logo
#

Latest news with #WilliamEkong

Nigeria vs Zimbabwe - All you need to know
Nigeria vs Zimbabwe - All you need to know

BBC News

time24-03-2025

  • Sport
  • BBC News

Nigeria vs Zimbabwe - All you need to know

Nigeria coach Eric Chelle begin im reign wit Super Eagles wit a 2-0 victory against Rwanda. Victor Osimhen score two goals for di match to guarantee dia three points. On Tuesday evening, Nigeria go host Zimbabwe for dia sixth 2026 World Cup qualifying match. Super Eagles captain William Ekong say Friday victory for Rwanda Amavubi na statement di Eagles bin need to put out as di World Cup race reach halfway mark. Nigeria go expect to follow up dia away win by claiming anoda comfortable three points against Zimbabwe wey play 2-2 draw wit Benin, but currently dem dey sixth position for group C. Bafana Bafana dey top thanks to a second-half burst against Lesotho. Date, kick-off time and venue Nigeria vs Zimbabwe dey scheduled for 5pm West African time on Tuesday evening March 245 2025. Dis match go take place for Godswill Apkabio stadium for Uyo Akwa Ibom state. Where to watch Nigeria vs Zimbabwe Fans fit watch di match for Nigeria for SuperSport channel for DSTV. Also follow our website for BBC Pidgin for all di action via live text. Nigeria vs Zimbabwe team news Nigeria Squad: Goalkeepers: Stanley Nwabali (Chippa United, South Africa); Amas Obasogie (Singida Blackstars, Tanzania); Kayode Bankole (Remo Stars) Defenders: William Ekong (Al-Kholood FC, Saudi Arabia); Bright Osayi-Samuel (Fenerbahce SK, Turkey); Bruno Onyemaechi (Olympiacos FC, Greece); Calvin Bassey (Fulham FC, England); Olaoluwa Aina (Nottingham Forest, England); Igoh Ogbu (SK Slavia Prague, Czech Republic) Midfielders: Wilfred Ndidi (Leicester City, England); Raphael Onyedika (Club Brugge, Belgium); Alhassan Yusuf Abdullahi (New England Revolution, USA); Alex Iwobi (Fulham FC, England); Joseph Ayodele-Aribo (Southampton FC, England); Papa Daniel Mustapha (Niger Tornadoes) Forwards: Samuel Chukwueze (AC Milan, Italy); Victor Osimhen (Galatasaray FC, Turkey); Ademola Lookman (Atalanta FC, Italy); Victor Boniface (Bayer Leverkusen, Germany); Simon Moses (FC Nantes, France); Sadiq Umar (Valencia FC, Spain); Nathan Tella (Bayer Leverkusen, Germany); Tolu Arokodare (KRC Genk, Belgium) Ekong say: "E bin dey important to make di statement wey we make, and we dey happy about am, and di way we do am. Of course, we neva qualify and we still get a lot of work, but we don start di recovery in a good way and we just need kotinu to work hard. "I no wan go into di circumstances wey make di first four matches go di way e go. Di good tin is we can still recover and revive di campaign, and we dey do am."

Rwanda vs Nigeria - All you need sabi
Rwanda vs Nigeria - All you need sabi

BBC News

time20-03-2025

  • Sport
  • BBC News

Rwanda vs Nigeria - All you need sabi

Nigeria go jam Rwanda on Friday evening for dia crucial 2026 World Cup qualifying match. Super Eagles dey fifth for group C wit just three points. Dis na one of di tightest groups, three teams – Rwanda, South Africa, and Benin – all dey tied on seven points. Meanwhile, South Africa go dey eye two wins to take control of di group. Na only di group winners go secure direct qualification while di four best runners-up go fight for a playoff spot, as tins be now evri match mata. Egypt, Sudan, Ivory Coast, Tunisia, and Morocco currently dey lead dia groups. Date, kick-off time and venue Rwanda vs Nigeria dey scheduled to kick-off by 5pm West African time on Friday, March 21, 2025. Di match go take place for Amahoro Stadium for Rwanda. Where to watch Rwanda vs Nigeria DSTV go show di match live live for SuperSport. Rwanda vs Nigeria team news Nigeria Squad: Goalkeepers: Stanley Nwabali (Chippa United, South Africa); Amas Obasogie (Singida Blackstars, Tanzania); Kayode Bankole (Remo Stars) Defenders: William Ekong (Al-Kholood FC, Saudi Arabia); Bright Osayi-Samuel (Fenerbahce SK, Turkey); Bruno Onyemaechi (Olympiacos FC, Greece); Calvin Bassey (Fulham FC, England); Olaoluwa Aina (Nottingham Forest, England); Igoh Ogbu (SK Slavia Prague, Czech Republic) Midfielders: Wilfred Ndidi (Leicester City, England); Raphael Onyedika (Club Brugge, Belgium); Alhassan Yusuf Abdullahi (New England Revolution, USA); Alex Iwobi (Fulham FC, England); Joseph Ayodele-Aribo (Southampton FC, England); Papa Daniel Mustapha (Niger Tornadoes) Forwards: Samuel Chukwueze (AC Milan, Italy); Victor Osimhen (Galatasaray FC, Turkey); Ademola Lookman (Atalanta FC, Italy); Victor Boniface (Bayer Leverkusen, Germany); Simon Moses (FC Nantes, France); Sadiq Umar (Valencia FC, Spain); Nathan Tella (Bayer Leverkusen, Germany); Tolu Arokodare (KRC Genk, Belgium) Super Eagles captain William Ekong say three points dey at stake. "I bin dey part di last game for Kigali wey end scoreless, but we know say we no fit afford draw dis time. Our objective na to pick three points and bring some life back to our campaign. "We certainly no dey concerned about di history books and wetin don happun bifor now. qualification for Fifa World Cup na our priority." Di three-time African champions neva achieve victory ova Rwanda for dia kontri, going back to 20 years ago, wen a 2006 Fifa World Cup qualifying match end 1-1 for Amahoro Stadium. For 2011, a 2012 Africa Cup of Nations qualifying match for di Stade Regional de Nyamirambo, wey dey for di outskirts of Kigali, end goalless. For September last year, anoda 0-0 outcome na im di two sides play for di 2025 Afcon qualifying match for Amahoro.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into the world of global news and events? Download our app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store