
'Evrione wan make dis title come back' - Nigeria eye 10th Wafcon win
Di Super Falcons don gbab 48 wins from 61 games across 12 editions of di finals since 1998 but di team ogbonge winning streak don fade recently even though dem still be di top ranked side for Africa.
Afta dem fall short for 2022, wey make dem face semi-final defeat, di Super Falcons dey enta Morocco dis month wit unfinished business.
Di for now head coach, Justin Madugu wey take ova from Randy Waldrum for September afta dem comot from di 2024 Olympic Games, e dey confident say di West Africans, dey sure say di West Africans fit reclaim dia crown.
Madugu tell BBC Sport Africa, "Wit di potential wey dey for di kontri, I fit tell you say we dey ready."
"Our goal na to win di trophy and carry am come back home."
Madugu bin dey work as Waldrum assistant bifor and don name squad wey get combination of youth and experience.
Asisat Oshoala, wey be di six time African women player of di year, four-time Wafcon winner Francisca Ordega and Chiamaka Nnadozie, wey dem call di continent best goalkeeper twice, na im dey name for di squad wey go play for di delayed 2024 competition.
Madugu say, "as at now, na we be di number one for Africa".
"Apart from dat, we don win dis tournament plenty times and we understand di hopes and expectations wey dey ground."
But almost half of di players from 2022, no go dey di tean dis time and dat include di former captain Desire Oparanozie and Madugu gree say yes, im squad na "work in progress".
Nigeria lose three matches for di last tournament, dem lose to di pipo wey end up to win South Africa, Morocco and Zambia nad go down to fourth place finish, wey mark dia worst Wafcon performance.
Na sad reminder say di rest of Africa don catch up.
A legacy under pressure
Di Super Falcons' golden era go back to 1991 wen Wafcon wey dat time dem dey call di African Women Championship - bin first dey introduced.
Nigeria win dat first edition- and den dem win seven of di next eight tournaments.
Dia ninth title happun for 2018 wen dem sama South Africa 4-3 on penalties afta goalles draw afta extra time.
Experienced forward Ordega wey just come back to di squad afta ova one year out, believe say di West Africans get di right blend wey e take to succeed for Morocco.
Di 31 year old tell BBC Sport Africa, "evrione wan dis title to come back",
"Most of dis girls neva play (Wafcon) bifor and I tink dem really wan win. Evribodi wan make name for demselves".
Nigeria don brand dia bid to win di tenth one for di finals as 'Mission X', wit Rasheedat Ajibade wey be one of di joint top scorers for di 2022 tournament wey dey captiain di side.
But di midfielder dey reason say e go meen ogbonge work for her side claim back dia continental crown.
Ajibade admit say, "even wit di talent for our team, we neva get much time to bond. Di small time wey we get now, we hope say we fit pull out sometin".
Nigeria go start dia bid wit group stage matches against Tunisia, Botswana and Algeria.
Preparations for di tournament meet di Super Falcons as dem win dia friendly matches against Algeria and Cameroon bifor dem get goalless draw agaisnt Portugal for Lisbon and 3-1 victory ova Ghana.
Kasala go spoil di team shine?
While Nigeria players dey used to dey fight hard ofr field, but most of di strongest kasala from dem na for off di field.
Recently, gbas-gbos ova unpaid bonuses, poor travel arrangements and lack of support from di Nigeria Football Federation don scata camps, spoil relationships and make headlines for all di wrong reasons.
Even wit ogbonge performance for di 2023 Fifa Women's World Cup wia dem reach di round of 16 and carry finalists England go penaly shootout, di team go back house to face unfinished administrative wahala.
Nnadozie, Nigeria first choice goalkeeper and di breakout star from dat World Cup tok about di mental palava to dey constantly dey fight for two fronts.
Di 24 year old wey recently sign wit Brighton afta she comot French club Paris FC, tok say, "e leave us to do wetin we sabi how to do wella".
"We go go Morocco to work hard and try bring back di trophy to Nigeria".
Michelle Alozie, wey dey play for Houston Dash for di USA National Women SOccer League (NWSL) gree wit wetin Nnadozie outlook.
Di 28 year old forward tok say, "adversity dey make us stronger, bring us closer togeda and help us fight for each oda on di field and off am.
"Obviously we bin dey very disappointed for di last Wafcon and we wan do di best for di team, for our kontri."
But some fans dey fear say decorated names like Oshoala and Ordega fit don pass dia prime and suppose make room for fresh legs for di current set-up.
Oshoala for instance neva score for 11 NWSL outings for Bay FC dis season even though she manage to score against Ghana for di team last warm up match.
Madugu insist say, "Asisat na jewel for Nigerian football, you no fit discount her accomplishment and relevance.
"For men, dem go say di younger id beta. But wit women di psychology dey differnet. Di older, di beta.
"Wen you check some of di top women football kotris like id USA and Germany, dia best players na di more experienced ones."
Victory for Morocco no go just be return to di summit of African football, for millions of Nigerians, na one of di rare times wey unity go dey bicos of national pride.
Nigeria Wafcon 2024 group fixtures
Sunday, 6 July: Nigeria vs Tunisia (16:00 GMT)
Thursday, 10 July: Nigeria vs Botswana (19:00 GMT)
Sunday, 13 July: Nigeria v Algeria (19:00 GMT)
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


The Sun
37 minutes ago
- The Sun
‘What is appropriate?' – Arne Slot opens up on coping with Diogo Jota tragedy and his advice to heartbroken Reds squad
ARNE SLOT admits nothing seems to be important at Liverpool following the death of striker Diogo Jota. The champions return to action at Preston this afternoon, still mourning the loss of their Portuguese international forward ten days ago. 7 7 7 Jota, 28, and his brother Andre were killed in a car accident in Spain as they began their journey back to England for pre-season training. Slot has spoken for the first time since the devastating news and says the club has to find a way to move on and start focussing on football again. For now, he has told his players to be themselves as they come to terms with the sudden loss of their popular team-mate. The Anfield boss said: 'Nothing seems to be important if we think of what has happened. 'But we are a football club and we need to train and we need to play again, if we want it or not. 'What I've said to the players, I can say it here as well. It's very difficult to find the right words because we constantly debate what is appropriate. 'What is appropriate in our actions? What is appropriate for what we have to say? Can we train again? Can we laugh again? Can we be angry if there's a wrong decision? 'And I've said to them, maybe the best thing for us to do is handle this situation like Jota was. And what I meant with that is that Jota was always himself. Diogo Jota's classy act of humility left me and my U13s team stunned - he was a credit to his family and football 'It didn't matter if he was talking to me, to his teammates, to the staff, he was always himself. 'So let us try to be ourselves as well. So, if we want to laugh we laugh, if we want to cry we're going to cry. 'If they want to train they can train, if they don't want to train they can not train. But be yourself, don't think you have to be different than your emotions tell you.' Liverpool announced last week that they will retire Jota's No20 shirt in all their teams right across the club as a lasting tribute to him. Slot has welcomed the move, saying: 'We will always carry him with us in our hearts, in our thoughts, wherever we go. 'Maybe especially in difficult moments but in any moment we are here, we will carry him with us in our thoughts and in our hearts. 'To retire his shirt is the one thing we could, should and have done.' Slot and his wife Mirjam were among the thousands who have visited Anfield to pay their respects to Jota over the past few days. And he said the fact the former Wolves forward had been through such an unforgettable few weeks gave him some solace in the dark days. He said: 'What I take comfort in is that in the last month of his life he was a champion in everything. 7 7 'A champion for his family, which is the main and most important thing, because he got married. 'A champion for his country because he won the Nations League, [with] a country that he cared about so much. 'And of course a champion for us by winning the Premier League.' The outpouring of emotion since Jota's death has only reinforced Slot's own bond with the club and supporters. He said: 'In the title parade, it was only the Liverpool fans I assume. Now this time it was the complete city, it wasn't only Liverpool, it was also the Everton fans. 'And not only this city but also all around the country and in the world. To represent this club in this city now even means more to me and to my wife than it did before.' 7 7


Reuters
40 minutes ago
- Reuters
Veteran coach Van Gaal says he is cured of cancer
AMSTERDAM, July 12 (Reuters) - Veteran coach Louis van Gaal says he has been cured of cancer and is keen for a return to the higher levels of the game. The 73-year-old announced three years ago that he was suffering from prostate cancer, but told a Dutch television talk show: "I'm no longer bothered by cancer." When he announced his illness, Van Gaal was the coach of the Dutch national team but he has not worked since the last World Cup in Qatar in 2022. "Two years ago, I had a few operations. It was all bad then. But it all worked out in the end. I have check-ups every few months, and that's going well. I'm getting fitter and fitter," he said. Van Gaal, whose career has taken in stints at Ajax Amsterdam, Barcelona, Bayern Munich and Manchester United, reiterated a lack of interest in returning to club management but said becoming the national coach of a top-tier country could tempt him back. He now serves as a special advisor to Ajax.


BBC News
an hour ago
- BBC News
What are your plans for the final?
Chelsea are in touching distance of the Club World Cup trophy, but to get their hands on it, they will have to beat Paris are you taking in the final this evening? Perhaps you've made the journey out to New Jersey to watch the Blues, or you're having a BBQ with family and friends at home ... Wherever you are, send us your pictures and plans over here!