logo
#

Latest news with #Tuface

Why di word 'allegedly' dey totori many Nigerians - how e take start and wetin e mean
Why di word 'allegedly' dey totori many Nigerians - how e take start and wetin e mean

BBC News

time08-03-2025

  • Entertainment
  • BBC News

Why di word 'allegedly' dey totori many Nigerians - how e take start and wetin e mean

Di word 'allegedly' become like a spreading fire for Nigeria especially for social media and you go wonder wia di history of dis word come from. Imagine thousands of pipo wey use a particular word and dem still dey confuse on wetin di word mean for real life. Allegedly na word wey don dey in use for plenti years bifor di birth of so many pipo, including dose wey even use am catch cruise for social media. For Nigeria social media space, pipo begin dey add di word 'allegedly' to posts and comments wey dem make, even wen di sentence no need to get di word 'allegedly' in between. But e get why. We go break down dis word for you, wetin e mean and who even start am for Nigeria bifor e begin dey go viral for social media. Now listen, no be say we wan 'allegedly' break down dis word for your fun but wit our full chest we go tell you evritin you gatz know about di word including di history. Witout big grammar, allegedly mean say you want tok somtin or make a claim but you no fit use your full chest tok am becos you no get evidence, so you hide under di word like say na hearsay. Di word 'allegedly' dey common for media and gossip blogs wen dem no too dey sure about a case but dem report am based on say no court don rule or give verdict ontop di matter. Na legal term wey mean a claim wey neva get proof or wey dey wait for evidence to confam if na true or not. Who start am? Now, no be say di word 'allegedly' dey new for Nigeria or dem neva hear am bifor, but in recent days, di word find imsef dey trend for social media. So, who start am and how e take start? Make we narrate give you. Remember say one saga bin takeova Nigeria for a little period wen popular Nigerian music icon Innocent Idibia wey pipo sabi as Tuface bin come out to tok about divorce mata of im wife, Annie Idibia. For Sunday, 26 January, 2025, na shock and surprise bin meet di fans of Tuface wen e reveal say im and im wife of ova 10 years don separate for sometimes now and dem dey wait for divorce. Dis announcement na ontop Instagram e drop am and di mata go far as both blogs and mainstream media for Nigeria report di mata. Calm down for di next drama wey sup. Immediately, afta di divorce saga bin come, anoda report kon say Tuface don find anoda woman wey e wan marry. And e publicly release video to tok about am. Na dia plenti tori dey fly upandan wit bloggers wey begin dey 'allege' so many tins say Tuface newly found lover na di reason why e dey divorce im oda wife. Plenti blogs and bloggers begin dey use di word 'allegedly' to describe wetin dey happun for Tuface life, im divorce mata and di new lover. Again, Tuface set ring light to address di mata. Na here e first start dey use di word 'allegedly'. For di first two sentences wey e tok for di video, e say, "So allegedly I don dey see so many tins." You go dey wonder why pesin dey use di word 'allegedly' for im own mata, but na wetin social media don use im eyes see be dat. Full words of wetin Tuface tok for im video wey make di word 'allegedly' begin go viral for social media: "Hey my pipo wetin dey sup? So allegedly I don dey see so many tins. So many pipo dey come up wit dia own false narratives and malicious nonsense afta I post wetin I post. Yes, I post wetin I post and any pesin wey get brain go understand." "For all of di pipo wey dey tok different stuff but dem no get absolute clue about wetin dey go on, I hail una oh, una life perfect die. See evribodi go dey alright, fight no dey, quarrel no dey - I tok wetin I tok." "I see evribodi allegedly trying to put her in to di mata." "So, allegedly evribodi wey dey tok stuff allegedly, keep alleging, we go continue alleging. You dey allowed to put mouth and tok wetin you feel, but please wen you wan allege make sure say you sabi wetin you dey allege. I go ask Congress to do somtin ontop dis alleging." "Evribodi dey hide behind allege to just say anytin wey dem wan tok, embarrassing pipo upandan. We gatz do somtin ontop dis allege, if you no sabi somtin, no tok am, no even quote pesin. I don give una food again, make una continue to dey allege. We go meet for somwia." Dis na di beginning of how social media pipo take carry di mata turn into a viral slang for comment sections and posts wey dem make. You go see pesin dey comment for anoda pesin post dey tell am say 'you no dey add allegedly oh'. Now you know who start di use of 'allegedly' wey Nigeria pipo for social media begin dey add to evri comment, although, di word no new. Origin of di word 'allegedly' According to Merriam Webster, di first known time wey dem use di word 'alleged' na for 1509, while Oxford English Dictionary say di first use of di word 'alleged' na from around 1425. Alleged na di adjective of allegedly. Allegedly na adverb. More digging show say di word 'allegedly' first begin dey in use from di 1800s. Allege, alleged, allegedly and allegation na from same family of words wey come from di Latin verb around 1300. Di Latin verb na allēgāre, wey mean to "bring forward as evidence." Dis word dey used in legal terms wey you dey make accusation wey neva dey proven for any court of law. Oda forms wey dey related to allegedly: Wetin law tok about am? We carry dis mata go meet legal pipo to know weda if pesin use 'allegedly' for any accusation, law go fit catch am. Some pipo dey tink say using 'allegedly' go save dem from lawsuit. Well, dey play. Lawyers tell us say even if you use di word, di law still fit carry you go prison for defamation. According to constitutional lawyer and Partner at FOLegal, Festus Ogun, e say di word 'allegedly' no fit completely save pesin from defamation lawsuit. E add say if pesin make allegation wey dey false and dey use allegedly cover up, di pesin no dey safe. "Spreading a knowingly false information under di guise of "allegedly" no go save a defendant from legal liability." Dis mean say pesin fit do jail, even though e use allegedly defame anoda pesin character. Anoda legal sabi pesin, A.B Mutairu, say di word allegedly gain popularity for social media as pipo dey tink say e go protect dem from defamation. E add say na di intent mata, no be di form wey di word take come. "Di usage of di word allegedly no go save one from being sued for defamation. Di law no dey work like dat. "Pesin no fit tok somtin knowing fully well say dat kain tin na lie and yet rely on di word allegedly as a cover up. If your statement dey defamatory, allegedly no fit save you," Ogun tok. Gbam, now you don hear am - even if you use di word 'allegedly' for your allegations, e no go save you from lawsuit.

Who be Natasha Osawaru wey Tuface dey tok about?
Who be Natasha Osawaru wey Tuface dey tok about?

BBC News

time12-02-2025

  • Entertainment
  • BBC News

Who be Natasha Osawaru wey Tuface dey tok about?

Di controversy around Nigeria music star, Innocent Idibia wey pipo dey call 'TuFace Idibia' relationship don kontinu to ginger reactions from fans and critics. Video of wia Tuface siddon for di gallery of di Edo state house of assembly circulate on Monday. Di Nigerian singer no tok anytin for di video wey make pipo tink say e get connection wit one of di Lawmakers Natasha Osawaru. All dis dey happun weeks afta Tuface announce im separation from Anie Macaulay Idibia, im wife of ova 10 years. E make di announcement for inside one post e share on im Instagram account. E don since delete di video. "Well dis tin wey I wan tok dey short but also long. I and Annie Macaulay don separate for a while now. And currently filed divorce," Tuface tok. For di post, di 49-year-old singer promise to release a statement soon to share im side of di tori. E add say while im personal life dey private, e feel say e dey necessary to provide clarity out of love for im supporters. But aft aim video for Edo assembly complex go viral, Tuface release anoda three minutes video to addresss wetin e say n aim relationship wit di lawmaker, Natasha Osawaru. For di video wey e caption "To Whom It May kwansighn. I don yarn my truth. Feel free to kontinu to allege, We go all dey alright," e tok in defence of di politician.

Nigerian star 2Baba announces separation from wife
Nigerian star 2Baba announces separation from wife

Yahoo

time27-01-2025

  • Entertainment
  • Yahoo

Nigerian star 2Baba announces separation from wife

Popular Nigerian musician and performer Innocent Idibia, widely known as 2Baba or Tuface, has announced his separation from his wife, Annie Idibia. One of Nigeria's biggest celebrity couples, Annie and Tuface got married in 2012 and had two daughters together. In a post on Instagram, the African Queen singer said they had been separated for some time and had taken steps toward a divorce. The post was later deleted but 2Baba then released a video to confirm that its contents were accurate. The singer is seen as being one of the pioneers of the Nigerian music scene that is now popular around the world, paving the way for musicians like Wizkid, Davido and Burna Boy. The couple had a star-studded wedding ceremony in 2013, an event which was widely followed in Nigeria even though it took place in Dubai. The star is still widely known as Tuface even though he announced in 2014 that he had changed his name to 2Baba. News of the separation has shocked fans and admirers across the continent as the couple had overcome previous problems and are one of Nigeria's longest-lasting celebrity couples. The former Plantashun Boyz member says he plans to hold a press conference to provide more details, adding that he is committed to sharing his perspective directly with his supporters and music lovers around the globe. "I and Annie Macauley have been separated for a while now, and currently filed for divorce," he said in the Instagram post. In a bizarre twist, the post was deleted minutes later, followed by another saying the account had been hacked. But 2Baba then went live on his Instagram account to confirm his initial post about the separation. "No-one hacked my account, I said what I said, I come in peace," he said in the video. The couple have also cut ties on social media, unfollowing each other on their respective platforms, backing the performer's statement about their split. In the video of his most popular song, African Queen, Annie played his love interest and it is believed that their relationship blossomed from there. Fuel tanker explosion kills dozens of people in Nigeria 'We dig graves for free, like our fathers did before us' The Nigerian watch-lover lost in time 'I've been sleeping under a bridge in Lagos for 30 years' Go to for more news from the African continent. Follow us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica Africa Daily Focus on Africa

Tuface: Nigeria's 2Baba announces separation from Annie Idibia
Tuface: Nigeria's 2Baba announces separation from Annie Idibia

BBC News

time27-01-2025

  • Entertainment
  • BBC News

Tuface: Nigeria's 2Baba announces separation from Annie Idibia

Popular Nigerian musician and performer Innocent Idibia, widely known as 2Baba or Tuface, has announced his separation from his wife, Annie of Nigeria's biggest celebrity couples, Annie and Tuface got married in 2012 and had two daughters a post on Instagram, the African Queen singer said they had been separated for some time and had taken steps toward a post was later deleted but 2Baba then released a video to confirm that its contents were accurate. The singer is seen as being one of the pioneers of the Nigerian music scene that is now popular around the world, paving the way for musicians like Wizkid, Davido and Burna couple had a star-studded wedding ceremony in 2013, an event which was widely followed in Nigeria even though it took place in star is still widely known as Tuface even though he announced in 2014 that he had changed his name to of the separation has shocked fans and admirers across the continent as the couple had overcome previous problems and are one of Nigeria's longest-lasting celebrity former Plantashun Boyz member says he plans to hold a press conference to provide more details, adding that he is committed to sharing his perspective directly with his supporters and music lovers around the globe."I and Annie Macauley have been separated for a while now, and currently filed for divorce," he said in the Instagram a bizarre twist, the post was deleted minutes later, followed by another saying the account had been 2Baba then went live on his Instagram account to confirm his initial post about the separation."No-one hacked my account, I said what I said, I come in peace," he said in the couple have also cut ties on social media, unfollowing each other on their respective platforms, backing the performer's statement about their the video of his most popular song, African Queen, Annie played his love interest and it is believed that their relationship blossomed from there. More Nigeria stories from the BBC: Fuel tanker explosion kills dozens of people in Nigeria'We dig graves for free, like our fathers did before us'The Nigerian watch-lover lost in time'I've been sleeping under a bridge in Lagos for 30 years' Go to for more news from the African us on Twitter @BBCAfrica, on Facebook at BBC Africa or on Instagram at bbcafrica

How fans and celebrities react to Tuface and Annie Idibia separation
How fans and celebrities react to Tuface and Annie Idibia separation

BBC News

time27-01-2025

  • Entertainment
  • BBC News

How fans and celebrities react to Tuface and Annie Idibia separation

Shock, disbelief, sadness, relief, na how some fans, celebrities and concerned pesins take react afta Nigeria famous music icon, Innocent Idibia announce separation from im wife, Annie Idibia. On Sunday, 26 January, di music star wey pipo sabi well-well as Tuface reveal say im and im wife of ova 10 years don separate for sometimes now and dem dey wait for divorce. E announce di informate for inside one post e share on im Instagram account. "Well dis thing wey I wan tok dey short but also long. I and Annie Macaulay don separate for a while now. And currently filed divorce." For di post, di 49-year-old singer promise to release a statement soon to share im side of di tori. E add say while im personal life dey private, e feel say e dey necessary to provide clarity out of love for im supporters. "Hello to my beautiful pipo of all federations. Well, dis thing I wan tok dey short but also long. Annie Macaulay and I don dey separated for a while and don file for divorce. "I go grant press release soon to say my story—no be becos na anyone right to know about my personal life, but becos I love my pipo, and I need dem to know my innocence or offence. Stay blessed, my pipo. I love you all," di singer add for di now deleted post. Drama afta viral separation post Di post wey announce di separation and probably divorce of these love birds wey dia grand wedding for 2013 shake di kontri, bin shock some of dia fans, while odas say, di separation dey long overdue. However, within minutes afta di post go viral, Tuface for anoda post on im Instagram page claim say im account dey hacked and dem dey try to get am back. "My Instagram don dey hacked; wey dey put effort to try take back control. #One Love." As fans dey rejoice and deliberate on di authenticity of di post, Tuface for anoda video, almost immediately post again for im Instagram account say nobody hack im account. "Hey, my pipo nobody hack my account; I tok wetin I tok. I come in peace." As at Monday, 27 January morning, BBC Pidgin check say e don delete most of di post on im Instagram account, wey include fotos of im and im wife. Social media divide ova Tuface marriage separation Annie wey don dey for spotlight recently, afta her appearance on di latest season of "Young, Famous and African," where she open up on issues for her life, especially on di miscarriage she get last year wey lead to di loss of twins neva react to di news of di separation. However, separation of di lovebirds don turn hot gist for street and for social media. Dis na as celebrities and fans don begin take sides and apportion blame. While some hope say make di two go make up and get back togeda, odas believe say dis fit be di right thing for di couple wey don weather many storms togeda. Di long road of love 2Baba as pipo often dey call am and Annie relationship start for sometimes around 1999 as friendship wey later turn into love. Annie enta public eye wen she appear for Tuface popular song "African Queen" music video for 2004. Dem welcome dia first daughter, Isabella, for 2008. For 2012, 2Baba propose to Annie on Valentine's Day and dem do one private wedding di same year. Dia grand white wedding wey be tok of town bin follow for Dubai on 23 March 2013, and dem welcome dia second daughter, Olivia, for 2014. Dia relationship and marriage face plenty challenges, particularly sake of 2Baba past relationship wit Pero Adeniyi, di mother of three of im children. E also get two children wit anoda woman, Sumbo Adeoye. Despite tensions and public controversies, di couple bin renew dia vows for 2022 for dia 10th wedding anniversary. Dem reaffirm dia love and commitment to di marriage. Tuface and Annie na one of Nigeria most admired celebrity couples. Who be Innocent Idibia?

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store