
Latest on Lagos state house of assembly crisis and wetin law tok on impeachment of a speaker
Reports say e seize control of di office of di Speaker and hold wetin dem fit describe as plenary session wit four lawmakers wey dey loyal to am. Oda lawmakers wey dey present for di 40-member assembly bin boycott di session.
Na on 13 January, majority of di lawmakers of di Lagos state assembly vote to remove di speaker, Mudashiru Obasa ova allegations of gross misconduct, poor leadership, mismanagement of funds and corruption.
Di majority of di lawmakers come elect and swear in Madam Mojisola Meranda as di new Speaker.
However, di impeached Speaker don maintain say im removal no hold water and e dey illegal as lawmakers no follow constitution to remove am, and e declare say im remain di legitimate speaker of di house.
"I don resume and I still remain di Speaker of di Assembly," Oga Obasa tell tori pipo for di Assembly complex on Thursday.
"Nobody remove me. Impeachment or removal na democratic and constitutional, but if you wan do am, you get to follow due process. We get rules for dis house and house rules wey all state assemblies for di south-west dey follow, but dem no follow am," e tok.
Also, for one interview wit Channels TV on Thursday, Obasa claim say madam Meranda don agree to resign as di Speaker during one peace meeting wey leaders of di party for di state arrange.
"One meeting hold for Marina wia we get in attendance all di party leaders and all di members [of Lagos Assembly] and openly Meranda herself tok say she don step down and she don resign."
Although, Ms Meranda neva react to dis latest tok about her resignation, but one interview she get wit tori pipo on Friday, 28 February, show say she still be di speaker of di assembly.
'Obasa action na invasion' - Mojisola Meranda
Meanwhile, di speaker of di assembly don react to Obasa action, she tell tori pipo say "Invasion and breaking into my office na big one."
Madam speaker also torchlight on di issue of her security details wey tori pipo report say dem withdraw from her.
"I get three or four policemen whereas my normal convoy on my team consist of 12 policemen, four DSS and two anti-bomb. But as I get am dis morning I no get dat," she tok.
Earlier, di Lagos state assembly for dia reaction condemn Obasa action.
"Di Lagos State House of Assembly wish to bring to di attention of Lagosians, Nigerians and di global community one incident wey occur on Thursday, wey involve one unsanctioned attempt to convene a plenary session by di former speaker, Hon. Mudashiru Obasa, plus three members," tok-tok pesin for di house, Steve Ogundipe tok for statement.
Di statement add say di rules wey govern plenary sessions of di house dey clear. Valid sitting, require say dem go don send formal notice to all members, di presence of a quorum, an approved agenda, plus di mace – wey be essential symbol of legislative authority. But dis meeting lack dis requirements.
"Dem no meet any of dis procedural requirements during di purported sitting, as only five out of di 40 members dey present, and dat render di sitting unconstitutional and without legislative effect."
How di crisis for di Lagos state assembly take start
Na on 13 January, majority of di lawmakers of di Lagos state assembly vote to remove di speaker, Mudashiru Obasa ova allegations of gross misconduct, poor leadership, mismanagement of funds and corruption.
Di majority of di lawmakers come elect and swear in Madam Mojisola Meranda as di new Speaker.
Afta majority of di lawmakers elect her as speaker, Madam Meranda bin visit di state Govnor Babajide Sanwo-Olu and di Governing Advisory Council, one body wey dey recognised as di topmost group for di Lagos All Progressives Congress (APC) to seek dia blessings.
Dem elect di new speaker wen Oga Obasa dey out of di kontri, wey e tok say dey wrong.
E say di house bin dey on recess, and dem move motion to adjourn sitting to 18 February, wen di impeachment occur.
"We adjourn properly, so if time reach to reconvene, e get to go through di majority leader, di clerk and di speaker and according to di rule, na only di speaker fit reconvene. So if you no follow dat, e no mata di forgery you dey try to perpetrate," Obasa tok for one recent Channels TV interview.
However, since e return, na one crisis or di oda. Di first time na wen some alleged security officials lock di assembly for several hours and dem no let sitting hold. Dis mata make di speaker cry.
Den, di most recent na wen Obasa storm di assembly and preside ova di plenary as speaker wit four lawmakers present.
Oga Obasa don tok several times say im no get issues wit im removal but wit di process wey dem take remove am, e say due process no dey followed.
However, di issue of di legality of im removal dey for court.
Court adjourn case wey Obasa file against di assembly to March
Di Lagos High Court wey sit for Ikeja on Friday, 28 February rule say make all members of di Assembly dey joined as parties for di suit wey di impeached speaker file.
Justice Yetunde Pinheiro also adjourn di case to 7 March to hear all pending applications for di mata.
Obasa bin drag di assembly go court ova wetin e call unlawful removal.
Di lawsuit, wey e file for February also name di current Speaker, Lasbat Mojisola Meranda, as di defendant.
For di application wey dem date 12 February, wey im lawyer Afolabi Fashanu SAN file, di plaintiff bin claim say 36 lawmakers bin remove am from im position on 13 January wen e dey out of di kontri.
Obasa application dey based on nine grounds, wey focus on di interpretation of various sections of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria, 1999 (as amended), and di Rules and Standing Orders of di Lagos State House of Assembly.
Di plaintiff dey challenge di constitutionality of di Lagos State House of Assembly to sit and carry out proceedings during recess without di Speaker convening di House or delegating authority to someone else to do so.
Wetin di constitution tok about di removal of a speaker?
Section 92 of di Constitution of di Federal Republic of Nigeria 1999, as amended, create di offices of di "Speaker and Deputy Speaker of a House of Assembly wey members of di house go elect from among themselves."
Section 92 (2)c state say di speaker or di deputy go vacate im seat "if e dey removed from office by a resolution of di House of Assembly by di votes of not less dan two-third majority of di members of di house."
Ogbonge legal practitioner Deji Adeyanju wey follow BBC Pidgin tok shed more light on wetin di constitution tok and di standing order of di Lagos state house of assembly.
Adeyanju explain say according to di constitution, di removal of a speaker na internal process, dis one mean say, na members of di house fit decide to remove di speaker, and na 2/3rd of di members fit comot di speaker. Di constitution no also tok di offence wey fit warrant members to vote for di removal of di speaker.
E add say, di Lagos assembly dey operate on standing order wey tok how speaker or im deputy fit dey removed.
Firstly, bifor dem comot speaker, lawmakers wey wan remove am for don present am wit formal notice or motion. Under di house rules, dem also dey give notice period. Although di notice period, no dey mandatory, na for members to prepare for debate, and di time for di notice na at di discretion of those wey dey call for di removal.
Also, dem go give di speaker opportunity to defend any accuse against am.
Adeyanju add say wetin di constitution tok na say members of di house must reach a resolution to impeach di speaker, and na two-thrid of di members of di house fit vote for di removal of di speaker or im deputy.
Speaker or deputy speaker need to dey di house bifor dem impeach dem?
One major concern to Obasa na di fact say di impeachment happun for im absence. "If you wan do anything, do am well. Dem remove me becos I dey out of di kontri. Lagos na special place; we no fit belittle di state.
"Wen dem remove former speaker, Rt. Hon Jokotola Pelumi, e dey for di assembly, and we no invite policemen. Wen dem remove my sister, former deputy speaker of di house, Hon. Adefunmilayo Tejuosho, we no invite di police," di embattled lawmaker tok.
Adeyanju say di constitution dey silent on if di speaker need to dey present for di plenary during im removal.
E tok again say wetin di constitution state na two-third majority of di members of di house fit initiate di impeachment process of a speaker.
Although, di lawmakers tok say dem give Obasa di notice, however, Obasa tok say di house dey on recess wen dem impeach am, but di standing order no give room for recess, Adeyanju add.
Dis no be di first time, speaker of di house of assembly go dey removed.
For January 2024, Ogun State House of Assembly bin impeach Speaker Kunle Oluomo.
Na 18 out of di 36 members of di state Assembly bin vote for di impeachment for dia plenary session on Tuesday.
Dem impeach Oluomo for alleged embezzlement of funds, high handedness and oda type offences like dat.

Try Our AI Features
Explore what Daily8 AI can do for you:
Comments
No comments yet...
Related Articles


The Independent
4 days ago
- The Independent
Australian PM reveals why he decided to recognise a Palestinian state
Australian Prime Minister Anthony Albanese criticised Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for being in "denial" about the humanitarian crisis in Gaza. Australia announced its intention to recognise a Palestinian state at the upcoming UN General Assembly, following other G20 members' openness to such recognition. This recognition is conditional on commitments from the Palestinian Authority, including no role for Hamas, demilitarisation of Gaza, and the holding of elections. Mr Netanyahu condemned Australia's decision as "shameful," while Israel 's ambassador to Australia claimed it undermines Israel's security. Mr Albanese stated that Israel's reluctance to listen to its allies contributed to Australia's decision, arguing that a two-state solution offers the best hope to end the conflict.


The Independent
4 days ago
- The Independent
Australia's Albanese says Israeli PM Netanyahu ‘in denial' over suffering in Gaza
Australian prime minister Anthony Albanese said his Israeli counterpart Benjamin Netanyahu was in "denial" about the unfolding humanitarian crisis in Gaza caused by his nearly two-year-long war on the Palestinian territory. Mr Albanese's criticism came a day after he announced Australia would recognise a Palestinian state at next month's UN General Assembly. Australia is the latest member of the G20 after France, the UK and Canada to recognise the Palestinian state if certain commitments are met. The acknowledgement was 'predicated on commitments Australia has received from the Palestinian Authority', Mr Albanese said. Those commitments included no role for Hamas in a Palestinian government, demilitarisation of Gaza and the holding of elections, he said. The Israeli leader last week approved a widely criticised plan to occupy Gaza City claiming that he had no choice but to "complete the job" and defeat Hamas. Mr Albanese said Israel's reluctance to listen to its allies contributed to Australia's decision to recognise a Palestinian state. 'He again reiterated to me what he has said publicly as well which is to be in denial about the consequences that are occurring for innocent people," the prime minister told public broadcaster ABC, recounting a Thursday phone call with Mr Netanyahu. Australia's decision to recognise a Palestinian state is conditional on 'commitments received from the Palestinian Authority' that Hamas will have no role in any future state. Mr Albanese argued on Monday that a two-state solution was the best hope to break the cycle of violence and end the suffering and starvation in Gaza. Mr Netanyahu, addressing a rare press conference, called Australia's plan to recognise a Palestinian state "shameful" even before Mr Albanese had publicly announced it. "To have European countries and Australia march into that rabbit hole, just like that, fall right into it and buy this canard is disappointing, and I think it's shameful," he said. "It is not going to change our position. Again, we will not commit national suicide to get a good op-ed for two minutes." Mr Albanese previously seemed wary of dividing public opinion in the country, which has significant Jewish and Muslim minorities, by taking a firm position on the issue of recognising a Palestinian state. But public mood shifted sharply after Israel said it planned to militarily occupy Gaza, prompting tens of thousands of demonstrators to march across Sydney's Harbour Bridge this month and call for sending humanitarian aid into the besieged Palestinian territory. Israel's ambassador to Australia on Monday criticised Canberra's decision claiming that it undermined Israel's security. 'By recognising a Palestinian state while Hamas continues to kill, kidnap and reject peace, Australia undermines Israel's security, derails hostage negotiations, and hands a victory to those who oppose coexistence," Amir Maimon said in a statement. New Zealand this week announced it was considering recognising a Palestinian state and prime minister Christopher Luxon's cabinet would make a formal decision in September. 'New Zealand has been clear for some time that our recognition of a Palestinian state is a matter of when, not if," foreign minister Winston Peters said. Nearly 150 of the 193 members of the UN have already recognised Palestinian statehood, most of them decades ago. The US and other Western countries have held off, saying that Palestinian statehood should be part of a final agreement resolving the Middle East conflict. Israel's war and siege on Gaza has killed over 61,400 people thus far, left almost the entire the Palestinian territory in ruins, displaced most of its 2.2 million people and caused widespread starvation, according to the health ministry in the Hamas-run Strip and international aid groups. Israel launched a ground and air assault on Gaza after some 1,200 people were killed and 251 abducted during a Hamas attack on southern Israel in October 2023. Most of the hostages have since been freed under ceasefire or other deals, but 50 remain in Gaza. Israel believes around 20 are still alive.


BBC News
09-08-2025
- BBC News
Candidates react afta WAEC reopen portal for WASCCE 2025 results
Di West African Examinations Council (WAEC) don announce say di results portal for di 2025 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) results wey dem withdraw sake of technical glitch don dey open again. According to WAEC candidates fit recheck dia results to see wetin dem get. Di exam body bin announce say dem dey investigate technical issues inside di recently released 2025 WASSCE results. So dem bin temporarily deny access for candidates to check di 2025 result for dia portal. However, WAEC don tok sorry for dia action and beg Nigerians for di mistake wey dem do for di results mata. "Di result portal don dey open again, candidates fit access am now, check and recheck dia results for di WASSCE (SC), 2025." "Once again, we truly dey sorry for di wahala and appreciate your understanding and support," WAEC tok for dia post for Friday night on X. Wetin don change? Afta di announcement of WAEC say dem don reopen di result portal, candidates don begin dey login to check wetin don change for dia results. Some of di candidates say dia results still dey show dia former grade score, while some say dia own result score don change, afta WAEC do di review. One candidate post wit screenshot say e own result dashboard dey show 'error' message. For di screenshot wey e post, di 'error' message say "results no dey available for dis candidate for di specified year and exams diet". Anoda candidate wey reply to WAEC post for X, say im own 'error' message dey show say e don use im result checker card pass di normal time. E post im error message wey read, "di card usage don pass di maximum wey dey allowed. Abeg buy anoda card". Several oda candidates also comment say dia result checker card dey show say dem don reach limit wen be say na only one time dem don use am. Meanwhile, some oda candidates wey chook mouth inside di result review mata say some of dia results don change. One candidate lament say her English Language result neva change wia she add say na dat result dey hold her back from admission. She say she no fit go for admission screening sake of di 'D7' wey she get for her English Language, and upon dat, her card don expire join. "Noting don dey rectified, my English still dey D7, my card don expire too. Please dem don invite me for screening to study nursing now my English na di only tin wey dey hold me back. I no fit go for di screening wit dis D7," she write for X. While dis problem no be one sided issue, WAEC expect make dia candidate dey 'check and recheck' dia result portal to see di review wey dem do ontop di results. Also, some Nigerians don sama knock give WAEC say dat kain issue no suppose hapun as dem get enough time to work on di results. Why WAEC review 2025 WASSCE results Di national examination body for one statement on dia X account tok say during one internal review, one internal post result release procedure reveal some technical bugs for di results. Waec bin say sake of di review, dem don decide to urgently review and correct di technical glitches wey lead to di situation, as a result, access to di WASSCE (SC) 2025 results don dey temporarily denied on di result checker portal. Dem say make pipo wey don check dia result before, make dem go back afta 24 hours to re-check. Di council say as part of efforts to check examination malpractice, dem bin embark on one innovation (paper serialization) wey di national examination body bin already deploy. Dem carry out di paper serialization in Mathematics, English Language, Biology and Economics, but one internal post result release procedure bin reveal some technical bugs for di results. Di national examination body say sake of dat, dem bin get to shut down di result checker portal and try resolve di mata wit "transparency and urgency" within di next 24 hours. How WAEC candidates perform for WASSCE 2025 Na on Monday, 4 August, Waec release di results of di 2025 West African Senior School Certificate Examination. But in comparison to previous results, dis na di worst results in five years. Di Head of Nigeria's Office (HNO) of Waec, Amos Dangut, bin tok say dis year result record 33.8 per cent decrease in performance compared to 72.12 per cent wey dem record for 2024. "Out of di total number of candidates wey sit for di examination for Nigeria, 1,517,517 candidates, wey represent 77.06 per cent, get dia results fully processed and released while 451,796 candidates, wey represent 22.94 per cent, get one or more of dia subjects still under processing sake of some issues to dey resolved," e tok. Amos Dangut say Waec don withhold results of 192,089 candidates sake of different reported cases of examination mago-mago. Dis number represent 9.75 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination. According to Dangut, di figure represent 2.17 per cent decline if you compare wit di 11.92 per cent wey dem bin record for di 2024 edition of di same examination.