
How 16 inmates escape from Nasarawa prison
For statement, Nigeria Correctional Service tok-tok pesin, Umar Abubakar say na for early mor-mor on Tuesday August 12, 2025 di incident hapun.
Im tok for di statement say some inmates breach di security of di facility, dem also attack some of di workers wey dey on duty to compromise di situation wey allow some inmates to escape.
"Sixteen [16] inmates escape custody. As dem [workers] bin dey try to contain di situation, five (5) personnel of di Custodial Centre get different degrees of injury, wit two wey currently dey serious and dem dey receive urgent medical attention for goment health facility.
Oga Abubakar add say dem don catch some of di inmates wey bin escape.
"Seven [7] of di inmates wey bin escape we don catch dem back and dem dey custody now.
According to di statement, di Controller General of Corrections, Sylvester Ndidi Nwakuche visit di place. Im also order investigation into how di inmates take escape
Im also cut warning for staff say if dem find out say any of dem get hand inside dis incident dem no go spare di pesin.
Im also tok say make im workers collabo wit oda sister agencies to catch di remaining inmates.
Jail break for Nigeria
Incidents of jail break Nigeria no be new tori for Nigeria.
From time to time, govment dey make promises say dem go tighten security for di Correctional Centres wey dey di kontri but in reality, jail break still dey hapun.
For April 2024, Jail break make govment consider relocation of Nigerian prisons afta 119 inmates bin escape from Suleja prison wen di walls of di building collapse during one heavy rainfall on Wednesday April 24.
According to di tok-tok pesin for di Federal Capital Territory Command of di Nigerian Correctional Service, Adamu Duza wey bin confam di prison break inside statement dat time, some parts of di prison buildings including di perimeter fence destroy and allow di prisoners to escape.
For July 5, 2022 Kuje prison suffer gunmen attack inside Nigeria capital Abuja and 440 inmates bin escape.
On Sunday, September 2, 2021 unknown gunmen bin attack di Medium Security Custodial Centre, Kabba for Kogi State for Northern Nigeria.
Tori be say di heavily armed attackers wey plenty well-well bin engage di armed guards for serious gun battle.
Anoda jail break bin happun for April 2021, gunmen attack di Owerri prison for Imo State and set fire to di facility and property inside di compound.
Dis one cause most of di 1,800 plus inmates wey dem keep dia, to escape.
Di police later accuse di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) and Eastern Security Network (ESN) say na dem dey behind di attack.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


The Independent
2 hours ago
- The Independent
Gunmen kill at least 13 people in a mosque shooting in northwestern Nigeria
Gunmen attacked a mosque in northwestern Nigeria on Tuesday morning, killing at least 13 people during morning prayers, local authorities said. No one immediately claimed responsibility for the attack in the town of Unguwan Mantau, in the state of Katsina, but such attacks are common in Nigeria's northwestern and north-central regions where local herders and farmers often clash over limited access to land and water. The attacks have killed and injured scores — last month, an attack in north-central Nigeria killed 150 people. The prolonged conflict has become deadlier in recent years, with authorities and analysts warning that more herdsmen are taking up arms. The state's commissioner, Nasir Mu'azu, said the army and police have deployed in the area of Unguwan Mantau to prevent further attacks, adding that gunmen often hide among the crops out in farms during the rainy season to carry out assaults on communities. He added that the mosque attack was likely in retaliation for an action Unguwan Mantau townspeople who over the weekend ambushed and killed several of the gunmen in the area. Dozens of armed groups take also advantage of the limited security presence in Nigeria's mineral-rich regions, carrying out attacks on villages and along major roads. The farmers accuse the herders, mostly of Fulani origin, of grazing their livestock on their farms and destroying their produce. The herders insist that the lands are grazing routes that were first backed by law in 1965, five years after the country gained its independence. Separately from the conflict between farming and herding communities, Nigeria is battling to contain an insurgency against Boko Haram in the northeast, where some 35,000 civilians have been killed and more than 2 million displaced, according to the United Nations.


BBC News
3 hours ago
- BBC News
Resident tok how bandits kill plenti worshippers for Katsina mosque, beg govment for help
Bandits don attack mosque for Unguwan Mantau community, Malumfashi Local Govment Area for Katsina State, northern Nigeria, and kill plenti worshippers and injure odas. According to one resident wey follow BBC News Pidgin tok, na 25 worshippers di bandits kill and na five pipo dem injure. Di eyewitness wey no want make we mention im name say di attack happun around 6am for morning afta pipo finish dia Fijr prayer. "Around 5:45am, di gunmen meet pipo for mosque afta dem finish Fijr prayer, dem just open fire on dem. "Na immediately 25 pipo die, and more dan five odas injure, dem dey receive treatment for Katsina hospital now," e tok. E add say wen di attack dey happun, dem no get any help from security pipo. "Na afta di gunmen finish to kill pipo bifor security officers come. Dem snap picture and within two hours, dem don waka comot," e tok. E add say since afta di attack, pipo dey live for fear, and some don run comot from di community to save dia lives. "As I dey tok to you now, all my family no dey house again, dem don run comot for di community, pipo wey remain no plenti," e add. Di resident beg di state govment and security pipo make dem help bring peace for dia community. We dey update dis tori


BBC News
6 hours ago
- BBC News
Anambra authorities, police condemn treatment of corps member wey security operatives strip naked inside viral video
Di video of one young lady wey dem identify as corp members for Anambra state wey vigilante operatives bin assault tearing her clothes along wit odas don go viral. According to di video wey go viral, men wey wear mufti wit heavy guns bin enta into one compound beating a lady. Dem tear her clothes and drag her left and right till dem push her out. Wit di video wey dey go viral for social media, di security operatives wit dia guns bin join hand beat di young female corp member wit slaps, blows and di gril dey shout 'please' but dem no leave her. Di incident happun for Oba, Idemili South local govment area of Anambra State, and e don cause serious tok tok for social media. According to di police for Anambra state, na di Aguechemba vigilante group bin carry out di assault. Howeva, Anambra authority condemn di act sat na unfortunate incident wey no suppose happun. Anambra authority react to di corps members assault video Di special adviser to Governor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi don react to di trending video wia vigilante operatives bin assault di female corper and odas. E say di operatives bin dey carry out operation wen di incident happun but e dey veri sad say dat kain tin happun. "Wetin happun for dat incident dey veri unfortunate. We no rule out dis unfortunate incident wey happun, we get di report and di step we take be say we arrest di operatives wey dey involved for di act." "We detain dem, invite di victim wit di NYSC state coordinator. Den we say, our men wey go dat place, dia action dey unacceptable." Di special adviser to Anambra state govnor tok for di interview wit ChannelsTV say na men of di local security outfit Agunechemba bin carry out di operation. E say dem bin dey pursue some suspected cultist wey run inside di compound wey di mata happun. According to Emeakayi, Udo Ga-Achi na di operational code name wey di operatives dey take carry out di operation. E say di operation get di police, DSS, army, civil defence and all di security agencies for Anambra state but Agunechemba na di state security outfit wey be say na di law create of homeland security law create am. According to di community security adviser for Anambra state, na di law of di state empower di Agunechemba security outfit 'to enta any compound wey any questionable pesin run into wen dem dey pursue am.' E say di Agunechemba security outfit fit form squad for di purpose of tackling kidnapping, banditry, cultism, and any oda vices. For dis video wey dem naked di female corper and beat odas, e say di Agunechemba security outfit bin purse suspected cultist into di compound and dem begin search di building. E say na wetin carry di operatives go dat building be dat. "Di Agunechemba for Oba town bin dey chase group of cultist guys wey dey ride for motorcycle. During dat period, di suspected cultist run into one isolated area and into some houses." "Di operatives pursue dem into di compound, wia some pipo run into different houses and di operatives enta dia to bring dem out to screen and identify dem." Howeva, e condemn di action of di security operatives wia e tok say dat assault no suppose happun. Police react to assault of corp member Meanwhile, di Anambra State Police Command don condemn di sad incident wia vigilante bin naked di young female corpr member. "Di assault dey carried out by vigilante operatives. Following di incident, we don identify di suspects wey dey involved." According to di statement by di Anambra state police tok tok pesin, SP Tochukwu Ikenga, e say di reason why di case neva move forward since e happun na becos say di victim dey unavailable. E say dem don begin investigation into di case, and dem no go gree for any form of assault becos say na criminal offence under Nigerian law. "Any form remain criminal offence under di Nigerian Law and get di right to take necessary legal action to help di court proceedings while we dey wait for di victim." Police also cut warning give vigilante groups say make dem stop dey use brutality and abuse of authority during dia operation. We don reach out to di Anambra state NYSC make dem tok dia own side of di mata and wetin do di victim wey dem naked for di video. Also, we don reach out to di lawyer wey dey represent di young lady wey security operatives bin assault, to hear her own account.