey crucial to bring back di hopes of reaching di 2026 Fifa World Cup. Nigeria only pick up three points from dia first four matches wen Osimhen dey absent wit injury, but di striker score three goals wen e return for March as di Super Eagles secure a win ova Rwanda and a draw against Zimbabwe. Chelle say e "neva see a competitor" like di former Wolfsburg and Lille front man. "E wan win evritin during training. E crazy," Chelle, 47 tok. "Wen di training session finish, e want to stay on di pitch and score again and again. "I tink maybe even wen e sleep e wan score too." Russia a 'great nation of football' Nigeria travel to Moscow afta winning di Unity Cup friendly tournament on Saturday. Di Super Eagles overcome fierce local rivals Ghana 2-1 last Wednesday and den beat Jamaica 5-4 on penalties afta a 2-2 draw for di final. Russia dey banned from competitive internationals following di invasion of Ukraine for February 2022, yet Chelle still expect a challenging encounter as e build towards di next round of 2026 World Cup qualifiers for September. Dose games, at home against Rwanda and away for South Africa, go dey crucial as Nigeria look to bridge di six-point gap to Group C leaders Bafana Bafana. "Russia na great nation of football," Chelle tok. "Dem need to play some international games becos wit di war, e dey difficult for dem. Dem get lots of great players for dia league. "I tink a lot of pipo go come to watch di game. "Di reality na to work for September, for di next window for di World Cup qualifiers. Dis na our goal."

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store