logo
#

Latest news with #NnamdiKanu

Nigerian govment reject Nnamdi Kanu 'no case submission', court adjourn mata for ruling
Nigerian govment reject Nnamdi Kanu 'no case submission', court adjourn mata for ruling

BBC News

time18-07-2025

  • Politics
  • BBC News

Nigerian govment reject Nnamdi Kanu 'no case submission', court adjourn mata for ruling

One High Court for Abuja don set 10 October as di day to rule on di 'No Case' submission wey di proscribed Ipob leader, Nnamdi Kanu bring for court through im lawyers. Di 'No Case' submission wey dem date 4th July 2025, and file on 14th July, 2025, bin dey adopted on Friday. No Case Submission na legal argument wey defence counsel dey usually present afta di prosecution present dia case finish to show say, di evidence wey dem bring come no dey enough to prove from am alone say di defendant do wetin dem tok say e do. Dis dey come usually bifor di defence start to present dia own case for court. While adopting dia written address, di lead counsel to di defendant, Kanu Agabi. SAN, inform di court of dia reasons for filing a 'No Case' submission say: For di prosecution response, Adegboyega Awomolo, SAN, tok say di prosecution don call five witnesses wey dem use prove evri element for di case. E also tok say di judge no suppose enta di koko of di case or di evidence, say im own na just to determine weda di defendant need tok anytin in im defense. Oga Adegboyega also reason say di law ban any statement wey go cause fear. So if di defendant say e bin just dey boast, e need to explain am. For di mata of solitary confinement, e argue say oga Kanu bin get bail from 2017-2022 and na order of court say make e stay for custody for di safety of Nigerians. On di proscription of IPOB, e tok say no be di judge go decide dat one say e dey supreme court. Wetin be di charges against Nnamdi Kanu? Since 2015 wen di Nigeria goment first arrest Nnamdi Kanu, na only April dis year im trial start well-well. Remember say di matter bin dey bifor Justice Binta Nyako of di Federal High Court Abuja, and na she bin grant Kanu bail on health grounds for 2017, but Kanu run for im life comot for Nigeria afta soldiers bin carry out security operation for im House for Umuahia, Abia State for southeast Nigeria. For June 2021, security pipo for Kenya arrest Kanu and carry am by force come back to Nigeria to face trial. Di initial charges against di ipob leader bin dey 15, but Justice Nyako bring am down to seven. Even though di Court of Appeal later strike out all di charges and discharge Kanu, di Supreme Court reinstated di seven charges as dem tok say di Ipob leader get questions to ansa. Dis na di seven charges: Count 1: Say you Nnamdi Kanu, as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to intimidate di population. Count 2: Say you Nnamdi Kanu, as member and leader of Ipob commit act of terrorism against di federal republic of Nigeria by making broadcast wit intention to threaten members of di public wit sit at home order. Count 3: Say you Nnamdi Kanu, make broadcast wia you declare your sef as member and leader of Ipob, group wey Nigeria goment don ban. Count 4: Say you Nnamdi Kanu, make broadcast wia you encourage members of di public to kill Nigeria security officers. Count 5: Say you Nnamdi Kanu, make broadcast wia you encourage di public to attack officers of di Nigeria police force. Count 6: Say you Nnamdi Kanu, make broadcast wia you encourage members of di public to burn down evri federal goment facilty for Lagos wey lead to major economic loss to federal goment. Count 7: Say you Nnamdi Kanu, import Radio transmitter known as Tram 50L and hide am inside container for Ubulisiuzor for Ihiala Local government area of Anambra state.

Fact Check: Kenya has not demanded Nigeria return separatist leader
Fact Check: Kenya has not demanded Nigeria return separatist leader

Reuters

time27-06-2025

  • Politics
  • Reuters

Fact Check: Kenya has not demanded Nigeria return separatist leader

Kenya's foreign ministry has dismissed reports circulating widely on social media that it has filed a lawsuit against the Nigerian government demanding the "return" of Biafran separatist leader Nnamdi Kanu. Kanu, a British citizen and separatist leader of the outlawed Indigenous People of Biafra (IPOB) movement in Nigeria, was arrested there in 2015, but went missing while on bail in 2017. He was detained in Kenya in 2021 and appeared back in court in Nigeria later that year, charged with seven counts of terrorism - charges he denies in his ongoing trial. His lawyer has accused Kenyan special forces of abducting Kanu, which Kenya has denied. In May, posts published, opens new tab on Facebook alongside two images – one of Kenyan President William Ruto and the other of Kanu – said: "Breaking News: Kenya Threatens Nigeria with ICC Action Over Abduction of Nnamdi Kanu". The posts said the Kenyan government had filed a lawsuit against the Nigerian government "demanding the immediate return of Nnamdi Kanu to Kenya". The posts also cited an unnamed Kenyan government spokesperson as saying Nigerian agents had infiltrated Kenya to "abduct" Kanu, in what they described as "an act of aggression that could be interpreted as a declaration of war". Korir Sing'oei, the principal secretary of Kenya's Ministry of Foreign and Diaspora Affairs, told Reuters that Kenya had not filed any proceedings in any court on the issue. "No such statement has been issued by Kenya," he said in a message. "The matter is outside the remit of the ICC in any event." Kanu's lawyer, Aloy Ejimakor, told Reuters he was "not aware of any such legal proceedings filed by Kenya". The ICC prosecutes individuals allegedly responsible for war crimes, crimes against humanity and genocide. A spokesperson for the ICC told Reuters in an email that it "only deals with questions of individual responsibility and not States". No Nigerian national is listed as a defendant in any of the ICC's 33 cases published on its website, opens new tab. The International Court of Justice (ICJ) is the only international court with the remit to settle disputes between the UN's 193 Member States, which includes both Kenya and Nigeria. A representative for the ICJ told Reuters in an email that there is currently no case on the court's docket instituted by Kenya against Nigeria A spokesperson for Nigeria's foreign ministry did not respond to Reuters' request for comment. False. The Principal Secretary of Kenya's Foreign Ministry said the government has not filed any proceedings demanding Kanu be transferred to the country. An ICC spokesperson said it only deals with individuals, not states. This article was produced by the Reuters Fact Check team. Read more about our fact-checking work.

Timeline of how Nnamdi Kanu terrorism trial don go since new judge take over
Timeline of how Nnamdi Kanu terrorism trial don go since new judge take over

BBC News

time20-06-2025

  • Politics
  • BBC News

Timeline of how Nnamdi Kanu terrorism trial don go since new judge take over

On Thursday, di lawyers of Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob), tok say dem go file a no-case submission over di terrorism charges wey di Nigeria goment sama on am. Dem tok dis one afta di federal goment close dia case for di trial afta dem don call five witnesses and tender plenty documents as exhibits including video and audio broadcasts wey dem say Kanu bin make. Nigeria goment dey try Kanu on terrorism allegations. Dem say e terrorise pipo by issuing illegal sit-at-home orders, and by telling im followers to attack and kill police. Kanu plead not gulity to di charges. Dis na di summary of how di matter take reach dis stage since Justice James Omotosho take over from Justice Binta Nyako: Re-arraignment... Kanu plead no guilty Di matter start afresh on 21 March, 2025 as di Nigeria goment re-arraign Kanu on seven counts of terrorism, belonging to a terrorist group, and illegal importation of radio equipment. Kanu plead not guilty. On dat day, our tori pesin wey don dey cover dis trial since 2019, notice say Kanu don change im lead counsels and employ ogbonge senior advocates like di former Attorney General of di Federation and Minister of Justice, Kanu Agabi; Onyechi Ikpeazu, Emeka Etiaba, Paul Erokoro and so. Bifor dis time, Kanu lead counsel na Ifeanyi Ejiofor and Aloy Ejimakor, and later Mike Ozekhome (SAN) join dem for some time bifor dem withdraw am again. On di day of re-arraignment, Kanu Agabi apologise to di court for how Nnamdi Kanu bin para for Justice Nyako and di FG lawyer, Adegboyega Awomolo during di previous hearings. Justice Omotosho accept di apology as e tok say e understand say di defendant bin tok out of anger sake of say di case don last for ten years now. "As I dey look di case file, I see say dis matter start wen di defendant dey 45 years old, now e dey 55 years, so I understand im anger. Dat na why I go grant accelerated hearing for dis matter," Omotosho tok. And true-true, e grant accelerated hearing. PW1 - Mr AAA For di next adjourned date - 29 April, 2025, di Nigeria goment call dia first prosecution witness, Mr AAA (no be im real name). All di goment witnesses testify using codenames AAA to EEE for di five witnesses, sake of say dem dey work wit di Department of State Services (DSS), wey be Nigeria secret security outfit. Di court also permit dem to testify behind cover and for dem to also wear mask. Mr AAA na di officer wey lead di arrest of Nnamdi Kanu for 2015. Dem arrest am for one hotel close to di Lagos International Airport. Di witness tok say dem arrest Kanu wit one woman for im room, and dem recover plenty broadcasting equipment for im hand, but during cross-examination, e confirm say dem no find any terrorism equipment wit am. E tender videos of statement wey Kanu bin make for di DSS headquarters in Abuja afta dem transport am from Lagos. For dat video, im lawyer Aloy Ejimakor and one oda lawyer dey dia. Di witness also tender in evidence two boxes containing Kanu personal belongings like shoes, wrist-watches, and perfumes, plus some broadcasting equipment like microphones, tripods, laptops, ipads, and internet modems. PW2 - Mr BBB Di second prosecution witness - Mr BBB start im own testimony on 7 May, 2025. E tok say im na one of di lead officers wey investigate Nnamdi Kanu, afta di den AGF Abubakar Malami, write a petition to DSS complaining of di broadcasts wey di Ipob leader dey make on social media using Radio Biafra. Dis witness tender video evidence wia Nnamdi Kanu announce di creation of di Eastern Security Network (ESN), and wia e threaten Bola Tinubu and say e go destroy im properties for Lagos. Mr BBB also say dia investigation show say Nnamdi Kanu broadcasts dey directly connected to di violence and killings wey dey go on for di southeast region. E also tender as exhibit, di death certificate of Ahmed Gulak, wey be chieftain of di All progressives Congress (APC) wey jaguda pipo bin kill for Owerri Imo State on 30 May, 2021. Di witness claim say na Ipob fighters kill Gulak sake of say e disobey di sit-at-home order wey Kanu bin give for dat May 30 - a day wey Ipob dey mark as Biafra Remembrance Day. During cross-examination, BBB deny say no be DSS pipo arrest Kanu for Kenya. E say dia work no dey cross outside Nigeria. Also, Kanu lawyers tender video evidence of di Govnor of Imo State as e tok say Ipob no dey responsible for di killings for di state, rather na politicians dey do am. Dem also play videos of retired Major General for di Nigeria Army, T.Y Danjuma, and di current Director-General of di DSS Adeola Ajayi wia dem dey tell di public make dem rise up and defend diasef from terrorists and bandits PW3 - Mr CCC Dis witness na also one of di officers wey bin investigate Kanu wen dem arrest am from 2015. E tok say im and two oda DSS officers bin interview Kanu on October 21, 22, 23 and 24, and again on November 4 of dat 2015, and e present di video recording of dat interview to be tendered as evidence. However, one of Nnamdi Kanu lawyers, Paul Erokoro inform di court say Kanu tell am say im bin dey under duress wen e make di statement. Prosecution lawyer say no be true, say Kanu make di statement voluntarily witout any force. To determine weda to accept di video in evidence, Justice Omotosho order for trial within trial. Dem play di video for court and e show say Kanu bin complain several times say e dey entitled to a lawyer but di DSS no wan give am im lawyer. Justice Omotosho rule say e no go admit di evidence bicos e go against di evidence act wey clearly state say a defendant must to make im statement in di presence of im legal representative. "I hereby order as follows: Dat di statement of di defendant dated 21 to 24 October and November 4 2015 dey inadmissible in evidence. "Dat di video recordings of di statement wey I bin don admit and marked PWQ and PWR, also dey inadmissible and hereby marked rejected," Omotosho tok. PW4 - Mr DDD Anoda DSS officer, dis witness say e work for di Imo State command between 2019 and 2022, and na im lead di team wey recover di radio transmitter wey Kanu bin allegedly import into di kontri illegally. Oga DDD say dem use ogbonge technology to geolocate one video wey Kanu bin make wia e tell im followers say dia radio transmitter don land. E say dem locate di equipment for Ubuluisiuzor Community, for Ihiala local goment area of Anambra State, for di compound of one Benjamin Madubugwu. Dem hide di transmitter inside di container and cover am wit household items like mattresses and washing machines, e tok. Dis witness also tell di court how one IPOB/ESN commander wey police arrest, bin confess say Nnamdi Kanu order dem to bury one of dia commander wey police kill wit 2000 human heads, but na 30 pipo dem don get so far bifor police arrest am. According to DDD, dis arrested Ipob member name na Uzoma Benjamin, a.k.a 'Onye Army. However, e admit say no be im interview di suspect, but na wetin di newspapers publish. Di witness tender a publication of Vanguard Newspaper of 3 July, wey contain di report. E also tok claim say na Ipob kill Ahmed Gulak bicos e disobey sit-at-home order wey Nnamdi Kanu bin declare. However, during cross-examination, one of Kanu lawyers Onyechi Ikpeazu, point out say Gulak na politician, and na im be di chairman of di primary election wey produce Uzodinma as di APC govnorship candidate for Imo State. Ikpeazu ask di witness why e be say di killers kill only Gulak, but dem no touch di driver of im vehicle and di oda passenger wey dey wit am dat time, since na all of dem disobey di sit-at-home order. E also point out say di govment of Imo State later come out to explain say di killing of Gulak dey politically motivated. PW5 - Mr EEE Dis last witness tell di court say im work na to investigate wetin happen during di End SARS nationwide protest of October 2020 for Nigeria. EEE insist say di issue of police brutality na di secondary cause of di protest, but di underlying reasons na bicos say some subversive elements, like Nnamdi Kanu, bin don dey incite di public against di goment. E tender document of dia investigation as evidence, and di document show say about 175 security officers - including policemen, army pipo and DSS pipo - bin die across di kontri during di protest. For di cross-examination, Ikpeazu ask di witness say: Shey you dey categorically tell di court say di End SARS protests na Biafran issue?" Di witness respond say "my assignment no be to investigate Biafra, my assignment na to investigate di End SARS protest to which di defendant bin incite di public." Ikpeazu den point to di report of di panel of enquiry into di End SARS protest for Lagos State, and say di report no mention Ipob or Nnamdi Kanu anywia as di pipo wey dey responsible. E also try to poke holes for di document wey Mr EEE bin tender, as e point out say di document no get di signature or stamp of di pipo wey claim say na dem write am. Also Ikpeazu point out say di document get inconsistencies, like wia e refer to Osun State as Ekiti State, and places wia details of di dead bodies of di security pipo wey dem claim say Ipob/ESN pipo kill durin End SARS no dey clear. As cross-examination end, Awomolo, counsel to di goment inform di court say dem dey close dia case for hia, as dem believe say di evidences dem provide and di witnesses dem call don dey sufficient. No-case submission Kanu Agabi, di lead defence counsel inform di court say dem go file no-case submission, since di prosecution don exhaust dia case. "Chief Awomolo get di misfortune of trying dis case, and we get di misfortune of defending am, bicos we no see any case at all for dis charges against our client," Agabi tok. E ask di trial judge to give dem some days to file dia written address on di no case submission. Justice Omotosho grant di defence team 14 days to fille dia written address, and also 14 days to di prosecution team to file dia own. Omotosho adjourn di matter to 18 July, 2025, for di two sides to come and adopt dia addresses so dat e go rule, perhaps afta Judges come back from dia annual Vacation wey dey start from late July to early September. Di Charges against Kanu Since 2015 wen di Nigeria goment first arrest Nnamdi Kanu, na only April dis year im trial start well-well. Remember say di matter bin dey bifor Justice Binta Nyako of di Federal High Court Abuja, and na she bin grant Kanu bail on health grounds in 2017, but Kanu run for im life comot for Nigeria afta soldiers bin carry out security operation for im House in Umuahia, Abia State for southeast Nigeria. In June 2021, security pipo for Kenya arrest Kanu and carry am by force come bak to Nigeria to face trial. Di initial charges against di ipob leader bin dey 15, but Justice Nyako bring am down to seven. Even though di Court of Appeal later strike out all di charges and discharge Kanu, di Supreme Court reinstated di seven charges as dem tok say di Ipob leader get questions to ansa. Here na di seven charges:

Nigeria goment close case against Ipob leader but Nnamdi Kanu lawyers wan file no-case submission
Nigeria goment close case against Ipob leader but Nnamdi Kanu lawyers wan file no-case submission

BBC News

time19-06-2025

  • Politics
  • BBC News

Nigeria goment close case against Ipob leader but Nnamdi Kanu lawyers wan file no-case submission

Lawyers to Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob), don tok say dem go file a no-case submission on top di terrorism allegation wey di Nigeria goment sama on top dia client. Kanu Agabi wey be di lead defence team for Nnamdi Kanu, tok dis one for court on Thursday afta di federal goment counsel - Adegboyega Awomolo - inform di court say dem dey close dia case. For di hearing on Thursday, Awomolo call dia fifth and final witness, Mr EEE (no be im real name), who be officer of di Department of State Services. Di witness tell di court say na im lead investigation into di impact of di End SARS protest wey bin happun for across di kontri in October of 2020, and im be di secretary of di presidential ad-hoc committee on di assessment of impact of di end sars protest. E say im and im team bin travel to all di states for Southern Nigeria wia End SARS protest bin happun and e document di public properties wey pipo destroy and di number of security personnel wey kpai during di protest. Awomolo present to di court a copy of di report of di committee, and Nnamdi Kanu lawyers say dem get objection, but dem go raise am for dia written address. Di trial Judge, James Omotosho admit di document in evidence. According to di report, a total of 128 policemen, 37 army pipo and 10 DSS pipo bin die during di protest. Also di protesters destroy a total of 164 police stations and 19 Inec facilities across di kontri. 'Nnamdi Kanu broadcasts na di major cause of End SARS protest' As e dey give im witness, oga EEE tok say dia investigation reveal say di broadcasts wey Nnamdi Kanu bin dey do ova di years, na im be di underlying cause of di insurrection. E say: "As a trained security expert, we know say evri insurrection dey get two causes, di one wey pipo dey see and di underlying cause wey pipo no see, wey be di main cause of di insurrection." During cross-examination, Onyechi Ikpeazu wey be one of Nnamdi Kanu lawyers ask di witness say: "So, di entire End SARS protest na bicos di defendant ask pipo to protest?" EEE ansa say im no know about dat but e know say di defendant bin don dey tell pipo make dem attack security officials and destroy public property. "So when pipo bin destroy properties for Osun and Lagos state during the End SARS protest, you dey tell di court say na bicos di defendant ask dem to do am? Shey you dey categorically say di End SARS issue na Biafran issue?" Ikpeazu ask. Di witness respond say "my assignment no be to investigate Biafra, my assignment na to investigate di End SARS issue to which di defendant bin incite di public." EEE insist say di issue of police brutality fit be di secondary cause of di protest, but di real reasons na bicos say some subversive elements bin don dey incite di public against di goment. Nnamdi Kanu broadcasts na one of dose underlying causes. Di defense counsel den ask for a copy of di Lagos State judicial panel of enquiry into the End SARS protest, wey dem bin don tendered in evidence as exhibit PWO. E tell di witness say: "I put it to you say dis report no mention di defendant name or di IPOB or to indict dem for di damages wey happen during di End SARS protest." Oga EEE reply say im neva read di report so e no know wetin e tok. Also during di cross examination Ikpeazu point out to di witness some discrepancies for di document including say dem no give details of di dead bodies of di security pipo wey dem claim say Ipob/ESN pipo kill durin End SARS, and di fact say neither di witness wey claim to be secretary of di investigative committee nor di chairman of di committee sign di document. Ikpeazu also point out to di witness say di part of di report wey concern oda states of di kontri, di title na 'Report of di Assessment of di damage of impact of di End SARS protest', but from page 669 wey concern states in di southeast region, di title na 'Report of di Presidential adhoc committee investigating di activities of di leader of IPOB and ESN'. "I put it to you dat for di purpose of dis trial, una manufacture pages 669 downwards of dis document and den attach am to di report of the Assessment of di damage of impact of the end SARS protest," Ikpeazu tell di witness, and e say "No, dat is not di case". Afta di cross exmaination, FG lawyer Awomolo inform di court say dem don exhaust dia materials for di trial as dem don call five witnesses and tender plenty documents in evidence, "we hereby close our case". Di lead defence counsel, Kanu Agabi tell di court say dem intend to file a no-case submission. No-case submission na legal term wey mean to say di defence team dey tok say di prosecution no do enough to establish any case against di defendant, so make di court strike out di case. Justice Omotosho give both di prosecution and defence teams 14 days each to file dia written addresses, and e adjourn di matter to Friday, 18 July, 2025, for adoption of written addresses in respect of no case submission.

Nnamdi Kanu order im fighters to bury Ipob commander wit 2000 human heads - Witness tok for court
Nnamdi Kanu order im fighters to bury Ipob commander wit 2000 human heads - Witness tok for court

BBC News

time18-06-2025

  • Politics
  • BBC News

Nnamdi Kanu order im fighters to bury Ipob commander wit 2000 human heads - Witness tok for court

Di trial of Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (Ipob), continue dis Wednesday bifor Justice James Omotosho of di Federal High Court Abuja, wia one prosecution witness tok say di proscribed organisation kill up to 200 security personnel for di southeast region. Dis witness, Mr DDD, na di fourth pesin wey di Nigeria goment dey call since di trial begin, and im na official of di Department of State Services, DSS wey work for Imo State betwnee 2019 and 2022. E also narrate to court how DSS use some ogbonge digital tools to geolocate and recover di radio transmitter wey Kanu bin allegedly import into di kontri. Dem later locate di container for di house of one Benjamin Madubugwu for one community for Ihiala in Anambra State wey im name na Ubuluisiuzor. "Di transmitter dey inside container, but dem use oda household items like mattresses, washing machine and oda tins to cover am," Mr DDD tok. DSS also search di house of Madubugwu and recover two pump action guns for im bedroom, so dem arrest am. According to di DSS witness, Madubugwu tell dem say one man - Igwe Anyiba - bin beg am to keep di container for im house, and e go keep di empty container afta di owner collect wetin dey inside. Mr DDD also say wen dem arrest Nnamdi Kanu, dem bring am face to face to Benjamin Madubugwu, and Kanu admit bifor am say na im get di container and di transmitter. However, during cross examination, Onyechi Ikpeazu who be one of Kanu lawyers tell di court say na one Denca clearing and forwarding agency bin import and clear di container from di port, no be Nnamdi Kanu. Kanu order im fighters to bury dia commander wit 2000 human heads Also during im testimony, Mr DDD tell di court about one Ipob commander - Benjamin Uzoma, a.k.a Onye Army - wey police arrest and e confess to plenty crime wey e bin commit. Adegboyega Awomolo, lawyer of di Federal Goment, present di court one Vanguard Newspaper of July 3, 2021 wey contain di report of di arrest. For inside di newspaper article, di suspect - Onye Army - confess say Nnamdi Kanu order dem to use 2000 human heads to bury one of dia commander Iko Nso, wey police bin kill, and so far, dem bin don kill 30 pipo bifor police arrest am. Also, di publication quote say Onye army also confess say Nnamdi Kanu order dem to kill security officials, members of di Eastern Security Network (ESN) use 10 virgins to do juju to protect diasef, and say ESN and Ipob fighters na di pipo wey attack di Imo State Prison. Mr DDD tok say di DSS bin wan interview di suspect but police tell dem say e don escape from custody and dem neva find am reach now. Di witness also narrate how DSS officials conduct raids for Ipob camps inside Orsu for Imo State and Lilu for Anambra State, wia dem kill some ESN fighters but also find out say di Ipob fighters dey engage in cannibalism to fortify diasef. In total, Mr DDD say di number of security officials wey Ipob/ESN pipo bin kill for di region na between 170 and 200, including Police pipo, Immigration pipo, DSS pipo, Civil Defence pipo and Army pipo. E say for one instance, di group attack one police station for Njaba, kill evribodi dia and start to dey use di station as dia base; e hard bifor security pipo pursue dem from dia. "Dis Ipob pipo dey always move in large numbers, dem dey carry arms, dem go block road and snatch cars from pipo to take go operation, and sometimes, dem dey inform communities say dem go attack," di witness tok. Mr DDD also tell court say na Ipob/ESN fighters kill Ahmed Gulak, a chieftain of di All Progressives Congress (APC) who bin visit Imo State on di invitation of di Govnor, Hope Uzodinma. E say dem kill am on May 30, wey be di day Kanu order sit-at-home. However, during cross-examination, Onyechi Ikpeazu, one of Kanu lawyers point out say Gulak na politician, and na im be di chairman of di primary election wey produce Uzodinma as di APC govnorship candidate for Imo State. Ikpeazu ask di witness why e be say di killers kill only Gulak, but dem no touch di driver of im vehicle and di oda passenger wey dey wit am dat time. E also point out say di govment of Imo State later come out to explain say di killing of Gulak dey politically motivated. Ikpeazu also ask di witness weda e hear di broadcast wia Nnamdi Kanu dey condemn attacks on public facilities like markets, churches, mosques, etc, and DDD say e hear am. Di witness bin don tok earlier say Kanu broadcasts show say e hate anybodi wey no be Igbo, but Ikpeazu ask am weda Ipob attack di Yoruba and Hausa communities for Onitsha in Anambra State, and e say no. Afta di cross-examination, Justice Omotosho adjourn di matter to Thursday, 19 June, 2025 for continuation and for di prosecution to possibly close dia case. Di charges against Nnamdi Kanu Dis na di seven-count charges wey di Nigeria goment bin sama against Nnamdi Kanu:

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store