logo
NiMet strike: Why airports dey depend on meteorological agencies?

NiMet strike: Why airports dey depend on meteorological agencies?

BBC News25-04-2025
Nigeria airports see kasala after di country meteorological agency NiMet go on strike over unpaid wages.
Flight delays and cancellations happen for Lagos, Abuja and Kano airports.
Workers from NiMet march for di street of Lagos, wit placards wey read: "No weather, no flight; fly at your own risk."
While one airline, United Nigeria Airlines, say dem bin dey find alternative sources for weather information, anoda airline, Air Peace, bin announce di suspension of all flight operations on Thursday.
Di strike now don dey called off for two weeks after Nigeria Minister of Aviation and Aerospace Development Festus Keyamo meet with NiMet unions on Thursday.
Dis na three key reasons why meteorology dey important to aviation:
Safety
While e dey safe to fly inside bad weather, meteorological agencies fit alert pilots to any significant weather hazards, like thunderstorms, icing or low visibility caused by low clouds or fog.
Turbulence for flight dey very common, however thunderstorms fit make am more serious, putting passengers safety at risk.
While turbulence dey highly unlikely to make plane crash, e dey known to cause severe injuries to passengers – and even death.
Aviation forecasts fit also identify areas of Clear Air Turbulence (CAT), wey be wen temperature change create different wind speeds and direction.
Pilots fit use dis weather information to den fly around areas of turbulence to minimise any danger or to cancel flight altogether.
For Nigeria, heavy rainfall and thunderstorms dey more common at certain times of di year – e make weather information all modire important.
"Any time you get widespread thunderstorm outbreak, e fit dey dangerous," George Delanjian, one aviation meteorologist based in US tok.
"Lightening fit strike di aircraft and serious turbulence fit happen. In most cases, meteorologists know wen and wia thunderstorms go happen."
Weather information dey also become more important for flight safety, sake of say some studies show say instances of serious turbulence dey increase, wey fit be due to climate change.
Efficiency
Information about di weather dey crucial for pilots wey dey prepare a flight plan. Di temperature, humidity, pressure and wind fit impact di ability to maintain a safe flying altitude and di ability to reach di destination with enough fuel.
Information about jet streams – wey be strong bands of winds – fit help di plane to arrive more quickly at im destination. Flight plan fit also include alternate airports wey di plane fit divert too if change in weather conditions happen.
"Meteorological agencies go provide information to airport as part of Meteorological Aerodrome Report [METAR] - wey be hourly reports wey show di current weather and Terminal Aerodrome Forecast [TAF] - wey give di forecast throughout di day," Simon King, BBC meteorologist tok.
"Any pilot absolutely suppose get am to plan dia flights. For example, if di weather for di airport wia plane dey due to land no dey favourable, pilots fit dey aware of oda airports to divert to - while making sure say enough fuel dey to do so."
So, weather reports no dey just about safety, dem dey also help airlines to save time, fuel and money.
Ground operations
Weather information dey just as important on di ground as e dey for di pilots in di sky. Meteorological agencies provide airports with information wey dey prepare dem for conditions wey fit affect di runway visibility and di ability to take off and land safely. In particular, pilots go dey look di forecasts for di speed and direction of di wind. Dis go affect di runway di pilot go use.
Weather information fit also help make decisions on de-icing procedures, di loading and unloading of aircraft and re-fuelling.
"If thunderstorm dey, planes no dey allowed to refuel in case of lightening," King add.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Places wey Lagos state govment warn pipo to move from sake of flood
Places wey Lagos state govment warn pipo to move from sake of flood

BBC News

time7 days ago

  • BBC News

Places wey Lagos state govment warn pipo to move from sake of flood

Lagos state govment don warn residents wey dey stay for flood prone areas make dem move to higher grounds, say more floods dey expected sake of di raining season. Di state Commissioner for Environment Tokunbo Wahab on Tuesday while e dey speak wit Channels Television list some of di low-lying areas wey flood fit hit any moment and tell di communities to act sharp sharp to avoid disaster as di rains still dey come. Dis dey come as flood hit some parts of Lagos on Monday, 5 August, afta one all night rainfall across di state and neighboring states. Some pipo wey dey affected by di floods enta social media to post videos of di houses and property wey di flood affect. For one of di videos, one woman dey use bucket pack water comot from her sitting room. For anoda video, di flood grow reach half of di houses of di victims. Di videos also show cars and streets wey floods take over completely. According to di commissioner, govment dey try dia best to ensure say di effect of di floods no go dey too harsh, say dem dey open up gutters and gullies. Di commissioner mention areas wey dey at risk as: E say areas like Epe, Mushin and Ikeja dey safe for now. States wey rain and flood go affect according to Nimet Meanwhile, di National Flood Early Warning Systems Centre for Federal Ministry of Environment Nigeria on Tuesday bin forecast say five days heavy rainfall go hapun and fit trigger flooding for 19 states and 76 locations for di country. Di states include Akwa Ibom, Bauchi, Ebonyi, Cross River, Nasarawa, Benue, Kaduna, Taraba, Katsina, Kebbi, Kano, Borno, Plateau, Niger, Jigawa, Yobe, Zamfara, Sakoto and Gombe Nigeria Meteorological Agency Nimet bin send out rain and flood warning to some states of di country and mention say Lagos go witness more rainfall dan wetin hapun for 2023. According to Nimet, states wey go witness heavy rainfall include Lagos, Delta, Bayelsa, Cross River, Rivers and Akwa Ibom states. Dem say di rains go last between 250 to 290 days. Nimet say Ogun, Oyo, Ekiti, Osun, Ebonyi, Anambra and Enugu go experience 200 to 250 days of rainfall. For northern Nigeria, di rains go last between 110 to 150 days for Sokoto, Katsina, Zamfara, Kano, Jigawa, Yobe and Borno states.

Abercynon railway track damaged in heat as disruption continues
Abercynon railway track damaged in heat as disruption continues

BBC News

time13-07-2025

  • BBC News

Abercynon railway track damaged in heat as disruption continues

Train travel disruption has continued for a second day after the scorching weather damaged parts of a rail replacement services have been laid on between Pontypridd, Aberdare and Merthyr Tydfil due to a track defect at Abercynon, Rhondda Cynon for Wales advised passengers on Sunday to check their journey before travelling after services were stopped due to heat damage on recorded its hottest day of the year as Bute Park in Cardiff reached 33.1C on Saturday, while Friday saw a high of 32.7C in Usk, Health Wales has urged "people to take steps to stay well in the heat". Jenifer Baxter, boss of Industry Wales, a Welsh government-owned organisation which advises on the development of economic policy and planning, said the effects of climate change were a "new experience for everybody who's living and working with infrastructure in the UK, so we have to kind of build into that slowly".She told BBC Radio Wales' Sunday Supplement: "That kind of comes back to the issue around maintenance [like] which parts of the railway system do we need to change?"Which parts of the trains do we need to change in order to manage that resilience to the ever-changing climate?" Ms Baxter said "adaptation to climate change" was a "really big part of the work" of the National Infrastructure Commission for Wales, an independent advisory body that gives recommendations on Wales' infrastructure she said there was added complications as most of Wales' rail infrastructure was not a devolved issue, meaning decisions on investment were not made in after cancelled trains caused disruption to fans travelling to Cardiff to see the Stereophonics perform on Saturday, she added: "There are things that we can't do anything about. The reaction of metal to extreme heat is one of those areas, and there are other countries around Europe who have managed to come up with ways to solve these problems." How to stay cool in the heat Meanwhile, Public Health Wales issued guidance on Sunday "urging people to take steps to stay well in the heat".People are advised to drink plenty of water and wear sun cream, loose clothing and a hat. Other tips include:Avoiding alcohol, caffeine and hot and sugary drinks which can cause dehydrationClosing blinds and curtains on windows when in direct sunlightUsing an electrical fan to help cool space if temperatures are below 35°C "Hot weather is a particular risk to children, older people and those with pre-existing health conditions," warned Dr Giri Shankar, director of health protection."It's important that we look out for our family, friends and neighbours while temperatures stay high."

NiMet strike: Why airports dey depend on meteorological agencies?
NiMet strike: Why airports dey depend on meteorological agencies?

BBC News

time25-04-2025

  • BBC News

NiMet strike: Why airports dey depend on meteorological agencies?

Nigeria airports see kasala after di country meteorological agency NiMet go on strike over unpaid wages. Flight delays and cancellations happen for Lagos, Abuja and Kano airports. Workers from NiMet march for di street of Lagos, wit placards wey read: "No weather, no flight; fly at your own risk." While one airline, United Nigeria Airlines, say dem bin dey find alternative sources for weather information, anoda airline, Air Peace, bin announce di suspension of all flight operations on Thursday. Di strike now don dey called off for two weeks after Nigeria Minister of Aviation and Aerospace Development Festus Keyamo meet with NiMet unions on Thursday. Dis na three key reasons why meteorology dey important to aviation: Safety While e dey safe to fly inside bad weather, meteorological agencies fit alert pilots to any significant weather hazards, like thunderstorms, icing or low visibility caused by low clouds or fog. Turbulence for flight dey very common, however thunderstorms fit make am more serious, putting passengers safety at risk. While turbulence dey highly unlikely to make plane crash, e dey known to cause severe injuries to passengers – and even death. Aviation forecasts fit also identify areas of Clear Air Turbulence (CAT), wey be wen temperature change create different wind speeds and direction. Pilots fit use dis weather information to den fly around areas of turbulence to minimise any danger or to cancel flight altogether. For Nigeria, heavy rainfall and thunderstorms dey more common at certain times of di year – e make weather information all modire important. "Any time you get widespread thunderstorm outbreak, e fit dey dangerous," George Delanjian, one aviation meteorologist based in US tok. "Lightening fit strike di aircraft and serious turbulence fit happen. In most cases, meteorologists know wen and wia thunderstorms go happen." Weather information dey also become more important for flight safety, sake of say some studies show say instances of serious turbulence dey increase, wey fit be due to climate change. Efficiency Information about di weather dey crucial for pilots wey dey prepare a flight plan. Di temperature, humidity, pressure and wind fit impact di ability to maintain a safe flying altitude and di ability to reach di destination with enough fuel. Information about jet streams – wey be strong bands of winds – fit help di plane to arrive more quickly at im destination. Flight plan fit also include alternate airports wey di plane fit divert too if change in weather conditions happen. "Meteorological agencies go provide information to airport as part of Meteorological Aerodrome Report [METAR] - wey be hourly reports wey show di current weather and Terminal Aerodrome Forecast [TAF] - wey give di forecast throughout di day," Simon King, BBC meteorologist tok. "Any pilot absolutely suppose get am to plan dia flights. For example, if di weather for di airport wia plane dey due to land no dey favourable, pilots fit dey aware of oda airports to divert to - while making sure say enough fuel dey to do so." So, weather reports no dey just about safety, dem dey also help airlines to save time, fuel and money. Ground operations Weather information dey just as important on di ground as e dey for di pilots in di sky. Meteorological agencies provide airports with information wey dey prepare dem for conditions wey fit affect di runway visibility and di ability to take off and land safely. In particular, pilots go dey look di forecasts for di speed and direction of di wind. Dis go affect di runway di pilot go use. Weather information fit also help make decisions on de-icing procedures, di loading and unloading of aircraft and re-fuelling. "If thunderstorm dey, planes no dey allowed to refuel in case of lightening," King add.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store