15-03-2025
Police use tear gas pursue women wey block road as FCT minister bin dey expected for Alabama inside Rivers state
Police use tear gas puruse some women wey go block di road to Abalama, one community for Asari-Toru local goment area of Rivers State For southern Nigeria.
Reports say di protesting women wey wear black cloth and tie white cloth round dia head block di road as di arrival of di FCT Minister Nyesom Wike bin dey expected for one grand reception wey some of im supporters for Kalabari land dey hold for am for Community Secondary School field Abalama.
Di women dey react to di alleged insult wey dem claim say di FCT Minister do to Ijaw pipo for one interview wey e grant for Abuja wia e call ijaw pipo 'minority of minorities' on Wednesday 12 March 2025.
Dis na as di FCT Minister wey be di immediate past govnor of Rivers State also don dey in a political crises with im successor, Govnor Siminalayi Fubara, wey be Ijaw for a while now.
Earlier on, di grand reception for Wike bin don dey cancelled by di traditional institution to avoid possible break down of law and order becos di Eastern zone of di Ijaw Youth Congress IYC bin don also call for emergency meeting for di same venue, Community Secondary School field Abalama, wia di grand reception suppose hold.
For statement signed by seven Kalabari traditional rulers led by HRH, King Lawrence O. O. Odum (Odum Barboy IX), Amanyanabo of Bakana and Chairman, Degema Area Council of Traditional Rulers and Chiefs, di Forum of Traditional rulers of Kalabari Ethnic Nationality cancel any activity dia.
Dem call on di state, di govnor and heads of various security agencies for di state to stop a potential violent clash for Kalabari land between two opposing groups wey fit lead to bloodshed.
"We dey concerned say di clash of venues for di planned events by di two opposing groups, if not addressed, fit cause a possible breach of peace and order for di area.
Dis fit potentially threaten di existing peace for Abalama Community and di rest of Kalabari land.
Di Traditional Rulers of di Kalabari Ethnic Nationality therefore appeal to both parties to relocate dia events elsewia, possibly outside Kalabari land, to stop a possible violent clash for di area." Di statement bin tok.
Despite dis, organisers of di grand reception for Wike still go ahead with di occasion before di women protesters go block di road.
Meanwhile, di FCT Minsiter Nyesom Wike land Abalama community for di thanksgiving and grand reception wey im supporters, di N.E.W. Rivers Associates, organise for am and e bin address dem.