
How Russians dey force Ukrainian children to love Russia
For one nursery school for Luhansk, ova 70 young children line up and hold one long black and orange Russia military banner for di shape of letter Z, wey be di symbol of Russia invasion of Ukraine.
Across di city, seven small girls dey jump up and down and point to Russian flag to di song, "I am Russian" wey dey play from loudspeakers. Wen di music come stop, dem go shout to gada: "I be Russian."
For one occupied town wey dem dey call Anthracite, nursery school pikin dem don make trench candles and blankets for Russian sojas.
Na all part of one campaign wey no just wan erase Ukraine national identity, but also wan turn young Ukrainians against dia own kontri.
To do dat wit children, you need teachers and many Ukrainian teachers don run, di goment for Moscow don dey offer lump amount of 2m roubles (£18,500) to Russian teachers wey like relocate to di occupied parts of Ukraine.
Di biggest and most powerful Russian organisation wey get hand inside na Yunarmia (Youth Army).
Dem dey linked wit di Russian defence ministry and dem dey accept members wey dey as young as eight years old. Dem dey work throughout Russia and now get branches for di occupied areas of Ukraine.
Fidal Bikbulatov wey dey run di Yunarmia section for di occupied areas for di Zaporizhzhia region for south-east Ukraine.
Bikbulatov bin dey deployed from Russia Bashkortostan wia e bin dey head di "Youth Guard" division of di ruling United Russia party.
Education, military training dey part of how Russia dey indoctrinate Ukraine children
Di EU don sanction Yunarmia and Bikbulatov gan-gan say dem dey "militarize Ukrainian pikin dem". Yunarmia also dey targeted by UK sanctions say dem dey part of Russia campaign to "brainwash" Ukrainian pikin dem.
No be only Yunarmia dey rum am. Oda Russian sponsored organisations wey don enta include "Movement of di First Ones" and "Warrior", wey be network of centres for "di military and athletic training and patriotic education of young pipo" wey di orders of Russian President Vladimir Putin set up.
Dis groups dey arrange competitions like di Zarnitsa games wey get im origin for di Soviet era wia dem dey make Ukrainian pikin dem to demonstrate "general military literacy, knowledge of Russian statehood and military history, firearms firing skills".
As di pikin dem dey grow for dia schooling, dem dey teach dem in Russian, wit Russian curriculum and textbooks wey justify di Russia war against Ukraine.
One of di books show Ukraine as Western invention wey dem create to spite Russia and argue say human civilisation for end if Russia no invade Ukraine for 2022.
Lisa wey go school for occupied Donetsk say students dia bin dey forced to attend events wey celebrate Russia and di USSR.
Lisa say, "wen dem bin dey prepare one kain parade. Me, my whole class and di whole of my year bin dey forced to go evri weekend, go train. We bin need to hold posters. I no fit say no, no be my choice. Dem tell me say I need to do am if I wan graduate".
She add say, "evri time lessons start, our teachers go make us stand up put hand for chest and listen to di Russian anthem wey she also make us cram join."
Lisa now dey stay for di US and don dey post her experiences for TikTok.
Serving Russian sojas also get role for di campaign of indoctrination, say dem dey go schools to teach "bravery lessons". Dem dey glorify dia work for di war and show Ukrainian forces as violent, unruly neo-Nazis.
Pavel Tropkin, wey be official for di ruling United Russia party wey no base for di occupied part of Kherson region tok say, dis teachings "na so di pikin dem go fit understand di objectives" of wetin di Kremlin dey call "di special military operation" for Ukraine.
Outside school, dem dey carry Ukrainian children to go see specially organised exhibitions wey dey glorify Russia and di "special military operation".
One centre wey dey run dis kain trips dey host exhibitions wey dem dey call "Russia - My History" and "Special Military Operation Heroes" for Melitopol for Zaporizhzhia region.
Di trips no dey end dia.
Di Kremlin don also launch one big campaign wey go carry Ukrainian pikin dem on tours to go Russia as part of efforts to ginger pro-Russian thinking.
Russia culture minister, Olga Lyubimova claim say ova 20,000 pikin dem from di occupied Ukrainian territories go Russia for one programme wey dem dey call "4+85". According to Russian goment concert agency Rosconcert, wey dey run di programme, dem wan "join di new generations into di unified Russian society".
But Russia "integration" campaign big pass just indoctrination.
Thousands of Ukrainian children wey dem carry go Russia for di three years of di full scale war, dem no allow dem come back.
Ukrainian goment say ova 19,000 Ukrainian children don dey deported by force to Russia. UK goment say say like 6,000 Ukrainian pikin na im dem don move to network of "re-education camps" for Russia.
International humanitarian law ban activities like dis. For example, di Fourth Geneva Convention tok say occupying power no suppose enlist children "for formations or organizations subordinate to it" and say dem fit apply "no pressure or propaganda wey go aim to secure voluntary enlistment" of locals for occupied areas to join dia armed or auxiliary forces.
For 2023, di ICC put out arrest warrant for President Putin and part of di reason na di unlawful deportation of children. Putin and im goment deny di charges.
For dis war wey dem dey run for Ukraine, Russia no dey only come for territory, dem dey also try stamp diaselves for di pipo wey dey live for dia, no mata how young dem be.
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


Daily Mail
an hour ago
- Daily Mail
Trump and Starmer to discuss Gaza ceasefire and US-UK trade at president's Scottish golf course: Live updates
Donald Trump and Sir Keir Starmer will today meet at the President's Scottish golf course where they are expected to discuss details of a US-UK trade deal, the war between Russia and Ukraine and the humanitarian crisis in Gaza. The Prime Minister will travel to Ayrshire, where the US president is staying at his Turnberry golf resort, for wide-ranging discussions. The two leaders have built a rapport on the world stage despite their differing political backgrounds, with Mr Trump praising Sir Keir for doing a 'very good job' in office ahead of their talks on Monday. 07:32 Welcome to our live coverage of Trump and Starmer's meeting in Ayrshire today! Good morning - welcome to our live coverage as President Donald Trump and Sir Keir Starmer are set to meet on his golf course in Turnberry, Scotland today! As we anticipate the meeting between the two world leaders, here is what we know to expect of today's meeting: Starmer and Trump are expected to discuss the prospect of a ceasefire in the Middle East and how to apply pressure on Vladimir Putin to end the war in Ukraine. They are also expected to talk one-on-one about advancing implementation of the UK-US trade deal, signed on May 8. The PM is also expected to welcome the President's administration working with Qatar and Egypt to bring about a ceasefire in Gaza. A Number 10 spokesperson said it was expected they will discuss 'what more can be done to secure the ceasefire urgently, bring an end to the unspeakable suffering and starvation in Gaza and free the hostages who have been held so cruelly for so long'. The war in Ukraine will also be up for discussion with both politicians 'set to talk about their shared desire to bring an end to the barbaric war' according to Number 10, and expected to 'reflect on progress in their 50-day drive to arm Ukraine and force Putin to the negotiating table '. After a meeting at the course, Starmer and Trump will travel on together for a further private engagement in Aberdeen.


Reuters
an hour ago
- Reuters
Russia's night attack wounds eight in Kyiv, Ukraine says
KYIV, July 28 (Reuters) - A Russian overnight air attack wounded eight residents of an apartment building in Kyiv, including a three-year-old child, authorities said on Monday, while the Ukrainian air force said a town hosting a key air base had been attacked. Four of those injured in the capital were admitted to hospital with one in serious condition, the head of Kyiv's military administration, Tymur Tkachenko, said on Telegram. Ukraine's air force said Russia had launched 324 drones and seven missiles overnight, and that their main target was Starokostyantyniv in western Ukraine, home to a major air base. It said 15 drones and two missiles had hit targets in three locations, but did not specify where. Russia invaded its neighbour three and a half years ago. Its repeated night-time air attacks, sometimes involving hundreds of drones, are often accompanied by a handful of missiles to try to overwhelm air defences. The capital and most of Ukraine were under air raid alerts for several hours overnight. Polish aircraft were also scrambled to ensure the safety of national airspace. Those wounded in Kyiv were residents of a multi-storey apartment building in the Darnytskyi district, Kyiv Mayor Vitali Klitschko said. The full scale of the Russian attack on Ukraine was not immediately known. There was no comment from Russia. Both sides deny targeting civilians in the war. However, thousands of civilians have died in the conflict, the vast majority of them Ukrainian.


The Sun
3 hours ago
- The Sun
Nato jets scrambled after Putin launches massive overnight drone and missile attack on Ukraine
NATO member Poland has scrambled fighter jets after Russia's latest blitz on Ukraine. The jets took to the skies as Vladimir Putin sent the latest wave of kamikaze drones and rockets at Kyiv. 1 Five people, including a two-year-old girl, were injured in the strikes with shrapnel wounds after one bomb hit an apartment building. The Polish Ministry of Defence said the jets took off as a precautionary measure during the strikes. They said: "Polish and allied aircraft on standby were scrambled and ground-based air defence and radar reconnaissance systems were placed on the highest level of combat readiness." More to follow... For the latest news on this story, keep checking back at The U.S. Sun, your go-to destination for the best celebrity news, sports news, real-life stories, jaw-dropping pictures, and must-see videos.