logo
#

Latest news with #NigerianCorrectionalService

How 16 inmates escape from Nasarawa prison
How 16 inmates escape from Nasarawa prison

BBC News

time12-08-2025

  • BBC News

How 16 inmates escape from Nasarawa prison

Di Nigerian Correctional Service don comfam say some inmates breach di security of di Medium Security Custodial Centre for new Keffi, Nasarawa State, north -central, Nigeria. For statement, Nigeria Correctional Service tok-tok pesin, Umar Abubakar say na for early mor-mor on Tuesday August 12, 2025 di incident hapun. Im tok for di statement say some inmates breach di security of di facility, dem also attack some of di workers wey dey on duty to compromise di situation wey allow some inmates to escape. "Sixteen [16] inmates escape custody. As dem [workers] bin dey try to contain di situation, five (5) personnel of di Custodial Centre get different degrees of injury, wit two wey currently dey serious and dem dey receive urgent medical attention for goment health facility. Oga Abubakar add say dem don catch some of di inmates wey bin escape. "Seven [7] of di inmates wey bin escape we don catch dem back and dem dey custody now. According to di statement, di Controller General of Corrections, Sylvester Ndidi Nwakuche visit di place. Im also order investigation into how di inmates take escape Im also cut warning for staff say if dem find out say any of dem get hand inside dis incident dem no go spare di pesin. Im also tok say make im workers collabo wit oda sister agencies to catch di remaining inmates. Jail break for Nigeria Incidents of jail break Nigeria no be new tori for Nigeria. From time to time, govment dey make promises say dem go tighten security for di Correctional Centres wey dey di kontri but in reality, jail break still dey hapun. For April 2024, Jail break make govment consider relocation of Nigerian prisons afta 119 inmates bin escape from Suleja prison wen di walls of di building collapse during one heavy rainfall on Wednesday April 24. According to di tok-tok pesin for di Federal Capital Territory Command of di Nigerian Correctional Service, Adamu Duza wey bin confam di prison break inside statement dat time, some parts of di prison buildings including di perimeter fence destroy and allow di prisoners to escape. For July 5, 2022 Kuje prison suffer gunmen attack inside Nigeria capital Abuja and 440 inmates bin escape. On Sunday, September 2, 2021 unknown gunmen bin attack di Medium Security Custodial Centre, Kabba for Kogi State for Northern Nigeria. Tori be say di heavily armed attackers wey plenty well-well bin engage di armed guards for serious gun battle. Anoda jail break bin happun for April 2021, gunmen attack di Owerri prison for Imo State and set fire to di facility and property inside di compound. Dis one cause most of di 1,800 plus inmates wey dem keep dia, to escape. Di police later accuse di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB) and Eastern Security Network (ESN) say na dem dey behind di attack.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store