logo
All you need know about Jamb mop-up exam

All you need know about Jamb mop-up exam

BBC News23-06-2025
Di Joint Admissions and Matriculation Board don set Saturday, 28 June, to conduct di 2025 UTME mop-up examination.
UTME na entrance exams wey pipo wey dey find admission to enta Nigeria public and private universities dey write.
Jamb board bin don announce earlier say dem go conduct mop-up exam for candidates wey bin miss di UTME exam for April and di rescheduled UTME exam for May.
Dem tell di candidates wey miss di 2025 UTME to start to print dia registration slips from Monday, 23 June.
Di slip contain dia examination centres and di time of examination.
According to di exam join bodi na 96,838 candidates dem reschedule to sit for di mop-up exam for 183 centres across di kontri.
JAMB say di first session for di examination go start by 8 a.m West African time.
Wetin happun for di 2025 UTME?
Di Join body wey dey run Nigeria university-entrance exams bin admit say dem experience "technical glitch" wey affect some of di results for dis year tests, afta nearly 80% of students bin get low grades.
Students bin complain say dem bin no fit log in to di computers, questions no bin dey show and light wahala make am impossible to take di examinations.
Di low pass rate bin spark widespread outrage, especially afta one candidate take her own life.
Faith Opesusi Timileyin, 19, wey bin wan study microbiology for university, die afta she swallow poison, her family tok.
Her father and elder sister bin tell BBC say she bin write di exam for di second time and she get 146 marks out of 400, lower dan 193 wey she get di last year.
"Di pain make her take her own life," her father, Oluwafemi Opesusi, tell BBC Pidgin.
Generally 200 or above out of 400 dey enough to get a place for university for di exams wey Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) dey organize.
Only 400,000 out of di 1.9 million students bin achieve dat mark, na one of di worst performances in recent years.
Afta many pipo hala well- well, Jamb say dem go allow students for some areas to retake dia exams.
One student, Favour Eke, bin tell BBC say 10 of di165 questions no appear for di screen - all wey she see na multiple choice options for di answers.
"Dem tell us to omit di blank questions and kotinu di exam but e bin dey very hard to concentrate afta dat," she tok.
She bin also experience technical problems to get her results, e mean say e dey very unlikely for her to get into university dis year - wey be di third time she don take di exams.
She bin write di test for di capital, Abuja, wey no be one of di centres wia students bin retake dia exams, dis whole tin really spoil her mind.
Anoda student say she bin get trouble to log in to di computer bifor anoda pesin profile mysteriously appear for di screen, wey show different kwesions and den di machine briefly shut down completely.
"I bin no get answer to all di kwesions wen dem tell us say our time don end becos a lot of my time I bin waste am sake of those technical difficulties," im tok.
Di exam body bin apologise for di "painful damage" and "di trauma wey e bin subject affected Nigerians".
For press conference, JAMB registrar Ishaq Oloyede break down in tears as im apologise.
Im announce say almost 380,000 candidates for 157 bin dey affected centres dem from a total of 887, wey go able retake dia exams starting from Saturday.
Di zones wey dey most affected na Lagos and several states for south-east.
JAMB blame a failure of di computer system to upload exam responses by candidates in these areas during the first days of di exams.
E say na di "unusual level of public concerns and loud complaints" na im "prompt us to do an immediate audit or review". Ordinarily, dis no for happun for June, it said.
Di national exam, wey dem dey call Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME), na computer-based test wey be requirement for those wey wan join universities and oda tertiary institutions.
Di 2025 test, wey JAMB organize for March, bin dey marred by disruptions due to power outages in some areas.
Di head of di exams body earlier bin defended di poor results, e say say e reflect di "true academic abilities" of di students and na becos dem dey clamp down on cheating.
Many Nigerians on social media bin dey cal for accountability, with some seeking Oloyede'
resignation.
Opposition figure Peter Obi bin say while di admission of fault dey commendable,di issue wey dem raise "na very concerning issue on glitches and di grave havoc" for critical institutions.
Rights activist Rinu Oduala say na "incompetence. Na educational sabotage. Dem suppose arrest am immediately."
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

How much President Tinubu and ministers dey collect as salary - why dem wan review am?
How much President Tinubu and ministers dey collect as salary - why dem wan review am?

BBC News

time2 hours ago

  • BBC News

How much President Tinubu and ministers dey collect as salary - why dem wan review am?

Di reviewing of salaries of political office holders for Nigeria don dey gada plenty reactions for di kontri. Dis dey come afta di Revenue Mobilisation Allocation and Fiscal Commission (RMAFC) announce say dem don begin di process to review di current Revenue Allocation Formula between di federal, state and local governments. RMAFC Chairman Mohammmed Shehu during one presser for Abuja, Nigeria capital argue say di current salary wey politicians dey receive too small, unrealistic and outdated for di face of dia rising responsibilities and economic challenge. Oga Shehu say di current monthly salary of President Bola Tinubu na 1.5 million naira ($977), while dat of ministers dey earn less dan N1 million evri month. "You dey pay di President of di Federal Republic of Nigeria 1.5m naira a month, wit a population of ova 200 million pipo. You no fit pay minister less dan one million naira per month since 2008 and expect am to put im best and e no go involve for oda tins." Di chairmo argue say meanwhile, Central Bank of Nigeria govnor or di Director General dey collect 10 times more dan di salary wey di president dey collect. "E no dey not right. Or you pay am [di head of an agency] twenty times higher dan di Attorney-General of di Federation. E no dey right at all," Oga Shehu add. Oga Shehu disclose say di last time dem carry out comprehensive revenue allocation formula review na for 1992, and dem dey adjust am small-small through executive orders from 2002 to date. E say sake of dat dem wan review di current Revenue Allocation Formula (RAF) to ensure equity, fairness, and responsiveness to di changing social economic realities of di kontri. E describe di exercise as constitutional responsibility wey don become imperative in light of Nigeria evolving socio-economic and political landscape. As tori pipo ask if di commission go review di salary of civil servants too, di RMAFC boss say dia work dey strictly restricted to political office holders, govnors, senators, legislators, ministers, DGs, and oda pipo. "Time don reach wey pipo like you and odas suppose support di commission to come up wit reasonable living salaries for ministers, DGs, plus di President. Why RMAFC dey review di salary of politicians According to Oga Shehu, dem dey review di revenue allocation formular to produce a fair, just, and equitable revenue-sharing formula wey go reflect di current responsibilities, needs, and capacities of di three tiers of govments in line with di constitutional roles. "Di recent constitutional amendments, wey share responsibilities like power generation, railways, and correctional services to subnational govment don place financial and administrative burdens on dem. Dis situation don make am essential to re-evaluate di structure of fiscal federalism to foster economic growth and ensure sustainability," e tok. E add say under di current revenue allocation formula, di federal govment share na 52.6 per cent, 26.7 per cent for di state governments, and 20.6 per cent dey allocated to di local governments. Di committee also give one per cent each to di Federal Capital Territory, ecological fund, natural resources, plus di stabilisation fund under the vertical revenue allocation. Speaking further, e quote Paragraph 32 (b), Part I of di Third Schedule of di1999 Constitution of di Federal Republic of Nigeria (as amended), wey compulsory RMAFC to "review, from time to time, di revenue allocation formulae and principles in operation to ensure conformity wit changing realities". "In line wit dis constitutional responsibility and in response to di evolving socio-economic, political, and fiscal realities of our nation, di commission don reolve to initiate di process of reviewing di revenue allocation formula to reflect emerging socio-economic realities. Nigerians reaction Some Nigerians don react following di announcement of di RMAFC, while some question why di commission go wan add to di salary of politicians wey already dey live very lavish lifestyle while dia citizens dey suffer, and govment dey find am difficult to pay N70,000 minimum wage. Odas hail di initiative as ogbonge development.

Burkina Faso's junta expels top UN official over child rights report
Burkina Faso's junta expels top UN official over child rights report

BBC News

time2 hours ago

  • BBC News

Burkina Faso's junta expels top UN official over child rights report

Burkina Faso's junta has expelled the UN's top official to the West African nation over a report about children caught up in the jihadist Flore-Smereczniak was declared "persona non grata" because of her role in drafting the report that came out in a two-year period, the study detailed more than 2,000 cases of reported child recruitment, killings, sexual violence and abuse - blaming Islamist insurgents, government soldiers and civilian defence military government, which came to power in September 2022 and is led by Capt Ibrahim Traoré, said it had not been consulted by the UN, saying the report contained unfounded allegations. It did not cite any documentation "or court rulings to support the alleged cases of violations against children attributed to the valiant Burkinabé fighters", the government's statement 2015, jihadist rebels affiliated with al-Qaeda and the Islamic State group have waged an insurgency that has killed thousands of people and forced millions to flee their has prompted political instability, with two military coups in 2022. Capt Traoré took power promising to deal with the dire security situation within "two to three months". How an al-Qaeda offshoot became one of Africa's deadliest militant groupsWhy Burkina Faso's junta leader has captured hearts around the worldHow 'blood gold' is fuelling conflict in West Africa Ms Flore-Smereczniak was appointed in July 2024 - more than 18 months after her predecessor was Mauritius, she has worked in areas experiencing or recovering from conflict for more than two decades, holding posts in Ivory Coast, Chad and Malawi, according to the UN representative before her, Italian Barbara Manzi, was declared "persona non grata" by the junta in December 2022 not long after publishing a blog post describing how the crisis was affecting education and health services, forcing many to close UN has not yet officially commented on the latest expulsion, but the UN chief had expressed his regret over the decision to expel Ms Manzi whilst reiterating the UN's desire to engage with the junta to support Burkinabé have been concerns over the effectiveness of Capt Traoré's operation to quash the militants - with the junta rejecting the assistance of former colonial power France in favour of the first half of 2025, jihadist group JNIM said it had carried out over 280 attacks in Burkina Faso - double the number for the same period in 2024, according to data verified by the BBCRights groups have also accused the army of targeting civilians as well as suppressing political activity and the freedom of year, the military government announced it was extending junta rule for another five also said that Capt Traoré, who has built up the persona of a pan-Africanist leader, would be allowed to run for president in 2029. You may also be interested in: Burkina Faso outcry over 'conscription used to punish junta critics'Why 'pan-Africanist' influencers pushed rumours of a coupWhy France faces so much anger in West Africa Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica

Di ultimatum by Alaafin of Oyo na 'empty threat' – wetin dey cause kasala between Ooni of Ife and di Afaafin
Di ultimatum by Alaafin of Oyo na 'empty threat' – wetin dey cause kasala between Ooni of Ife and di Afaafin

BBC News

time3 hours ago

  • BBC News

Di ultimatum by Alaafin of Oyo na 'empty threat' – wetin dey cause kasala between Ooni of Ife and di Afaafin

Sometin dey happun between two ogbonge Yoruba monarchs for Southwest Nigeria. Dis na as tori come out say di Alaafin of Oyo give Ooni of Ife 48-hour ultimatum sake of one chieftaincy title matter wey don become controversial. Na dis one make di Alaafin para, den issue di ultimatum. But Moses Olafare, tok-tok pesin for Ooni of Ife, Oba Enitan Ogunwusi say dem no go ansa di Oyo King. Olafare, for Facebook post on Tuesday, say Oba Ogunwusi don particularly tell am to ignore di revered Oyo monarch. According to am, di Ooni no go respond to wetin e describe as "undignifyable" wit an official response. We dey update dis tori...

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store