logo
Life and Times of Former Nigerian leader Muhammadu Buhari wey die for di age of 82

Life and Times of Former Nigerian leader Muhammadu Buhari wey die for di age of 82

BBC News13-07-2025
Nigeria President Muhammadu Buhari, wey die at di age 82 na one former military ruler and self-styled converted democrat wey return to power through elections but struggle to convince Nigerians say e fit deliver on di change e promise.
E no be natural politician, pipo see am as pesin wey dey difficult and pesin wey no send anybody.
But e get reputation for personal honesty – one rare character of a politician for Nigeria.
Afta three failed attempts, Buhari bin achieve ogbonge historic victory for 2015, as e become di kontri first opposition candidate to defeat incumbent. For 2019, e dey re-elected for anoda four-year term.
Buhari bin always dey popular among di poor pipo wey dey north (wey dey known as di "talakawa" for Hausa language) but for di 2015 campaign, e bin get di advantage of one united opposition wey tanda strong for im side.
Many of those wey support am bin reason say im military background and disciplinarian credentials na wetin di kontri need to handle di Islamist insurgency for di north. Buhari also bin promise to tackle corruption and nepotism for govment and create employment opportunities for young Nigerians.
But im time for office bin happun di same time wen di prices of oil fall globally, and di time wen di kontri bin experience di worst economic crisis in decades.
Im administration bin also come under fire sake of di way e take handle insecurity. While campaigning, e bin promise to defeat di Islamist militant group Boko Haram. But di group continue to be threat and one of dia factions now dey affiliated to di so-called Islamic State group.
Di deadly clashes between farmers and ethnic Fulani herders for central Nigeria bin also rise well-well during im administration. Pipo accuse Oga Buhari, wey be Fulani, say e no dey tough enough on di herders and e no do enough to stop di crisis.
Di activities of so-called bandits for di north-western part of di kontri bin see di abduction of hundreds of secondary school students.
Under im watch, armed forces chop of human rights abuses - like opening fire on anti-police brutality protesters for di Lekki tollgate for Lagos for October 2020.
Who be Muhammadu Buhari?
Dem born Muhammadu Buhari for December 1942 for Daura for Katsina state for di far north of Nigeria, near di border wit Niger.
At di time, na British dey control Nigeria, and e go be anoda 18 years bifor di kontri gain independence.
Buhari father, wey die wen e be four, na Fulani, while im mother, wey raise am na Kanuri.
For one 2012 interview, Buhari bin tok say im be im papa 23rd child and im mother 13th. E say im only recollection of im father na wen two of dem plus one of im half-brothers bin fall from di back of a horse.
Di young Buhari attend primary school for Daura and then boarding school for di city of Katsina.
Afta e comot school, dem admit am to di Nigerian Military Training College, e join di Nigerian army shortly afta independence.
Buhari do officer training for UK from 1962-1963 and then begin im steady climb up di ranks.
In later years, Buhari bin attribute im disciplinarian to di years wey e spend for boarding school, wia corporal punishment na normal tin, and for di military. E dey "lucky" to experience dat kain tough environments, wey teach am to work hard, e tok.
For 1966, one military coup and then counter-coup happun for Nigeria - na time of confusion for army officers but Buhari bin always maintain say im be junior and no fit play any significant role for di coup.
Less dan 10 years later, under one military government, Buhari don rise to become military govnor of di north-east, one area wey no pass six states then.
Afta less dan one year, dem promote Buhari, now for im mid-30s again to federal commissioner for petroleum and natural resources (in effect oil minister) for 1976 under Olusegun Obasanjo for im first term as Nigerian head of state.
Indiscipline and corruption
By 1978, Buhari, then don become colonel, bin return to be military commander. Im tough stance in 1983 - wen Chadian sojas bin take ova some Nigerian islands for Lake Chad - still dey remembered for di north-east, afta e blockade di area and pursue di invaders.
Di end of 1983 bin see anoda coup, against elected President Shehu Shagari, and Buhari, wey now be major-general, become di kontri military ruler.
According to im own account, e no dey part of those wey plot di coup, but dem install am (and subsequently discarded) by those wey hold di real power and need figurehead.
Oda accounts suggest say e play more active role in removing Shagari pass wetin e dey willing to admit.
Buhari bin rule for 20 months, period pipo remember for campaign against indiscipline and corruption, as well as for human rights abuses.
Dem jail about 500 politicians, officials and businessmen as part of one campaign against waste and corruption.
Some see dis as heavy-handed repression of military rule. Odas remember am as a praiseworthy attempt to fight di endemic corruption wey dey hold back Nigeria development.
Buhari retain one rare reputation for honesty among Nigeria politicians, both military and civilian, largely bicos of dis campaign.
As part of im "war against indiscipline", e bin order Nigerians to form neat queues for bus stops, under di sharp eyes sojas wey carry cain.
Civil servants wey resume late for work bin dey publicly humiliated as sojas force dem to do frog jumps.
Some of im measures fit dey seen as merely eccentric. But odas bin dey genuinely oppressive, like one decree to restrict press freedom, under which dem jail journalists.
Buhari government also lock up Nigeria greatest musical hero, Fela Kuti – wey be thorn for di side of successive leaders – fake charges wey relate to currency exports.
Buhari attempt to re-balance di public finances by reducing imports bin lead to many job losses plus di closure of businesses.
As part of im anti-corruption measures, e also order say make dem change di currency – dem change di colour of di naira notes – and force everybody wey get di old notes to exchange dem for banks within a limited period.
Prices bin rise while living standards fall, and for August 1985, dem remove Buhari from office and imprison am for 40 months. Army chief Gen Ibrahim Babangida bin take ova.
Historic election victory
Afta dem release am and, e say, aft aim don see di consequences of di break-up of di Soviet Union, Buhari bin decide to join party politics, now convinced of di virtues of multiparty democracy and free and fair elections.
Despite dis, Buhari dey always defend di 1983 coup, e tok for 2005: "Di military come in wen e dey absolutely necessary and di pipo wey dey elected fail di kontri."
E also reject accusations say im measures against journalists plus odas bin go too far, e insist say im only dey apply di laws wey odas dey break.
Dem elect am as president for 2015, e become di first opposition candidate to defeat an incumbent since di return of multiparty democracy for 1999.
As president, Buhari bin make a virtue of im "incorruptibility", as e declare im relatively modest wealth and e say e bin "reject several past opportunities" to enrich himself.
By nature, e dey tok slowly, wey sometimes dey play well for for di media and sometimes badly.
Although few pipo doubt im personal commitment to fighting corruption and plenty notable scalps dey ground. Some question weda di structures wey dey enable mismanagement bin dey really reformed.
And attempts to improve youth employment prospects, at best, na work in progress.
'Bag of rice'
On di day Buhari comot office, dem ask some Nigerians for one video wey bin go viral on social media, wetin dem go remember most about im time for office, and all respondents tok di same thing: 'Bag of rice'.
Di reason dey simple - rice na di most common food for di kontri.
A standard 50kg (110lb) bag of rice, wey fit help feed a household of between eight and 10 for about one month, cost just 7,500 naira ($5; £3) under President Goodluck Jonathan, wey Buhari defeat for 2015, but e go up to 60,000 naira few years afta.
Dis bin lead to hunger for many parts of di kontri.
Di huge increase for di price of rice na sake of say e ban di importation of rice to encourage more Nigerian farmers to grow di crop.
However, local producers no fit meet di high demand and many of im supporters bin lost dia faith in him.
Ismail Danyaro, one resident of di northern city of Kano, bin tok say im support Buhari since e first contest di presidency for 2003.
"I dey buy 50kg bag of rice under Goodluck [Jonathan] but wen Buhari cme, I find am difficult to buy even 25kg bag of rice bicos e dey so expensive," e tell BBC.
At one point, even Buhari wife bin threaten say she no go support im re-election bid.
'Baba go slow'
Nigerians love nicknames and some of di kontri leaders nicknames bin stick even long afta e comot office.
For example, Nigerians still dey call former military leader Ibrahim Badamasi Babangida "Maradona" for wetin pipo see as im tactical dribbles on issues and situations.
For Buhari, na "Baba [Father] go slow" afta e take am six months to name im first cabinet afta e enta office for 2015.
Reacting to im nickname years later, Buhari say no be im fault say e take so long to get anything done.
"Yes, we dey slow bicos di system dey slow. No be Baba dey slow but na di system, so I dey go by dis system and I hope we go make am," e tok for 2018.
Nigerian politics for 2022-2023 na still one of d most interesting for di kontri democratic history.
For di minds of many, na di first time wey a sitting president wasn't ro go dey really bothered about who go be im successor.
Openly, Buhari bin declare say im go support whoever win im party (All Progressives Congress) nomination but insiders say behind di scenes, e no wetin im dey do.
Buhari body language bin show say e dey in support of all di five candidates wey dey find di APC endorsement. Dia supporters bin dey go round wit di tok say dem get im backing.
At one point, e bin look like say Buhari oppose di candidacy of im eventual successor, Bola Tinubu.
Wetin follow na di declaration of di "naira swap policy" wey di Buhari administration announce, plus oda tins, go reduce di influence of money for di 2023 elections.
Many Nigerians believe say di policy bin dey targeted to stop Tinubu from becoming president even though na im dem choose as di APC candidate.
Di policy bin involve di confiscation of trillions of old naira notes and dia replacement wit new notes for di highest denominations.
However, plenty new notes no dey wey lead to shortages and suffering by millions, particularly di less privileged wey dey rely on cash for dia daily transactions.
Dem only suspend di policy afta one Supreme Court ruling, just days bifor di election.
Tinubu win narrowly, wit 37% of votes cast, as di opposition bin dey divided.
Any assessment of Buhari presidency must take account im declining health, wey cause am to take significant absences from work, especially during im first term.
Di former military ruler fit don reinvent himself as a democrat but commitment to transparency concerning im own health bin dey coded, as Nigerians no dey informed about di fitness of dia head of state for office.
Muhammadu Buhari marry two times, first to Safinatu Yusuf from 1971-1988, and then for 1989 to Aisha Halilu, wey survive am. E get 10 children.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Major survey reveals 'standout' view on 'Scottish visa'
Major survey reveals 'standout' view on 'Scottish visa'

The Herald Scotland

time4 hours ago

  • The Herald Scotland

Major survey reveals 'standout' view on 'Scottish visa'

The latest Understanding Business survey, conducted by 56° North and Diffley Partnership, found 70% of companies are supportive of a Scottish visa to allow some migrants to come to work in Scotland, as long as they live in the country and maintain a Scottish tax code. A slightly smaller number, 68%, believe migration is vital for filling critical skills shortages in Scotland and that the Scottish Government should have power to control the migration of workers. However, respondents to the survey were conscious of the impact of migration on the local workforce, and the need for joined-up thinking on devolution of migration and UK-wide immigration policy. Scottish businesses groups, notably those representing the hospitality and tourism sectors, have regularly voiced concern over skills shortages since Brexit, which ended the free movement of people between the UK and countries within the European Union. There have been calls by the [[Scottish Government]] in recent years for the introduction of a Scottish immigration visa system to help attract workers to Scotland, but they have been resisted by the UK Government, which controls immigration policy. However, it appears the issue is not going away. The latest Understanding Business survey suggests Scottish employers are interested in a more flexible, regionally responsive immigration policy, particularly in light of workforce shortages and general economic pressures. The proposed visa would be designed to meet the needs of the Scottish labour market and population requirements which can differ from those in other parts of the UK. Only 17% of respondents said they opposed the idea of a Scottish visa, while the remaining 14% were neutral or unsure. The survey authors said the relatively low level of opposition suggests there is broad recognition among employers of the economic and demographic benefits of such a scheme. The proposed Scottish visa would allow migrants to work and pay tax in Scotland, while being required to live in the country. This would reflect immigration models used in countries such as Canada and Australia. The support shown towards a Scottish visa came as businesses indicated a degree of confidence about the economic outlook. A plurality of expect turnover (47%) and profitability (44%) to increase over the next 12 months, record highs for the survey series, followed closely by those that think their turnover or profitability will remain the same in the next year, at 41% and 39%. Around half (48%) believe general economic conditions are worse than a year ago, and 41% expect that conditions will continue to deteriorate over the next year. But a growing proportion expressed the view that the general economy is better now than a year ago (30%) or will improve over the next year (35%), up seven and 10 percentage points respectively. Well over half of Scottish businesses said they were more concerned about tax (56%) and inflation (55%) than they were three months ago, although these proportions witnessed small declines of three and four percentage points respectively. Meanwhile, there were encouraging findings for government ministers who are often accused of being out of touch with business. More businesses agreed that the Scottish and UK Governments are concerned with the needs of Scottish business and taking action to address them. Agreement that the UK Government is concerned with the needs of Scottish business is 'notably lower' compared with the perception of the Scottish Government on this front, at two in five (40%) compared to over half (53%). However, both have risen considerably since the last survey wave, up seven and five percentage points. A smaller gap was apparent when considering if both governments are taking action to address Scottish business concerns. Mark Diffley, founder and director at Diffley Partnership said: 'The standout data point this quarter is the significant business support for the introduction of a Scottish visa for workers, backed by seven in 10 business, up to 75% of those with an opinion either way on the issues. 'Combined with other positive views about the impact of migration on the labour force and the economy, this should give political parties food for thought ahead of next year's election. 'Meanwhile, although the business community in Scotland is still rather more pessimistic than optimistic, the gap between the two has closed which gives some hope about the possibility of a more positive outlook ahead after a long, tough period for businesses.' John Penman, managing partner at 56° North said: 'Our last survey showed Reform, which is the most vocal party in terms of restricting immigration, were gaining support among business in Scotland, however these results show that many businesses are in favour of bringing skilled migrants into the Scottish workforce. 'Reform's continued strong showing in the polls may well mean this becomes a recurring theme in the run up to next year's Scottish election as parties seek to position themselves as best for economic growth.' Understanding Business surveyed more than 500 Scottish businesses across a range of sectors, including hospitality, agriculture, construction, and manufacturing.

Jack Draper withdraws from US Open warm-up tournaments with arm injury
Jack Draper withdraws from US Open warm-up tournaments with arm injury

The Independent

time17 hours ago

  • The Independent

Jack Draper withdraws from US Open warm-up tournaments with arm injury

From reproductive rights to climate change to Big Tech, The Independent is on the ground when the story is developing. Whether it's investigating the financials of Elon Musk's pro-Trump PAC or producing our latest documentary, 'The A Word', which shines a light on the American women fighting for reproductive rights, we know how important it is to parse out the facts from the messaging. At such a critical moment in US history, we need reporters on the ground. Your donation allows us to keep sending journalists to speak to both sides of the story. The Independent is trusted by Americans across the entire political spectrum. And unlike many other quality news outlets, we choose not to lock Americans out of our reporting and analysis with paywalls. We believe quality journalism should be available to everyone, paid for by those who can afford it. Your support makes all the difference.

Nigeria Senate describe reports of approving creation of 31 new states as fake news
Nigeria Senate describe reports of approving creation of 31 new states as fake news

BBC News

time20 hours ago

  • BBC News

Nigeria Senate describe reports of approving creation of 31 new states as fake news

Nigeria National Assembly don describe tori wey dey spread say lawmakers don approve di creation of 31 new states for Nigeria as fake news. Tok-tok pesin for di Senate, Yemi Adaramodu tell BBC News Pidgin say di "National Assembly alone no fit create states for Nigeria, plus di proposal go pass through various stages of constitutional amendments, wey include further public hearings". Di proposal for state creation must also get di approval of two-third majority of di number of states houses of assembly. "Na thorough process," senator Adaramodu add. BBC News Pidgin seek oga Adaramodu response afta we spot tori wey pipo don share plenty times on WhatsApp wia dem claim say di Senate don give green light for di creation of di 31 new states. Na for February 2025, di House of Representatives committee on constitutional review tok say dem receive proposals for di creation of 31 new states for di federation. Chairman of di committee, Benjamin Kalu propose say make dem create six new states for North Central, four for North East, five for North West, five for South East, four for South-South and seven for South West. If di National Assembly approve dis proposal, Nigeria go get 67 wey go big pass di 50 states wey America get. Wen di process go conclude neva dey clear, as senator Adaramodu tok say na long process wey involve various stages of constitutional amendments. Wetin Nigeria constitution tok on state creation Section eight of di Nigeria constitution make provision for how to create a new state for di kontri. First, di request for new state go dey supported by at least two-thirds majority of members wey dey represent di area demanding di new State for di National Assembly (both Senate and House of Reps), di State House of Assembly of di area, and di local goment councils of di area. Den di proposal for creation of state go enta referendum - voting - wia at least two-thirds majority of di people for di area go vote in support or against di demand for creation of di State. Afta dat, di result of di referendum go dey approved by a simple majority of all di states of di federation supported by a simple majority of members of State Houses of Assembly. Di last step na for di proposal to dey approved by a resolution passed by two-thirds majority of members of each of di Senate and House of Representatives. Breakdown of di proposed states NORTH-CENTRAL BENUE ALA STATE from Benue State. OKUN STATE from Kogi State OKURA STATE from Kogi State CONFLUENCE STATE from Kogi State APA-AGBA STATE from Benue South Senatorial District APA STATE from Benue State. A 37th state, wey dem go name FEDERAL CAPITAL TERRITORY, ABUJA NORTH-EAST AMANA STATE from Adamawa State. KATAGUM STATE from Bauchi State. SAVANNAH STATE from Borno State. MURI STATE from Taraba State. NORTH-WEST NEW KADUNA STATE and GURARA STATE from Kaduna State. TIGA STATE from Kano State. KAINJI STATE from Kebbi State. GHARI STATE from Kano State SOUTH-EAST ETITI STATE go be di sixth state for di South East geopolitical zone. ADADA STATE from Enugu State. URASHI STATE from South East geopolitical zone. ORLU STATE from di South Eastern Region of Nigeria. ABA STATE from the South Eastern Region of Nigeria. SOUTH-SOUTH OGOJA STATE from Cross River State. WARRI STATE from Delta State. BORI STATE from Rivers State. OBOLO STATE from Rivers and Akwa Ibom States. SOUTH-WEST TORU-EBE STATE from Delta, Edo, and Ondo States. IBADAN STATE from Oyo State. LAGOON STATE from Lagos State. IJEBU STATE from Ogun State. OKE-OGUN from Ogun State IFE-IJESHA from Oyo, and Osun states. Nigeria need more states? Di simple answer na "no we no need more states", according to Dr Bello Maisudan, a lecturer for di Department of Political Science for Bayero University, Kano. Oga Maisudan explain say state creation suppose dey based on four things: demand, population, land size, and self sufficiency. On demand, Maisudan tok say pipo fit call for a new state maybe bicos of percived marginalisation by a majority ethnic group or inter-ethnic conflicts. Examples according to am na Nasarawa State wey dem create out of Plateau State and Bayelsa wey come out of Rivers State. Also, di size of di land by area as well as di population of a place na anoda tin to consider bifor creating a new state. Of course, di proposed new states, if created, suppose dey able to sustain itself and not to dey rely on federal allocation. "If you consider dis four factors, you go agree wit me say we no need new states. Even di 36 states wey we get now, how many of dem meet di criteria, especially di ability to sustain diasef witout di support of di federal goment?" Dr Maisudan ask. "In my opinion, if new states go dey created, e no suppose dey more dan five more, considering oda factors such as population and di complain of marginalisation of small ethnic groups by di majority ones." Oga Maisudan say even though some benefits dey from creating more states, di disadvantages pass di advantages. Some of di disadvantages according to am na e go add more to di cost of governance especially bicos some of di existing states need support from di federal goment to sustain diasef. Anoda one be say, e fit increase di agitation for separation from di kontri.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store