
Timeline of how Nnamdi Kanu terrorism trial don go since new judge take over
Dem tok dis one afta di federal goment close dia case for di trial afta dem don call five witnesses and tender plenty documents as exhibits including video and audio broadcasts wey dem say Kanu bin make.
Nigeria goment dey try Kanu on terrorism allegations. Dem say e terrorise pipo by issuing illegal sit-at-home orders, and by telling im followers to attack and kill police.
Kanu plead not gulity to di charges.
Dis na di summary of how di matter take reach dis stage since Justice James Omotosho take over from Justice Binta Nyako:
Re-arraignment... Kanu plead no guilty
Di matter start afresh on 21 March, 2025 as di Nigeria goment re-arraign Kanu on seven counts of terrorism, belonging to a terrorist group, and illegal importation of radio equipment. Kanu plead not guilty.
On dat day, our tori pesin wey don dey cover dis trial since 2019, notice say Kanu don change im lead counsels and employ ogbonge senior advocates like di former Attorney General of di Federation and Minister of Justice, Kanu Agabi; Onyechi Ikpeazu, Emeka Etiaba, Paul Erokoro and so.
Bifor dis time, Kanu lead counsel na Ifeanyi Ejiofor and Aloy Ejimakor, and later Mike Ozekhome (SAN) join dem for some time bifor dem withdraw am again.
On di day of re-arraignment, Kanu Agabi apologise to di court for how Nnamdi Kanu bin para for Justice Nyako and di FG lawyer, Adegboyega Awomolo during di previous hearings.
Justice Omotosho accept di apology as e tok say e understand say di defendant bin tok out of anger sake of say di case don last for ten years now.
"As I dey look di case file, I see say dis matter start wen di defendant dey 45 years old, now e dey 55 years, so I understand im anger. Dat na why I go grant accelerated hearing for dis matter," Omotosho tok.
And true-true, e grant accelerated hearing.
PW1 - Mr AAA
For di next adjourned date - 29 April, 2025, di Nigeria goment call dia first prosecution witness, Mr AAA (no be im real name).
All di goment witnesses testify using codenames AAA to EEE for di five witnesses, sake of say dem dey work wit di Department of State Services (DSS), wey be Nigeria secret security outfit. Di court also permit dem to testify behind cover and for dem to also wear mask.
Mr AAA na di officer wey lead di arrest of Nnamdi Kanu for 2015. Dem arrest am for one hotel close to di Lagos International Airport.
Di witness tok say dem arrest Kanu wit one woman for im room, and dem recover plenty broadcasting equipment for im hand, but during cross-examination, e confirm say dem no find any terrorism equipment wit am.
E tender videos of statement wey Kanu bin make for di DSS headquarters in Abuja afta dem transport am from Lagos. For dat video, im lawyer Aloy Ejimakor and one oda lawyer dey dia.
Di witness also tender in evidence two boxes containing Kanu personal belongings like shoes, wrist-watches, and perfumes, plus some broadcasting equipment like microphones, tripods, laptops, ipads, and internet modems.
PW2 - Mr BBB
Di second prosecution witness - Mr BBB start im own testimony on 7 May, 2025.
E tok say im na one of di lead officers wey investigate Nnamdi Kanu, afta di den AGF Abubakar Malami, write a petition to DSS complaining of di broadcasts wey di Ipob leader dey make on social media using Radio Biafra.
Dis witness tender video evidence wia Nnamdi Kanu announce di creation of di Eastern Security Network (ESN), and wia e threaten Bola Tinubu and say e go destroy im properties for Lagos.
Mr BBB also say dia investigation show say Nnamdi Kanu broadcasts dey directly connected to di violence and killings wey dey go on for di southeast region.
E also tender as exhibit, di death certificate of Ahmed Gulak, wey be chieftain of di All progressives Congress (APC) wey jaguda pipo bin kill for Owerri Imo State on 30 May, 2021.
Di witness claim say na Ipob fighters kill Gulak sake of say e disobey di sit-at-home order wey Kanu bin give for dat May 30 - a day wey Ipob dey mark as Biafra Remembrance Day.
During cross-examination, BBB deny say no be DSS pipo arrest Kanu for Kenya. E say dia work no dey cross outside Nigeria.
Also, Kanu lawyers tender video evidence of di Govnor of Imo State as e tok say Ipob no dey responsible for di killings for di state, rather na politicians dey do am.
Dem also play videos of retired Major General for di Nigeria Army, T.Y Danjuma, and di current Director-General of di DSS Adeola Ajayi wia dem dey tell di public make dem rise up and defend diasef from terrorists and bandits
PW3 - Mr CCC
Dis witness na also one of di officers wey bin investigate Kanu wen dem arrest am from 2015.
E tok say im and two oda DSS officers bin interview Kanu on October 21, 22, 23 and 24, and again on November 4 of dat 2015, and e present di video recording of dat interview to be tendered as evidence.
However, one of Nnamdi Kanu lawyers, Paul Erokoro inform di court say Kanu tell am say im bin dey under duress wen e make di statement.
Prosecution lawyer say no be true, say Kanu make di statement voluntarily witout any force.
To determine weda to accept di video in evidence, Justice Omotosho order for trial within trial.
Dem play di video for court and e show say Kanu bin complain several times say e dey entitled to a lawyer but di DSS no wan give am im lawyer.
Justice Omotosho rule say e no go admit di evidence bicos e go against di evidence act wey clearly state say a defendant must to make im statement in di presence of im legal representative.
"I hereby order as follows: Dat di statement of di defendant dated 21 to 24 October and November 4 2015 dey inadmissible in evidence.
"Dat di video recordings of di statement wey I bin don admit and marked PWQ and PWR, also dey inadmissible and hereby marked rejected," Omotosho tok.
PW4 - Mr DDD
Anoda DSS officer, dis witness say e work for di Imo State command between 2019 and 2022, and na im lead di team wey recover di radio transmitter wey Kanu bin allegedly import into di kontri illegally.
Oga DDD say dem use ogbonge technology to geolocate one video wey Kanu bin make wia e tell im followers say dia radio transmitter don land.
E say dem locate di equipment for Ubuluisiuzor Community, for Ihiala local goment area of Anambra State, for di compound of one Benjamin Madubugwu.
Dem hide di transmitter inside di container and cover am wit household items like mattresses and washing machines, e tok.
Dis witness also tell di court how one IPOB/ESN commander wey police arrest, bin confess say Nnamdi Kanu order dem to bury one of dia commander wey police kill wit 2000 human heads, but na 30 pipo dem don get so far bifor police arrest am.
According to DDD, dis arrested Ipob member name na Uzoma Benjamin, a.k.a 'Onye Army. However, e admit say no be im interview di suspect, but na wetin di newspapers publish.
Di witness tender a publication of Vanguard Newspaper of 3 July, wey contain di report.
E also tok claim say na Ipob kill Ahmed Gulak bicos e disobey sit-at-home order wey Nnamdi Kanu bin declare.
However, during cross-examination, one of Kanu lawyers Onyechi Ikpeazu, point out say Gulak na politician, and na im be di chairman of di primary election wey produce Uzodinma as di APC govnorship candidate for Imo State.
Ikpeazu ask di witness why e be say di killers kill only Gulak, but dem no touch di driver of im vehicle and di oda passenger wey dey wit am dat time, since na all of dem disobey di sit-at-home order.
E also point out say di govment of Imo State later come out to explain say di killing of Gulak dey politically motivated.
PW5 - Mr EEE
Dis last witness tell di court say im work na to investigate wetin happen during di End SARS nationwide protest of October 2020 for Nigeria.
EEE insist say di issue of police brutality na di secondary cause of di protest, but di underlying reasons na bicos say some subversive elements, like Nnamdi Kanu, bin don dey incite di public against di goment.
E tender document of dia investigation as evidence, and di document show say about 175 security officers - including policemen, army pipo and DSS pipo - bin die across di kontri during di protest.
For di cross-examination, Ikpeazu ask di witness say: Shey you dey categorically tell di court say di End SARS protests na Biafran issue?"
Di witness respond say "my assignment no be to investigate Biafra, my assignment na to investigate di End SARS protest to which di defendant bin incite di public."
Ikpeazu den point to di report of di panel of enquiry into di End SARS protest for Lagos State, and say di report no mention Ipob or Nnamdi Kanu anywia as di pipo wey dey responsible.
E also try to poke holes for di document wey Mr EEE bin tender, as e point out say di document no get di signature or stamp of di pipo wey claim say na dem write am.
Also Ikpeazu point out say di document get inconsistencies, like wia e refer to Osun State as Ekiti State, and places wia details of di dead bodies of di security pipo wey dem claim say Ipob/ESN pipo kill durin End SARS no dey clear.
As cross-examination end, Awomolo, counsel to di goment inform di court say dem dey close dia case for hia, as dem believe say di evidences dem provide and di witnesses dem call don dey sufficient.
No-case submission
Kanu Agabi, di lead defence counsel inform di court say dem go file no-case submission, since di prosecution don exhaust dia case.
"Chief Awomolo get di misfortune of trying dis case, and we get di misfortune of defending am, bicos we no see any case at all for dis charges against our client," Agabi tok.
E ask di trial judge to give dem some days to file dia written address on di no case submission.
Justice Omotosho grant di defence team 14 days to fille dia written address, and also 14 days to di prosecution team to file dia own.
Omotosho adjourn di matter to 18 July, 2025, for di two sides to come and adopt dia addresses so dat e go rule, perhaps afta Judges come back from dia annual Vacation wey dey start from late July to early September.
Di Charges against Kanu
Since 2015 wen di Nigeria goment first arrest Nnamdi Kanu, na only April dis year im trial start well-well.
Remember say di matter bin dey bifor Justice Binta Nyako of di Federal High Court Abuja, and na she bin grant Kanu bail on health grounds in 2017, but Kanu run for im life comot for Nigeria afta soldiers bin carry out security operation for im House in Umuahia, Abia State for southeast Nigeria.
In June 2021, security pipo for Kenya arrest Kanu and carry am by force come bak to Nigeria to face trial.
Di initial charges against di ipob leader bin dey 15, but Justice Nyako bring am down to seven.
Even though di Court of Appeal later strike out all di charges and discharge Kanu, di Supreme Court reinstated di seven charges as dem tok say di Ipob leader get questions to ansa.
Here na di seven charges:
Hashtags

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


Reuters
43 minutes ago
- Reuters
Bandits kill at least 27 in northern Nigeria mosque attack, officials say
MAIDUGURI, Nigeria, Aug 19 (Reuters) - At least 27 worshippers were killed and several injured early on Tuesday when armed bandits stormed a mosque in northern Nigeria's Katsina state during morning prayers, the village head and a hospital official said. Gunmen opened fire inside a mosque as Muslims gathered to pray at around 04:00 GMT in the remote community of Unguwan Mantau in Malumfashi local government area, residents said.


Sky News
2 hours ago
- Sky News
By Alex Crawford, special correspondent, in Somalia The roof of the cave where Islamic State militants sat cooking their food is still charred black. We see porcupine quills scattered around, giving an indication of what the extremists last ate here. There's a rough toilet, sleeping areas and a treasure trove of evidence about their lives on recovered phones and SIM cards. Porcupine quills litter the floor - evidence of a meal Porcupine quills litter the floor - evidence of a meal
We are standing in the same spot where Islamic State militants were camped very recently – and where they held territory and ruled over the terrified communities below. These are just some of the hundreds of caves and mountain hideouts the Somali forces have discovered and routed in their offensive against the militants who've set up base in the north of the country. The semi-autonomous region of Puntland in northern Somalia is the unlikely global headquarters of a resurgent Islamic State, according to the Somalis and US commanders. The evidence the Somali soldiers are uncovering points to a terror group that has evolved, adapted and is able to operate from remote mountain caves with devastating effect. ISIS once held swathes of land in Iraq and Syria right up until 2019. The international community believed it had been crushed or at least critically wounded, but it is still very much alive and operating in northern Somalia...


BBC News
4 hours ago
- BBC News
Gayton McKenzie: South Africa minister mired in racism row over offensive language
Brash, controversial and unafraid to speak his mind, South Africa's Sports, Arts and Culture Minister Gayton McKenzie has been swift to call out racism in others but he himself has now been branded a racist - a charge he is often seen as the lightning rod for the frustrations of the country's coloured community, as people of mixed heritage are referred to in South Africa's population old comments McKenzie made on social media, using a profoundly offensive term referring to black people, have created a political has until the end of Wednesday to respond to the South African Human Rights Commission (SAHRC), which wants the minister to delete the offensive posts and issue a public apology, among other demands."Coloured" was the classification given to people of mixed heritage under apartheid. This system created a legally enforced racial hierarchy that saw white people at the top and black people at the bottom, with Indians and coloured people in apartheid being abolished three decades ago and the promotion of the "rainbow nation", its bitter legacy lives on in the country's economy and politics. The ex-gangster who has become South Africa's sports ministerTyla's racial identity: South African singer sparks culture war McKenzie's Patriotic Alliance (PA) has attracted support among coloured people, winning parliamentary representation in elections last year. "For the first time there is coloured people also going to parliament through the Patriotic Alliance," McKenzie said, after the results were Cyril Ramaphosa included the PA in his multi-party coalition government after his African National Congress (ANC) lost its parliamentary majority for the first time. The ANC sees McKenzie as useful way to counter the second-biggest party, the Democratic Alliance (DA), in the campaign for the coloured vote, and to address perceptions of marginalisation within the coloured group makes up about 8% of South Africa's population. The politician has positioned himself as the outspoken defender of their is a feeling expressed by some in the community that under apartheid they were not white enough and now in the new era they are not black latest row blew up in July after McKenzie took a popular podcast, Open Chats, hosted by a group of young black people, to task for derogatory remarks they made about coloured clip has since been deleted from the episode, but it did not stop some in the coloured community from going after the show's hosts over the saga.A criminal complaint was filed with the police and the matter was referred to the SAHRC for further investigation. The commission's role is to address human rights violations and seek "effective redress"."There should be no place to hide for racists. [Whether] you are a white, black [or] coloured racist, a racist remains a racist," McKenzie said at the height of his then the social media archaeologists got to work. In the posts from over a decade ago on what was then known as Twitter, he repeatedly used the highly offensive "K-word" when speaking about black "K-word" was the most vicious racial slur used to humiliate black people during the apartheid years. It is a symbol of says he regrets the posts but has also robustly defended himself, most recently in a lengthy live video posted on his Facebook page."I always saw myself as black growing up... [so] I'm black and coloured, I'm mixed," he said looking down the barrel of the minister has described himself as a "black-skinned coloured" whose father was a mix of Japanese and Irish and mother is a black woman from the Sotho of this, he added, when he speaks of black people he is including himself in the also detailed how he had been part of the anti-apartheid reflects the view that as the fight against apartheid gained momentum, coloured people and Indians campaigned with black people against the racist understood that "if you don't unite South Africa at a struggle level, your chances of taking over and democratising the country are very limited", the North West University's professor of government studies Kedibone Phago said. But despite the struggle bringing together different groups and then the end of apartheid itself, racial classification has remained embedded in the the majority of the population, where they live, what kind of job they have, or indeed if they have a job, and their wealth, is still largely related to which apartheid-defined race they belong is because, among other reasons, the apartheid geography that separated different races "is still very strong", Prof Phago told the BBC."We just don't know each other at all … [or] each other's culture and habits [so] when people call us the rainbow nation, it's just nonsense. Very few people socialise across racial barriers," Terry Oakley-Smith, who founded the South African diversity consultant firm Diversi-T, beginning of democracy in 1994 did not wipe out racism, but "what's unusual about this case is that it's about a so-called coloured person using that sort of language and remarks", Ms Oakley-Smith experts also raised concerns how the podcast presenters expressed themselves. "They were terribly disappointing," Ms Oakley-Smith said. Ghosts of apartheid haunt South Africa as compensation anger brewsRace in South Africa: 'We haven't learnt we are human beings first' There has been a long-standing feeling in sections of the coloured community that in an effort to tackle the problems from the past, the democratic government has ignored their echoed this in 2023."Coloured people woke up in the new South Africa and found legislation that makes it clear that they are not Africans," he was quoted as saying."A clear racist separation by the ANC government. How do you even explain that because coloureds and blacks fought side by side in the struggle for freedom?"But Prof Phago argued that this is about different communities looking for something to blame for broader pointed to the government's failure to take the lead in the necessary "societal transformation"."This is a very strong systemic problem that needs a strong developmental state to deal with because if we don't find a way... we'll continue to have these kind of problems."Ms Oakley-Smith echoed this, saying that this latest racial storm showed "there's a lot more that needs to be done to improve race relations"."We have so much work to do... [and] unless we take some actions, these things are going to continue," she sports, arts and culture portfolio is supposed to promote things that bring the country together. Ironically, his divisive historical comments and his refusal to apologise has rallied citizens in the call for tougher conversations around race he will now have to wait to see what the SAHRC will do next - and whether President Cyril Ramaphosa will keep him in the government. More BBC stories on South Africa: Caught in the crossfire - the victims of Cape Town's gang warfareIs there a genocide of white South Africans as Trump claims?Do Afrikaners want to take Trump up on his South African refugee offer? Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica