logo
#

Latest news with #PiusAkinyuelure

Who dey in and who dey out as Tinubu sack NNPCL oga Mele Kyari
Who dey in and who dey out as Tinubu sack NNPCL oga Mele Kyari

BBC News

time02-04-2025

  • Business
  • BBC News

Who dey in and who dey out as Tinubu sack NNPCL oga Mele Kyari

Nigerian President Bola Tinubu don sack di chairman of di board of Nigerian National Petroleum Company Limited, (NNPCL) board Chief Pius Akinyuelure and di group CEO Mallam Mele Kyari plus di oda board members wey im appoint for November 2023. E replace di team wit Engineer Bashir Bayo Ojulari as group CEO and Ahmadu Musa Kida as non-executive chairman as dia appointment dey start immediately. For statement wey di State House release on Wednesday, President Tinubu dey expect say di new board go increase NNPC share of crude oil refining output to 200,000 barrels by 2027 and 500,000 barrels by 2030. E say di board restructuring bin dey important to ginger operational efficiency, restoreinvestor confidence, boost local content, drive economic growth and advance gas commercialisation and diversification. Di oda members of di new board include: Adedapo Segun wey bin dey work as chief financial officer since November. E also appoint non-executive directors wey go represent di kontri geopolitical zone. Dem include: Bello Rabiu for North West, Yusuf Usman for North East, Babs Omotowa for North Central, Austin Avuru for South-South, David Ige for South Wesr and Henry Obih for South East. Oda members for di new board na di permanent secretary of di Federal Ministry of Finance, Mrs Lydia Shehu Jafiya wey go represent di ministry for di board and Aminu Said Ahmed wey go represent di Ministry of Petroleum Resources for di board.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store