Latest news with #Uyo


BBC News
19 hours ago
- BBC News
'I dey shame, my reputation don go' – Ibom Air passenger Comfort tok
For di first time since di Ibom Air flight saga happun, di female passenger Comfort Emmanson wey dey di middle of di incident don tok her side of di tori. On 11 August, Emmanson bin go viral afta she chop accuse say she assault airline officials on board di flight and security officials wey lead to her arrest, prosecution, and no fly ban. Authorities bin later lift di no fly ban and free her of di charges. For inside one almost 12 minutes long video on her Instagram page, Ms Emmanson bin give detailed account of wetin happun on Sunday, 10 August, as she board di flight from Uyo to Lagos state. She say contrary to tori wey bin first trend say di katakata wey happun on board na bicos she no gree off her fone, no be true. 'I switch off my point' She allege say di kasala start wen one flight attendant wey she identify as Juliana, insist say she must switch her fone instead of di flight mode she put am. According to Ms Emmanson, she say she bin hold two fones, she off one but di second fone power button dey faulty. "I show her di fone and I tell her say di power button dey bad. She say I still fit switch am off through di settings. I say make she help me but she say she no go touch my phone. Wit di help of anoda passenger, I later manage to switch off both phones," she explain. 'I no be troublemaker' Emmanson claim say di kasala burst wen di same crew member no allow her come down from di plane wen dem land Lagos. "Wen we land Lagos, everybody bin dey come down from di aircraft but I go pee first. By di time I finish everybody don already go down. As I go pack my things say make I drop, di air hostess stop me and I ask her why you stop me? "She no tok she just look me wit bad eye. I pick my fone begin record. Dat na wen she push back inside di aircraft, drag my wig frontal, tear my clothes and break my necklace, and di pain bin dey unbearable. She also add say dem drag her outside, naked her for public and video her in di process. "My body outside, my naked body outside, plus di pain. Noe dey too much for one pesin to bear. I begin dey ask dem, 'Why you go do dat me?' You still video me again and put am out there." Emmanson say di thing pain her and she bin react out of anger afta dem assault her. She insist say she no provoke di attendant. "God know I no go ever hit elderly woman wey old enough to be my mother. Na di pain she put me through, she drag my wig and naked me for public, dat na wetin make me react." Di incident bin quickly go viral as airport security intervene. Videos wey later trend show as dem drag Emmanson comot di plane as her cloth tear. Di video make pipo para, reactions begin fly up and down. Ibom Air and di Airline Operators bin impose a 'no fly ban on her'. Ibom Air press five count charges on her, wey include assault. Dem later withdraw di charges and lift di ban following di intervention of plenty Nigerians. For di video, Emmanson wey claim say she be real estate consultant say she no know how to go from here, how to face di world, as she dey embarrassed to even go out, afta her naked body don go viral. "Dem tear my clothes, expose my body, and pipo begin dey take videos. I felt humiliated. Like, di trauma dey so much on me bicos I no even fit go out freely anymore becos my body don go viral. Some pipo even turn am into stickers," she tok. She say she no know how to face her family, friends and go on wit her business. She worry about her future afta dis incident.


BBC News
3 days ago
- BBC News
Ibom Air incident: 'Comfort Emmanson dey OK for now and in good condition'
Comfort Emmanson Bob na im go decide wetin go hapun next wit di incident wey involve her and Ibom Air. Dis na wetin Barrister Adefunke Adewale wey be women's right advocate and one of di lawyers wey represent Ms Emmanson for her case tok. Di incident wey don form big conversation for Nigeria and beyond and cause several reactions bin hapun on Sunday, 10 August. Ms Comfort Emmanson bin board Ibom Air Uyo–Lagos flight and di airline bin accuse her say her conduct bin pose serious threat to di safety of dia crew, passengers, and aircraft. Dem say Ms Emmanson bin attack dia hostess sake of say dem instruct her to switch off her mobile phone wey dey in line wit standard aviation safety procedures, wey she no gree do until di Pilot-in-Command make di announcement, afta which one fellow passenger wey sidon beside her collect di phone and switch am off. action wey lead to gbasgbos from Ms. Emmanson. Na di video wey circulate wey di public see spark different reactions as to di conduct of both Ms Emmanson and di airline and ground staff wit di way dem handle di mata and also release di video wey show Ms Emmanson in an indecent state. Authorities go later detain her, charge her to court and remand her for Kirikiri. Although Ms Emmanson never tok her own side of di tori, one eyewitness bin don tok for one interview for Channels Television say dem provoke her, sometin wey her lawyer repeat. "Comfort na pesin pikin, if na minister pikin, president pikin or senator pikin, dem for treat am dat way? Na Comfort go tell us wia we go go from hia, she be adult, we no fit decide for am, If she decide to further file civil case, she go carri us along". Adewale tok. Barrister Adewale and two oda lawyers Barrister Adams Atakpa and Barrister Idowu na im follow represent Ms Emmanson for court. "I no get di direct consent of Comfort or her family to represent her, Na free work we do. I no collect any money for di work, I do wetin I do for humanity". She say she bin go court on her own on Tuesday to see if dem fit meet di bail condition but di court reject di two sureties wey show face, say make dem bring family member wey go follow do surety for am, so dem no fit release am dat day. "Na Wednesday morning we come hia say minister don direct make dem withdraw di case. We come court and di prosecution team withdraw di case, dem release Comfort unconditionally. No be say we no dey happy, we dey happy". She confam say Ms Emmanson dey ok for now and dey good condition. According to di lawyer she and Comfort do small tok tok and she say wetin hapun inside di aircraft na sake of di way di second air hostess take confront Ms Comfort provoke her to react di way she react. She confam say two air hostess bin approach her client inside di aircraft, say one dey polite but di second one dey confrontational wen she approach di passenger. "Di air hostess for let di girl be wen di 26 years old tell her say di phone don already dey for airplane mode and her switch off button dey bad. She no show professionalism for her work" na so she tok. According her, after landing dem restrict di lady from disembarking and push her to one corner and allow odas to comot from di plane while dem hold her back. According to her, for pesin wey wan file civil cases for matas like dis one, di pesin go cari di mata go high court, she go bring action for compensation wey mean say she go tok wetin she want to calm bodi, as dem don breach her fundamental human rights wey dey di kontri constitution. She go tok her claims and court go begin di case.
Yahoo
5 days ago
- Yahoo
Passenger Dragged Off Plane by Authorities After Allegedly Fighting with Cabin Crew Over Turning Off Her Cellphone
NEED TO KNOW A passenger got into a physical dispute over turning off her cellphone, an airline claims, leading her to be dragged of the plane by authorities Ibom Air issued a statement about the incident, alleging that Ms. Comfort Emmanson "posed a serious threat to the safety" of its crew, passengers and aircraft The airline also said the woman has been banned from flying with the company, citing its "zero-tolerance policy"A passenger was dragged off a plane in Nigeria after allegedly refusing to switch off her cellphone. The incident occurred on Sunday, Aug. 10 on an Ibom Air aircraft that was traveling from the Victor Attah International Airport in Uyo to the Murtala Muhammed International Airport in Lagos, the airline confirmed in a statement shared on Facebook. The airline identified the passenger as Ms. Comfort Emmanson, claiming that her "conduct posed a serious threat to the safety" of crew, passengers and the aircraft. The airline explained that she had reportedly been "instructed in line with standard aviation safety procedures, to switch off" her cellphone, adding that the pilot-in-command also made an announcement. Another passenger sitting next to Emmanson then allegedly took her phone and switched it off, prompting "a verbal tirade" from her, the airline said, adding that "the situation was eventually calmed, and the flight departed as scheduled." After the plane arrived in Lagos, Emmanson reportedly "waited for all other passengers to disembark and then proceeded to confront" the crew member who had instructed her to turn off her phone, alleging that she tore off the flight attendant's wig, removed her glasses and "slapped her several times." The moment was captured on camera, per a video shared by the Associated Press, with the clip showing the passenger being dragged down the aircraft's steps. Ibom Air alleged in the statement that Emmanson had also "attempted to forcibly remove a fire extinguisher to use as a weapon, an act that could have damaged and grounded the aircraft." The pilot-in-command ended up alerting security, and the passenger was "restrained and removed from the aircraft by force," the airline continued adding that Emmanson was then taken into custody by the Federal Airports Authority of Nigeria (FAAN) security before being handed over to the Nigeria Police Force for further investigation. Emmanson will no longer be permitted to fly with the airline, the airline noted in its statement, adding that the company has a "zero-tolerance policy towards any form of unruly or violent conduct that threatens the safety of passengers, crew or equipment." "Safety remains our highest priority. We urge all passengers to comply with crew instructions at all times for the safety, security and comfort of everyone on board," the airline concluded. Never miss a story — sign up for to stay up-to-date on the best of what PEOPLE has to offer, from celebrity news to compelling human interest stories. According to the AP, Michael Achimugu, Director of Public Affairs and Consumer Protection at the Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA), addressed the incident by saying, "When cabin crew ask you to turn off your phone before takeoff or landing, simply comply." He added, "I can't understand why simple routine issues would lead to incidents like this. Passengers need to understand they have responsibilities, not just rights." However, in a statement posted to X, the Nigerian Bar Association (NBA) condemned the airline's actions, demanding that "Ibom Air immediately withdraw the lifetime ban, issue a public apology to Ms. Emmanson, and cooperate fully with an impartial investigation into this incident." The Federal Airports Authority of Nigeria, Ibom Air, the Nigeria Police Force, the Nigerian Civil Aviation Authority's Achimugu and the Nigerian Bar Association didn't immediately respond when contacted by PEOPLE for additional information. Read the original article on People


The Sun
11-08-2025
- The Sun
Moment plane passenger bundled screaming onto airport bus after punching stewardess & ‘refusing to turn off her phone'
THIS is the shocking moment a furious airline passenger punched a flight attendant after being told to "turn off her phone". The aggressive outburst resulted in the woman being hauled off onto an airport bus by a group of staff. 5 5 5 The chaos erupted on Sunday on a domestic flight from the city of Lagos, Nigeria, to the town of Uyo, around 400 miles away. A woman was asked by Ibom Air cabin crew to turn off her phone as the plane was heading towards the runway. But she is said to have ignored the request, refusing and insisting she would switch her phone to flight mode instead. When things became more heated, the pilot turned the aircraft back to the terminal at Lagos's Murtala Muhammed International Airport. The woman was forced to get out of her seat and brought to the front of the plane, where she hit a flight attendant standing in the doorway. In the shocking video, the staff member can be heard saying: "She is hitting me. She is f***ing hitting me." The attendant raises her hands to protect her face from further blows. The incensed passenger shouts: "What did you do?" The passenger is then seen putting on her jacket and being removed from the plane with her luggage. Once outside, security staff were forced to restrain her. Moment drunk Brit pensioner, 66, is left with broken arm after getting into fight with Thai bar girl & being thrown to ground At one point, the passenger even swings a small leather handbag at staff. The woman shout and swears at airport officials before attempting to attack one. Staff had to lift her onto the airport bus, where she continued to struggle. Ibom Air has imposed a lifetime ban on the passenger, according to local outlet Business Day. A statement by the airline read: 'Ibom Air reiterates its zero-tolerance policy towards any form of unruly or violent conduct that threatens the safety of passengers, crew, or equipment. "Such behaviour will be met with the strongest possible response, including legal action and permanent restriction from our services." It added that it "commended the bravery and professionalism" of its crew and the support of airport staff and the Nigerian Police. Speaking about the incident, Michael Achimugu, Director of Public Affairs and Consumer Protection at the Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA), reminded passengers that they should respect instructions by cabin crew. He said: "When cabin crew ask you to turn off your phone before take-off or landing, simply comply. "I can't understand why simple routine issues would lead to incidents like this. "Passengers need to understand they have responsibilities, not just rights." It comes after a brawl recently erupted onboard a flight when some passengers reportedly refused to keep quiet after the lights were dimmed. Shocking footage from an AirAsia flight from Kuala Lumpur to China shows several people wrestling in the middle of the aisle. Tensions flared when a man seated behind a row of three young women became furious when they kept 'talking loudly'. He then shouted: "'Shut up... are you stupid? I want to sleep." Footage shows a woman in a green outfit and baseball cap leaning across the seat while repeatedly throwing punches at the man, who cowered beneath the food tray. Desperate AirAsia cabin crew in the company's distinctive red dresses can be seen wrestling with those involved in the fight. 5 5


BBC News
11-08-2025
- BBC News
Real reason why Ibom Air ban traveller in viral video from flying wit dem
Ibom Airline don ban one female passenger for allegedly assaulting cabin crew members and security officers during her flight from Uyo to Lagos on Sunday. Ibom Airline tok say di passenger wey dem identify as Ms Comfort Emmanson no behave well and "pose threat serious threat to di crew, passengers, and aircraft while travelling on board from Uyo-Lagos." Di airline tok say dem don submit dia report to Nigerian Civil Aviation Authority (NCAA) and place travel restriction on her. "Ibom Air don submit report on di incident to di Nigerian Civil Aviation Authority, and place travel restriction on Ms. Emmanson, go no longer dey permitted to fly on any of our aircraft," di statement tok. Wetin happun, Ibom Air tok Ibom Air tok say afta cabin crew instruct passenger make dem switch off dia phones in line wit aviation safety procure wen dem wan depart from Uyo, but Ms Emmanson refuse, den anoda passenger snatch her phone to switch am off. Ibom Airline claim say wen dem arrive for Lagos airport, Ms Emmasonson den confront di purser wey instruct passengers make dem switch off dia phone wen di airplane wan depart from Uyo. "Ibom Air don confam say on Sunday, August 10, 2025, one incident occur on board our Uyo–Lagos flight involving one passenger, Ms Comfort Emmanson, her conduct posed serious threat to di safety of our crew, passengers, and aircraft," di statement tok. "Shortly bifor take-off from Uyo, dem give Ms Emmanson instruction in line wit standard aviation safety procedures, to switch off her mobile phone. She refuse to comply until di Pilot-in-Command wey make di announcement, afta which one fellow passenger, wey seat beside her take di phone and switch am off." "Dis action prompt verbal trade from Ms Emmanson. Di situation eventually calm, and di flight depart as scheduled." Di airline allege say she physically attack di purser and forcibly comot di wig wey dey her head, her glasses and throway everything for floor, den use her shoe to physically attck di purser. Ibom Airline tok say she further attack security officers befor dem restrain am and hand her ova to di police. "She slap her several times and wen di oda cabin crew member try to intervene, she slap her too. She den attempt to forcibly remove di fire extinguisher to use weapon, di act fit damaged and ground di aircraft," di statement tok. "Di arrival of Ibom Air Security personnel, no stop di passenger as she attack dem as well, lashing out violently at both Ibom Air and FAAN security." Ibom Airline tok say di airline get zero-tolerance for any violent behaviour or conduct wey go threaten di safety of passengers, crew, or equipment. Di said woman Ms Comfort Emmanson neva tok her side of di story. BBC don also try reach di Lagos state police command for comments but dem neva respond. Dis dey happun just days afta di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) alert federal authorities make dem torchlight and prosecute popular Nigerian Fuji musician Wasiu Ayinde Marshall alias K1 De Ultimate. For di last development, di NCAA petition di Attorney-General of di Federation (AGF), Lateef Fagbemi and di Inspector-General of Police (IGP), Kayode Egbetokun, make dem do full investigation into wetin happun between K1 De Ultimate and ValueJet officials for Abuja airport on Tuesday. NCAA say dia investigation find say di musician allegedly violate di Nigeria Civil Aviation regulations. Kwam 1 trend afta video of im altercation wit ValuJet officials spread for social media. Di veteran 65-year-old fuji artiste don apologise for di incident.