logo
Police use tear gas pursue women wey block road as FCT minister bin dey expected for Alabama inside Rivers state

Police use tear gas pursue women wey block road as FCT minister bin dey expected for Alabama inside Rivers state

BBC News15-03-2025
Police use tear gas puruse some women wey go block di road to Abalama, one community for Asari-Toru local goment area of Rivers State For southern Nigeria.
Reports say di protesting women wey wear black cloth and tie white cloth round dia head block di road as di arrival of di FCT Minister Nyesom Wike bin dey expected for one grand reception wey some of im supporters for Kalabari land dey hold for am for Community Secondary School field Abalama.
Di women dey react to di alleged insult wey dem claim say di FCT Minister do to Ijaw pipo for one interview wey e grant for Abuja wia e call ijaw pipo 'minority of minorities' on Wednesday 12 March 2025.
Dis na as di FCT Minister wey be di immediate past govnor of Rivers State also don dey in a political crises with im successor, Govnor Siminalayi Fubara, wey be Ijaw for a while now.
Earlier on, di grand reception for Wike bin don dey cancelled by di traditional institution to avoid possible break down of law and order becos di Eastern zone of di Ijaw Youth Congress IYC bin don also call for emergency meeting for di same venue, Community Secondary School field Abalama, wia di grand reception suppose hold.
For statement signed by seven Kalabari traditional rulers led by HRH, King Lawrence O. O. Odum (Odum Barboy IX), Amanyanabo of Bakana and Chairman, Degema Area Council of Traditional Rulers and Chiefs, di Forum of Traditional rulers of Kalabari Ethnic Nationality cancel any activity dia.
Dem call on di state, di govnor and heads of various security agencies for di state to stop a potential violent clash for Kalabari land between two opposing groups wey fit lead to bloodshed.
"We dey concerned say di clash of venues for di planned events by di two opposing groups, if not addressed, fit cause a possible breach of peace and order for di area.
Dis fit potentially threaten di existing peace for Abalama Community and di rest of Kalabari land.
Di Traditional Rulers of di Kalabari Ethnic Nationality therefore appeal to both parties to relocate dia events elsewia, possibly outside Kalabari land, to stop a possible violent clash for di area." Di statement bin tok.
Despite dis, organisers of di grand reception for Wike still go ahead with di occasion before di women protesters go block di road.
Meanwhile, di FCT Minsiter Nyesom Wike land Abalama community for di thanksgiving and grand reception wey im supporters, di N.E.W. Rivers Associates, organise for am and e bin address dem.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

'Peter Obi no go ever be president'
'Peter Obi no go ever be president'

BBC News

time06-07-2025

  • BBC News

'Peter Obi no go ever be president'

Nigeria Minister of di Federal Capital Territory (FCT), Nyesom Wike say, 2023 Labour Party presidential candidate Peter Obi no go ever be president of di kontri. Di one time govnor of Rivers State, tok dis one during one thanksgiving wey dem do for project inauguration for Abuja. Wike, one of di close allies of President Bola Tinubu, tok dis one as im dey react to one new coalition party wey some heavy weight politicians wit presidential ambition form as opposition to di ruling All Progressive Congress (APC) party. E say, "You say Peter Obi go be president. President wia? Some of una no sabi somebody, una go just dey tok out of emotion." Di minister also drag oda coalition members Atiku Abubakar, Rauf Aregbesola and odas. Oga Wike kwesion why former vice president of di kontri and di 2023 presidential candidate of di Peoples Democratic Party dey jump from one party to anoda. "How Nigerians no go vex for you today. For 1999 you dey dis party. For 2006 you dey anoda party, for 2014, you move go anoda party. In 2019 you go back to anoda party. Now 2025 you dey go anoda party. To rescue who?" Wike ask. E tell former minister of interior, Arebesola say n aim Nigerians dey angry wit becos im make dem wait for many many months before dem for fit get dia international passport. Di minister declare say as all of dem don comot from power, dem no go come back.

‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara
‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara

BBC News

time27-06-2025

  • BBC News

‘No more acrimony, peace don come' - Wike tok afta e meet wit Tinubu and Fubara

'No more acrimony. Peace don finally come to di state.' Na wetin FCT Minister Nyesom Wike tok at di end of a peace meeting between im and Rivers State Govnor Siminialayi Fubara wit President Bola Tinubu for Aso Rock. Photos of smiles and handshake between Govnor Fubara, di State Assembly members with Minister of FCT Nyesom Wike and President Tinubu don raise hopes of a possible end to di emergency rule for di state. Govnor Fubara alongside Wike and Martins Amaewhule, speaker of di Rivers State House of Assembly and oda Assembly members meet with President Tinubu to broker a peace deal wey dey expected to return democratic governance to di state. Dis meeting dey expected to be a crucial part of di peace building process since President Tinubu declare a state of emergency wey suspend elected state executives and di House of Assembly on 18 March 2025, over three months ago. Afta di meeting, di FCT minister and Govnor Fubara say peace don return as dem don finally reconcile. Wike say dem don agree to work togeda wit di govnor and di govnor too don agree to work with dem. E say dem be members of di same political family wey dey disagree sometimes but now, dem don settle and dem come togeda to inform Mr. president. Photos from di meeting suggest a breakthrough in efforts to resolve di political crisis for di state as one photo show di president with Govnor Fubara and FCT minister all dey smile and shake hands. Oda photos show di FCT Minister and di govnor dey waka side by side with di Speaker Amaewhule and oda state lawmakers dey follow dem. Govnor Fubara say e happy say dis day of reconciliation don come to be as e dey necessary and important for di peace and progress of Rivers State. 'With di help of di president and di agreement of di leaders of di state, peace don return to Rivers State. We go do evritin within our power to make sure say we sustain am dis time around.' Govnor Fubara tok. How we reach here? All dis crises arise from disagreement between Govnor Fubara and di FCT Minister Wike with many reactions wey include: Many pipo don criticise di emergency rule wey see di appointment of a Sole administrator, Vice Admiral Ibok-Ete Ekwe Ibas Rtd, from Cross River State to oversee affairs for di state. E lead to many court cases wey dey challenge am for Federal High Courts both for Port Harcourt and Abuja as dem insist say a tsate of emergency no require di president to suspend di elected govnor and Assembly members and impose a non-indigene on di state to oversee affairs. Even di appointment of sole administrators for di 23 LGAs for di State na anoda issue wey many criticize as dem say e no dey known to law and e only favour one party for di crises. Odas also criticise di dissolution of boards and agencies for di state and even di one wey National Assembly don approve, over N1trillion 2025 state budget as well as clearing some officials for some boards. Di approval of anoda Cross River State indigene, Michael Ekpai, to head di Rivers State Independent Electoral Commission RSIEC wey dey expected to conduct local goment elections also spark criticism. But di main questions na weda dis reconciliation moves go bring an end to di emergency rule soon? Wetin go happen to di court cases wey challenge di emergency rule wey di Federal High Courts never begin proper hearing for most of dem? Wetin go happen to di recent appointments wey di Nigerian Senate approve, dem go still hold or dem go dey suspended? All dis na wetin pipo dey wait to see how e go all play out.

Wetin be ICC and why Nigerians dey para say goment rename am
Wetin be ICC and why Nigerians dey para say goment rename am

BBC News

time11-06-2025

  • BBC News

Wetin be ICC and why Nigerians dey para say goment rename am

Nigerians dey para afta di kontri present goment rename di Abuja International Conference Centre wey former President Ibrahim Babangida build to President Bola Tinubu name. On Tuesday, di Nigeria Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, announcement during one unveiling ceremony afta di goment rehabilitate di centre, say dem don change di name to Bola Ahmed Tinubu International Centre. Wike also name halls inside di centre afta some politicians. Im name halls afta Vice President Kashim Shettima, Chief Justice of Nigeria Kudirat Kekere-Ekun, Senate President Godswill Akpabio and Speaker of the House of Representatives Tajudeen Abbas. According to di FCT Minister, dis n aim way to say thank you to dem for supporting im FCT Administration and for how di Judiciary and Legislative arms of goment dey collabo wit executive. But Nigerians dey para say di whole tin be like dem dey enjoy anoda man sweat. Isaac Fayose, di younger brother of one former Nigerian govnor, Ayodele Fayose, para say: "IBB, di man wey build am, no name am afta imsef. Tinubu renovate am, change im name. e say a lot. Nigerians dey suffer, but dem dey focus on keeping dia name forever." Former Nigeria Senator, Shehu Sani sef follow provoke for social media as im advise di president say: "Na IBB build di International Conference Centre Abuja. Make di President reject renaming di place wit im name". Abuja International Conference Center [ICC] Former President Ibrahim Badamosi Babangida bin build di Abuja International Conference Centre for 1991. According to Wike, Babangida bin build to ICC to host one Organization of African Unity meeting. Di meeting bin suppose happun for Ethiopia but dem gatz relocate am sake of security threat. Nigeria step in come begin urgent construction of di ICC through one oil swap arrangement wey e do to take raise di money. Di centre bin popular wella sake of na dia President Babagida constitution review committee bin dey examine and revise di Nigerian Constitution. Architecturally, di centre na mixture of modern design and Nigerian cultural decorations. E get spacious hall and beautiful gardens surround am to give am very cool atmosphere. Dis centre na one of Nigeria most iconic venues for high-level events, both local and international. E don host all kains of events from world summits to trade exhibitions and cultural showcases. Tinubu goment bin recently do one major renovation wey dem say cost ₦39 billion, and come commission an again for on Tuesday. Di renovation bin happu afta President Visit di place for 2024 begin complain about how di facility dey spoil. Inside eight months, Wike renovate an im to wetin im call "world-class" venue. Now di facility go dey bear di name of di president wey renovate am, no be di one wey build am. Oda goment buildings wey Tinubu name afta imsef Less dan two years wey di Nigeria president enta office, President Bola Tinubu don commission more dan three goment properties afta im name. Inside di first 19 months of im goment Tinubu commission one multibillion-naira army barrack wey dem bin start to construct for 2023. Di barracks project na intervention wey goment bin fund to provide more accommodation to military workers. E also commission one immigration complex as well as one new federal polytechnic, All of dem for Abuja.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store