logo
#

Latest news with #FidalBikbulatov

How Russians dey force Ukrainian children to love Russia
How Russians dey force Ukrainian children to love Russia

BBC News

time20-07-2025

  • Politics
  • BBC News

How Russians dey force Ukrainian children to love Russia

For occupied areas of eastern Ukraine, dem dey teach pikin early to love Russia. For one nursery school for Luhansk, ova 70 young children line up and hold one long black and orange Russia military banner for di shape of letter Z, wey be di symbol of Russia invasion of Ukraine. Across di city, seven small girls dey jump up and down and point to Russian flag to di song, "I am Russian" wey dey play from loudspeakers. Wen di music come stop, dem go shout to gada: "I be Russian." For one occupied town wey dem dey call Anthracite, nursery school pikin dem don make trench candles and blankets for Russian sojas. Na all part of one campaign wey no just wan erase Ukraine national identity, but also wan turn young Ukrainians against dia own kontri. To do dat wit children, you need teachers and many Ukrainian teachers don run, di goment for Moscow don dey offer lump amount of 2m roubles (£18,500) to Russian teachers wey like relocate to di occupied parts of Ukraine. Di biggest and most powerful Russian organisation wey get hand inside na Yunarmia (Youth Army). Dem dey linked wit di Russian defence ministry and dem dey accept members wey dey as young as eight years old. Dem dey work throughout Russia and now get branches for di occupied areas of Ukraine. Fidal Bikbulatov wey dey run di Yunarmia section for di occupied areas for di Zaporizhzhia region for south-east Ukraine. Bikbulatov bin dey deployed from Russia Bashkortostan wia e bin dey head di "Youth Guard" division of di ruling United Russia party. Education, military training dey part of how Russia dey indoctrinate Ukraine children Di EU don sanction Yunarmia and Bikbulatov gan-gan say dem dey "militarize Ukrainian pikin dem". Yunarmia also dey targeted by UK sanctions say dem dey part of Russia campaign to "brainwash" Ukrainian pikin dem. No be only Yunarmia dey rum am. Oda Russian sponsored organisations wey don enta include "Movement of di First Ones" and "Warrior", wey be network of centres for "di military and athletic training and patriotic education of young pipo" wey di orders of Russian President Vladimir Putin set up. Dis groups dey arrange competitions like di Zarnitsa games wey get im origin for di Soviet era wia dem dey make Ukrainian pikin dem to demonstrate "general military literacy, knowledge of Russian statehood and military history, firearms firing skills". As di pikin dem dey grow for dia schooling, dem dey teach dem in Russian, wit Russian curriculum and textbooks wey justify di Russia war against Ukraine. One of di books show Ukraine as Western invention wey dem create to spite Russia and argue say human civilisation for end if Russia no invade Ukraine for 2022. Lisa wey go school for occupied Donetsk say students dia bin dey forced to attend events wey celebrate Russia and di USSR. Lisa say, "wen dem bin dey prepare one kain parade. Me, my whole class and di whole of my year bin dey forced to go evri weekend, go train. We bin need to hold posters. I no fit say no, no be my choice. Dem tell me say I need to do am if I wan graduate". She add say, "evri time lessons start, our teachers go make us stand up put hand for chest and listen to di Russian anthem wey she also make us cram join." Lisa now dey stay for di US and don dey post her experiences for TikTok. Serving Russian sojas also get role for di campaign of indoctrination, say dem dey go schools to teach "bravery lessons". Dem dey glorify dia work for di war and show Ukrainian forces as violent, unruly neo-Nazis. Pavel Tropkin, wey be official for di ruling United Russia party wey no base for di occupied part of Kherson region tok say, dis teachings "na so di pikin dem go fit understand di objectives" of wetin di Kremlin dey call "di special military operation" for Ukraine. Outside school, dem dey carry Ukrainian children to go see specially organised exhibitions wey dey glorify Russia and di "special military operation". One centre wey dey run dis kain trips dey host exhibitions wey dem dey call "Russia - My History" and "Special Military Operation Heroes" for Melitopol for Zaporizhzhia region. Di trips no dey end dia. Di Kremlin don also launch one big campaign wey go carry Ukrainian pikin dem on tours to go Russia as part of efforts to ginger pro-Russian thinking. Russia culture minister, Olga Lyubimova claim say ova 20,000 pikin dem from di occupied Ukrainian territories go Russia for one programme wey dem dey call "4+85". According to Russian goment concert agency Rosconcert, wey dey run di programme, dem wan "join di new generations into di unified Russian society". But Russia "integration" campaign big pass just indoctrination. Thousands of Ukrainian children wey dem carry go Russia for di three years of di full scale war, dem no allow dem come back. Ukrainian goment say ova 19,000 Ukrainian children don dey deported by force to Russia. UK goment say say like 6,000 Ukrainian pikin na im dem don move to network of "re-education camps" for Russia. International humanitarian law ban activities like dis. For example, di Fourth Geneva Convention tok say occupying power no suppose enlist children "for formations or organizations subordinate to it" and say dem fit apply "no pressure or propaganda wey go aim to secure voluntary enlistment" of locals for occupied areas to join dia armed or auxiliary forces. For 2023, di ICC put out arrest warrant for President Putin and part of di reason na di unlawful deportation of children. Putin and im goment deny di charges. For dis war wey dem dey run for Ukraine, Russia no dey only come for territory, dem dey also try stamp diaselves for di pipo wey dey live for dia, no mata how young dem be.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store