logo
How di security palava Nigeria dey face fit affect food supply and price

How di security palava Nigeria dey face fit affect food supply and price

BBC News6 hours ago

As kasala dey increase for Nigeria, especially for northern part of di kontri, wia unknown gunmen, Boko Haram/ISWAP, bandits, herders and farmers dey clash, di place wey dem also sabi for big farming don dey face serious palava.
As rainy season dey try reach im peak, farmers dey fear to go farm becos dem no wan risk dia life or make bandits kidnap dem.
For recent weeks, kasala wey happun for North east, North west and North central don claim many lives and properties. Dis areas na places wey dey produce plenty food for Nigeria.
Recently, Ministry of Agriculture for Nigeria release one internal memo wey tok say make dia staff fast for three days sake of food wahala for di kontri. Dis move show how serious di mata be.
For 2024 alone, World Food Program report say kasala, insecurity, inflation and climate wahala go make hunger worse for Nigeria, and say 26.5 million pipo go face serious hunger.
National Bureau of Statistics (NBS) tok say food inflation rate for October 2024 na 39.16% compared to 31.52% for October 2023. Experts believe say insecurity na one of di major reasons wey cause dis kain inflation.
Experts still tok say goment need to do more to fight insurgency or find modern farming ways becos farmers for north dey fear to go farm.
How security wahala fit affect food security and price dis year?
Secretary of All Farmers Association of Nigeria (AFAN), Dr Yunusa Halidu, tell BBC Pidgin say insecurity na one of di reasons wey dey cause food wahala and food inflation.
"Before dis insecurity wahala, many states for north dey farm plenty food, and food dey cheap for market," oga Halidu tok.
"If no be for insecurity, Zamfara alone fit feed di whole kontri afta harvest."
E believe say na insecurity cause di food inflation wey Nigeria dey face.
"Lack of food na one of di reasons why food price rise for recent years, and na insecurity cause am. You know say di more pipo dey need sometin, di more di price go up," e tok.
E mention say some northern states dey produce rice, wey Nigerians dey chop well-well, but rice and oda food production don reduce.
"States like Borno, Yobe, Katsina, Zamfara, Sokoto and Kebbi sabi farm rice, but sake of insecurity, dem dey produce small rice now."
Halidu add say "Na only Jigawa for all di northern states dey farm witout security wahala, sake say bandits no too dey dia."
E still tok say if federal goment fit solve insecurity and provide farming support, Nigeria no go get food wahala and food go cheap for evribodi.
Wetin be di solution?
Dr Angarawai Ijantiku Ignatius wey sabi farming well-well and be Country Representative for International Crops Research Institute for Semi-Arid Tropics (ICRISAT) for Kano, tell BBC Pidgin say federal goment need to embraced and invest for modern farming.
"But no mata di modern innovation, we still need land. But for small scale, we get wetin we dey call homegrown food.
Pipo fit use bucket or cement bag put soil and plant yam, pepper or onion for house. E fit feed family of two or three."
E tok say anoda modern way na make goment provide community-based place wey farmers fit plant and harvest.
"We get new technology wey we dey call community-based farming programme, wia we go give farmers free training on di new method.
How dem fit farm and harvest quick and distribute am for community," Dr Ignatius tok.
"But for dis one, we need community vigilante to protect farmers."
E also tok say dem suppose dey help farmers get fertiliser by using compost, since some places bandits no dey allow dem go outside village.
But e still tok say homegrown food na just support, e no fit reach evriwia.
On di oda hand, anoda expert wey sabi security mata for Kano, Dr Auwal Abdullahi, tok say Nigerian goment suppose try anoda way to fight insurgency.
E tell BBC Pidgin say for over 10 years, goment dey use force fight insurgents, but e suggest say make dem try dialogue.
"Make goment understand and work wit security pipo, community and gada intelligence.
For farming season, goment need to work wit community and if possible, negotiate wit bandits" im tok.
E say dis method work for Birnin Gwari local goment for Kaduna State.
Dr Abdullahi also tok say if dem use peaceful method to tok to bandits make dem drop arms and stop banditry, kidnapping and cattle rustling, farmers go fit go farm and e go help Nigeria economy grow.

Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

How di security palava Nigeria dey face fit affect food supply and price
How di security palava Nigeria dey face fit affect food supply and price

BBC News

time6 hours ago

  • BBC News

How di security palava Nigeria dey face fit affect food supply and price

As kasala dey increase for Nigeria, especially for northern part of di kontri, wia unknown gunmen, Boko Haram/ISWAP, bandits, herders and farmers dey clash, di place wey dem also sabi for big farming don dey face serious palava. As rainy season dey try reach im peak, farmers dey fear to go farm becos dem no wan risk dia life or make bandits kidnap dem. For recent weeks, kasala wey happun for North east, North west and North central don claim many lives and properties. Dis areas na places wey dey produce plenty food for Nigeria. Recently, Ministry of Agriculture for Nigeria release one internal memo wey tok say make dia staff fast for three days sake of food wahala for di kontri. Dis move show how serious di mata be. For 2024 alone, World Food Program report say kasala, insecurity, inflation and climate wahala go make hunger worse for Nigeria, and say 26.5 million pipo go face serious hunger. National Bureau of Statistics (NBS) tok say food inflation rate for October 2024 na 39.16% compared to 31.52% for October 2023. Experts believe say insecurity na one of di major reasons wey cause dis kain inflation. Experts still tok say goment need to do more to fight insurgency or find modern farming ways becos farmers for north dey fear to go farm. How security wahala fit affect food security and price dis year? Secretary of All Farmers Association of Nigeria (AFAN), Dr Yunusa Halidu, tell BBC Pidgin say insecurity na one of di reasons wey dey cause food wahala and food inflation. "Before dis insecurity wahala, many states for north dey farm plenty food, and food dey cheap for market," oga Halidu tok. "If no be for insecurity, Zamfara alone fit feed di whole kontri afta harvest." E believe say na insecurity cause di food inflation wey Nigeria dey face. "Lack of food na one of di reasons why food price rise for recent years, and na insecurity cause am. You know say di more pipo dey need sometin, di more di price go up," e tok. E mention say some northern states dey produce rice, wey Nigerians dey chop well-well, but rice and oda food production don reduce. "States like Borno, Yobe, Katsina, Zamfara, Sokoto and Kebbi sabi farm rice, but sake of insecurity, dem dey produce small rice now." Halidu add say "Na only Jigawa for all di northern states dey farm witout security wahala, sake say bandits no too dey dia." E still tok say if federal goment fit solve insecurity and provide farming support, Nigeria no go get food wahala and food go cheap for evribodi. Wetin be di solution? Dr Angarawai Ijantiku Ignatius wey sabi farming well-well and be Country Representative for International Crops Research Institute for Semi-Arid Tropics (ICRISAT) for Kano, tell BBC Pidgin say federal goment need to embraced and invest for modern farming. "But no mata di modern innovation, we still need land. But for small scale, we get wetin we dey call homegrown food. Pipo fit use bucket or cement bag put soil and plant yam, pepper or onion for house. E fit feed family of two or three." E tok say anoda modern way na make goment provide community-based place wey farmers fit plant and harvest. "We get new technology wey we dey call community-based farming programme, wia we go give farmers free training on di new method. How dem fit farm and harvest quick and distribute am for community," Dr Ignatius tok. "But for dis one, we need community vigilante to protect farmers." E also tok say dem suppose dey help farmers get fertiliser by using compost, since some places bandits no dey allow dem go outside village. But e still tok say homegrown food na just support, e no fit reach evriwia. On di oda hand, anoda expert wey sabi security mata for Kano, Dr Auwal Abdullahi, tok say Nigerian goment suppose try anoda way to fight insurgency. E tell BBC Pidgin say for over 10 years, goment dey use force fight insurgents, but e suggest say make dem try dialogue. "Make goment understand and work wit security pipo, community and gada intelligence. For farming season, goment need to work wit community and if possible, negotiate wit bandits" im tok. E say dis method work for Birnin Gwari local goment for Kaduna State. Dr Abdullahi also tok say if dem use peaceful method to tok to bandits make dem drop arms and stop banditry, kidnapping and cattle rustling, farmers go fit go farm and e go help Nigeria economy grow.

'Chill' sweeps housing market as troubling construction milestone flashes latest crash warning
'Chill' sweeps housing market as troubling construction milestone flashes latest crash warning

Daily Mail​

time10 hours ago

  • Daily Mail​

'Chill' sweeps housing market as troubling construction milestone flashes latest crash warning

A key indicator of the health of the housing market has plummeted to its lowest level in five years. Construction of single-family homes — like stand-alone houses — rose just 0.4 percent in May. Apartment and condo building starts dropped a staggering 30.4 percent. Overall, new-home building fell 4.6 percent from April to May, hitting the slowest pace since May 2020, during the height of the pandemic. The sharp slowdown comes as buyers pull back — worried about a possible recession or holding out in hopes that prices will drop. 'Builders are already adjusting their outlooks, and slowing the development pipeline which could mean that new homes are harder to come by in the next year,' economist Danielle Hale told Building permits, a sign of future construction, also fell 2 percent to 1.26 million from April to May, according to the government. New-home construction did grow in the West by 15.1 percent, but fell across the rest of the US. The biggest dip in new-home construction was in the Northeast, which saw a 40 percent drop. That's an alarming dip. 'Cracks are appearing in the housing market as negative homebuilder sentiment, elevated mortgage rates, and higher building costs due to tariffs weigh on activity,' said Matthew Martin, senior US economist at Oxford Economics. 'Building permits point to a slower pace of construction, while May retail sales data suggested home improvement spending is slowing.' He added that housing starts were far weaker than consensus expectations. 'The decline in permits was concentrated in single-family, signaling a trend rather than seasonal volatility,' said Martin. 'A truce between the US and China tariffs has done little to assuage homebuilder sentiment, and continued uncertainty will keep construction depressed this year.' As the demand for new construction is crashing, the number of existing homes sitting on the market for sale is growing. Buyers now have the upper hand in a shifting housing market The toxic mix of the slow construction, rising inventory levels and weak buyer demand have also resulted in homes sitting longer on the market. Some builders are also starting to lower home prices to lure buyers. 'Builders are operating in a very challenging environment and it showed up in the May construction data,' said Hale. Tariffs are also raising the cost of building materials and Donald Trump's immigration policy is causing labor shortages. Sellers are panicking as they are being forced to slash prices and offer buyers concessions. In early June, the overall US housing market underwent a dramatic reversal, landing in favor of buyers. Buyers now have the upper hand since they have a list of options in many different markets and are in a good place to negotiate a good price. This month, there are around 2 million homes are for sale across the country, but only about 1.5 million active homebuyers are looking. That 500,000 gap marks the largest imbalance ever recorded. At the same time the total value of homes on the market has hit a record-shattering $698 billion, up more than 20 percent from the same time last year. But with far fewer buyers in the game, sellers are being forced to slash prices. 'The balance of power in the US housing market has shifted toward buyers,' Redfin senior economist Asad Khan told 'But a lot of sellers have yet to see or accept the writing on the wall.' Meanwhile, the total value of homes on the market is now $698 billion, up 20.3 percent from a year ago, and a new record, according to Redfin. Too much inventory flooding the market is also slowing demand. The number of sellers is much higher than buyers, Redfin chief economist Daryl Fairweather told the Daily Mail. 'Right now there are nearly half a million more home sellers than buyers in the market, which means that prices will have to come down in order to lure enough buyers back into the market to match the number of sellers,' she said.

Afghanistan turns to Russia for some food supplies amid Iran-Israel war
Afghanistan turns to Russia for some food supplies amid Iran-Israel war

Reuters

timea day ago

  • Reuters

Afghanistan turns to Russia for some food supplies amid Iran-Israel war

Russia, June 20 (Reuters) - Afghanistan is in discussions with Russia to import certain foodstuffs as the conflict between Israel and Iran, one of its largest trading partners, risked cutting off supplies, its agriculture minister told Reuters. As relations between Russia and the Taliban government have been improving, an Afghan delegation is visiting Russia's main economic conference in St. Petersburg this week, meeting Russian agriculture officials. "Afghanistan is definitely aiming for self-sufficiency in its agricultural products. However, we still rely on some food items that come from Iran, and if problems arise there, it will undoubtedly have its effects," Ataullah Omari said on the sidelines of the conference. Iran supplies Afghanistan with some dairy products, among other commodities, and there is widespread concern the week-old war between Israel and Iran could disrupt trade flows Russia - the world's largest wheat exporter - and Kazakhstan are the main suppliers of wheat and flour to Afghanistan. Russia is also supplying sugar and vegetable oil. Omari said that the country is now seeking wheat rather than flour from Russia. Afghanistan, the top buyer of Russian flour in 2024, increased its own wheat production by 10% last year to 4.83 million metric tons. The country's total wheat consumption is estimated at 6.8 million metric tons a year. "For the past four years, since the withdrawal of the Americans, we have been making efforts to provide our essential food supplies ourselves. The remaining amount, including flour and wheat, is supplied annually by Russia," Omari said. "We have requested that Russia send us wheat instead of flour. Additionally, the import of other products that come from Russia to our country annually is progressing well," he added. In April, Russia lifted its ban on the Taliban, which it had designated as a terrorist organisation for more than two decades, paving the way for Moscow to normalise ties with Afghanistan's leadership. Since 2022, Afghanistan has imported gas, oil, and wheat from Russia, marking the first major economic deal after the Taliban returned to power, facing international isolation following 20 years of war against U.S.-led forces. Omari expressed concern about Afghan refugees living in Iran who could become victims of Israel's attacks. The UN Refugee Agency (UNHCR) estimates that nearly 4.5 million Afghan nationals reside in Iran. "Any kind of damage that occurs there is absolutely unsatisfactory for our nation and our people, especially for many of our refugees who live there and are our brothers," he said.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store