logo
#

Latest news with #JAMB

WAEC explain why students write exam for night, toI sorry as parents react
WAEC explain why students write exam for night, toI sorry as parents react

BBC News

time29-05-2025

  • General
  • BBC News

WAEC explain why students write exam for night, toI sorry as parents react

Parents of students wey write di English Language paper 2 essay exam for di ongoing West Africa Examination Council WAEC examination late into di night on Wednesday 28 May, 2025 say dem no happy with dis development. Some of di ones wey tok to BBC Pidgin say dem dey sad say di children suffer like dat to write exam of an important paper like English language so late at night, for exam dem suppose don finish since afternoon. Joshua Rogers wey im daughter dey write di WAEC exam tell BBC Pidgin say na around 9:00pm late Wednesday night, e go pick her after she finish her paper. E say she tell am say na since 2pm in di afternoon dem finish di first paper wey be English Languahe paper 1 objective and dem come dey wait for di second paper but e no come till around 5:00pm in di evening. 'Di school wia she dey write di exam also try to give us parents information say dem dey wait for dI second paper but wen night reach na im me and my wife go her school go wait for her to finish so we go bring her back. No be good experience for a young pesin like dat. E dey too stressful," e tok. Rogers add say coming from di drama around di just concluded JAMB exams wey make di authorities organise anoda exam for some candidates to rewrite di exams, e feel say dis incident fit negatively affect di performance of di students for di exams as many of dem write di exam with tension so dem fit write am quick-quick so dem go go house as night don fall. "I get serious concern for di performance of di students for dis particular exams becos dem write am under tension, especially as you know say English paper na compulsory subject. You can imagine di stress wey students dey go through for exam time, kon be di one wey dem get to wait a very long time, way into di night. So some of dem write quick quick so dem fit go house and e fit affect dia results at di end." E also express concern for di safety of di children especially for di ones wey live very far from school. "E get one boy wey me and my wife get to carry go house becos e dey live very far from di school. My daughter school dey Ozuoba and dis boy dey live for Port Harcourt airport side, so you can imagine di distance, and e bin dey fear to go house by dat time of di night becos of how di area be. Thank God say e speak out. Wat of di children wey no get anybody to help dem and dem must go house dat late in di night? Goment must chook eye and ask question why dis one happen and take steps make e no happen again." 'Our students finish di exams 1:00am dis morning' For students wey write di WAEC exam for some of di riverine communities for Rivers State, di exam papers get to dem by 10:00pm. Andrew Peter wey im pikin write di WAEC exam for Community Secondary School CSS Ebukuma, Andoni LGA, say di exam paper reach dem by 10:00pm and di students finish di exams by 1:00am early morning of Thursday 29 May, 2025. "We really no know wetin happen. Na WAEC go explain but di exam paper reach here by 10pm last night. We get to go buy candles for di students to take write di exam becos for di whole of Ebukuma community, we no get light. Na around 1:00am dis morning na im dem finish di exam and dem get to come back again dis morning to write anoda paper. So e dey stressful for di students. Dem no suppose suffer like dat." E tok. WAEC explain why di English language paper 2 essay exam happen like dat Di West African Examinations Council (WAEC) for statement don apologise to students for di delay in di exams. Dem acknowledge say dem get some challenges during di conduct of WASSCE for School Candidate, 2025 wey include delay in di timely conduct of English Language Paper 2 dem write on Wednesday 28 May, 2025. For statement wey Moyosola Adesina, Acting Head of Public Affairs WAEC sign, dem say while dem maintain di integrity and security of di examination, dem face some challenges primarily due to dia major aim of preventing leakage of any paper. 'While we successfully achieve our objective, e impact di timeliness and seamless conduct of di examination. Despite our best efforts, we encounter logistical hurdles, security concerns and sociocultural factors wey negatively influence our operations.' In order to forestall future occurrences of dis nature, di Council say dem currently dey collaborate with security agencies as dem recognise di importance of timely conduct of examinations and di impact of dis decision on di candidates, dia schools and parents, and dem sincerely apologise for any inconvenience wey e cause.

Five tins wey happun for di 2025 UTME Jamb exam
Five tins wey happun for di 2025 UTME Jamb exam

BBC News

time15-05-2025

  • Politics
  • BBC News

Five tins wey happun for di 2025 UTME Jamb exam

Since di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) confam say true-true errors bin happun for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME), pipo still dey ask wetin really happun? Candidates bin write di examination across di kontri between Friday 25 April and end on 5 May. Wen Jamb release breakdown of how di 2025 results be, di examination body say dem record di lowest performance in di history of di Computer Based Test [CBT]. According to Jamb, na about 1,955,069 candidates bin write di 2025 UTME examination. Out of dat candidates, ova 50 per cent score below 200. Na only 4,756 candidates score 320 and above, while 12,414 candidates score 300 and above, according to Jamb analysis. "As part of di results, 40,247 underage candidates dey permitted to demonstrate dia exceptional abilities. Howeva, only 467 of dis candidates (1.16%) bin achieve scores wey meet di point for exceptional ability as defined for di UTME, wit dia performance for di subsequent three stages still pending," Jamb tok. Dis results bin no sweet di belle of candidates, dia parents and guardians, plus oda pipo wey dey concerned about education for Nigeria. Dem begin drag Jamb for social media, sotay pipo begin ask kwesions about why students dey underperform wey force di body to do dia review sharp-sharp. Jamb make promise say if dem chook eye for dis complaints and find out say errors bin dey, di candidates wey dey involved go rewrite di exam. Wetin be di technical errors wey happun According to Jamb some errors bin happun for some centres wey affect di performance of candidates during di exam. Jamb Registrar, Prof Ishaq Oloyede tok for media briefing for Abuja on Wednesday say "Wetin suppose be moment of joy don change due to one or two errors." Di Registrar announce say di technical error affect about 379,997 candidates. "We apologise and assure you say dis incident represent a significant setback for… we remain committed to emerge stronger in our core values of transparency, fairness and equity", Oloyede tok as e cry wen e address tori pipo. E add say na di function of di exam bodi to admit error sake of say dem sabi say inspite of dia efforts dem no dey perfect. Some of di errors wey happun include: According to one post wey di Educare Tech Team - di team wey chook eye for Jamb core system to check wetin bin happun during di exams share for social media, breakdown di errors. Dem say one of di "most critical discoveries" wey dem bin make during di session dey around three major systemic changes wey dem introduce for di 2025 UTME. Shift from traditional count based analysis: Jamb change from di traditional count-based analysis to a more robust source-based analysis of results. Dem explain say before-before, Jamb dey evaluate di integrity of examination sessions primarily by counting di number of responses wey dem submit per session. If di majority of candidates in a session of 250 bin submit a near-complete set of answers, di session dey valid. Any significant deviation go lead to disqualification of results from dat centre. However, for 2025, dem use a more advanced model—wey go focus on di actual source and logic of di answers dem provide, instead of just di quantity. Full-scale shuffling of both kwesions and answer options: Dis process na to make sure say if two candidates dey siddon for di same session dem no go get identical questions and answers. Dis na to improve di security of di test. Systemic improvements: Jamb do plenti systemic improvements wey go improve performance and reducing lag (dragging) during exam sessions. According to di document, dis na a major policy change wey bring di best and highest UTME score in 15 years. Dem say na dis technological improvements wey dey really good on paper, cause di major wahala during di implementation phase. "Di system patch necessary to support both shuffling and source-based validation bin dey fully deployed on di server cluster wey dey support di KAD (Kaduna) zone, but dem bin no apply am to di LAG (Lagos) cluster, wey dey service centres for Lagos and di South-East. Dis omission happun across all sessions until di 17th session, na later dem discover and korect di error." na wetin engineer James Nnanyelugo submit to di Educare team. Jamb also assure Nigerians say dis kain tin no go happun again as dem reschedule di exam for Friday 16th and Saturday 17th May, 2025 'Anoda pesin profile and kwesions appear for my screen' - Jamb candidate Some candidates wey be victims of dis technical errors share dia experience wit di BBC. Dem tell BBC wetin happun for di examination centres. "I bin log into almost three computers, but dem kontinu to reject my login, wen I finally get di chance to log in, before I go even read di questions, time don finish. For my centre na me be di only pesin wit dis issue. Wen I bin start to try ansa di questions, di computer just start to dey go on and off due to technical issues. I bin complain but dem tell me to manage am like dat, afta somtime my profile just disappear from di system and anoda pesin profile appear." Di candidate add say di questions of di oda pesin show for di screen too, afta somtime e kon go off completely. "Wen my computer go off, e no affect only me, e bin affect majority of di students dia. E bin take somtime before dey solve all di issues and evritin come dey stable again. At di end I no fit answer all di question wen dem tell us say our time don finish becos I waste plenti time sake of di technical difficulties wey I face." Di story no different from anoda female candidate wey tok say her computer begin go off and on wen she start to write di exam. "My computer go off like 3 times, den I realise say oda students bin dey also face di same issue. Di result of di exams shock us, some of us pass on an average, but we no get wetin we bin hope for. We bin study veri hard but den di technical issues from di computers affect our results." She tok. Hastags of #thisisnotmyresult bin dey trend as candidates use am express dia frustrations. We no go quantify di impact wey dis technical glitch get on candidates but we fit report say one candidate take her life afta she see har Jamb result.

'She drink rat poison' - Family of JAMB candidate wey take her life speak
'She drink rat poison' - Family of JAMB candidate wey take her life speak

BBC News

time15-05-2025

  • General
  • BBC News

'She drink rat poison' - Family of JAMB candidate wey take her life speak

"My daughter score high for last year Jamb exam, dis year dem give am 146. Na di pain make am drink rat poison". Dat na wetin Mr Opesusi Oluwafemi wey im daughter take her life after she find out say her Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB, result na 146 tok. 19 years old Faith Opesusi Timileyin been dey hope to study Microbiology for university but dat dream no fit come to pass again as she take shortly after she see her 2025 Jamb result. Faith na just one out of plenti young pipo wey write di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination - JAMB don since come out to admit say error dey for dis year exam wey record mass failure. JAMB results for recent years do show a decline in di percentage of pipo wey do well, but di 2025 own bad well-well. Out of 1.5 million candidates wey write di exam, over 50% score below 200, before di exam body chook eye again come see say glitches dey after many complains over irregularities from candidates and Nigerians for social media. Mr Opesusi tell BBC Pidgin say wetin dem release no be im daughter result, "kids of dis days dem dey feel bad. She bin dey devastated, as she see di result, she bin dey disappointed," na wetin her papa tok. According to di papa if to say she open up, we for know how to console or give her assurance say hope still dey. E say dem dey disappointed to find out say she take rat poison. Who be Faith Opesusi Her elder sister Opeyemi Opesusi describe her as pesin wey dey hardworking, humble and dey always tok her mind. "Wen she begin dey vomit and I ask her, she tell me say she take rat poison. Na for di hospital she leave me," na so her elder sister tok. According to her, di deceased bin get admission last year but due to distance, she no take di admission. She bin wan stay same school wit her oda sister. She say, "we bin dey eight for our family but now, we don become seven". Di family don bury di young girl for Ikorodu Lagos, but her papa, mama and family members still dey in shock over di incident as at press time. JAMB bin release apology to all affected students on Wednesday but dem never make any statement about di deceased. For statement on Wednesday, JAMB say true-true some kain tins dey wey affect di performance of students during di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME). JAMB oga Prof Ishaq Oloyede apologise to di affected students and Nigerians in front of tori pipo say im go take responsibility for di errors wey happen and promise say dem dey do everything to correct am. "Wetin suppose be moment of joy don change due to one or two errors," Oloyede tok. Di Registrar announce say about 379,997 candidates for di just concluded Jamb go retake di UTME exam. Dis follow many complaint of technical glitches, low scores, and alleged inconsistency for di question and answer during di exam. E add say na di function of di exam bodi to admit error sake of say dem sabi say in spite of dia efforts dem no dey perfect.

Jamb order review of 2025 UTME results, wetin be di fate of di candidates?
Jamb order review of 2025 UTME results, wetin be di fate of di candidates?

BBC News

time12-05-2025

  • Politics
  • BBC News

Jamb order review of 2025 UTME results, wetin be di fate of di candidates?

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don announce say dem dey review di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) results wey dem release recently. Di exam bodi for statement wey dia tok-tok pesin, Fabian Benjamin sign say di board dey fast forward dia annual system review. Di review na comprehensive post-mortem of di examination process, Fabian tok. Dis na sake of di high number of complaints wey follow di release of dis 2025 UTME results last Friday. "If e dey determined say indeed glitches dey, we go implement appropriate remedial measures promptly, as we dey do in case of di examinations demsefs," e add. Di statement add say di board dey particularly worry about di unusual complaints wey dey come out from some states within di Federation. Nigerians including some candidates bin enta social media to complain about di low scores wey dey recorded by some candidates wey don score highr for dia previous Jamb. Wit di use of #thisisnotmyresult, social media bin full of how dem express worry and call for review of di results. Jamb wen dem release di results bin tok say about 1.5 million candidates perform below 200 dis figures na one of di lowest in recent times. Wetin dis mean be say dis year, na about 80 per cent of candidates wey bin siddon write dis 2025 UTME score less dan 200 points out of 400 points wey be di maximum wey a candidate fit get Each candidate bin take four subjects, wit each one carrying grade of 100 points. We dey update dis tori

JAMB release 2025 UTME result, how to check am
JAMB release 2025 UTME result, how to check am

BBC News

time09-05-2025

  • General
  • BBC News

JAMB release 2025 UTME result, how to check am

Di Joint Admissions and Matriculation Board (Jamb) don release di result for di 2025 Unified Tertiary Matriculation Examination early mor-mor on Friday, May 9, 2025. Candidates wey seat for di exam go fit begin check dia result. Jamb bin tok say about 1.5 million candidates perform below 200 dis figures na one of di lowest in recent times. According to di analysis, na only 4,756 candidates score 320 and above, and anoda 12,414 candidates score 300 and above. Now wey di exam board don officially release candidates result, dem fit check dia score through dis method. How to check your JAMB result? Once JAMB officially release di results candidates fit check dia score through dis method. SMS method: Send "RESULT" to 55019 or 66019 wit di phone number you use to register. You go receive SMS wit your score details. Candidates no need to go any CBT centre or cybercafé to check results. Di results wey dem still dey process and di ones wey dey absent go receive message like "under processing" and "absent" respectively. Those wey dey under investigation go receive:

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store