logo
'I dey shame, my reputation don go' – Ibom Air passenger Comfort tok

'I dey shame, my reputation don go' – Ibom Air passenger Comfort tok

BBC Newsa day ago
For di first time since di Ibom Air flight saga happun, di female passenger Comfort Emmanson wey dey di middle of di incident don tok her side of di tori.
On 11 August, Emmanson bin go viral afta she chop accuse say she assault airline officials on board di flight and security officials wey lead to her arrest, prosecution, and no fly ban. Authorities bin later lift di no fly ban and free her of di charges.
For inside one almost 12 minutes long video on her Instagram page, Ms Emmanson bin give detailed account of wetin happun on Sunday, 10 August, as she board di flight from Uyo to Lagos state.
She say contrary to tori wey bin first trend say di katakata wey happun on board na bicos she no gree off her fone, no be true.
'I switch off my point'
She allege say di kasala start wen one flight attendant wey she identify as Juliana, insist say she must switch her fone instead of di flight mode she put am.
According to Ms Emmanson, she say she bin hold two fones, she off one but di second fone power button dey faulty.
"I show her di fone and I tell her say di power button dey bad. She say I still fit switch am off through di settings. I say make she help me but she say she no go touch my phone. Wit di help of anoda passenger, I later manage to switch off both phones," she explain.
'I no be troublemaker'
Emmanson claim say di kasala burst wen di same crew member no allow her come down from di plane wen dem land Lagos.
"Wen we land Lagos, everybody bin dey come down from di aircraft but I go pee first. By di time I finish everybody don already go down. As I go pack my things say make I drop, di air hostess stop me and I ask her why you stop me?
"She no tok she just look me wit bad eye. I pick my fone begin record. Dat na wen she push back inside di aircraft, drag my wig frontal, tear my clothes and break my necklace, and di pain bin dey unbearable.
She also add say dem drag her outside, naked her for public and video her in di process.
"My body outside, my naked body outside, plus di pain. Noe dey too much for one pesin to bear. I begin dey ask dem, 'Why you go do dat me?' You still video me again and put am out there."
Emmanson say di thing pain her and she bin react out of anger afta dem assault her. She insist say she no provoke di attendant.
"God know I no go ever hit elderly woman wey old enough to be my mother. Na di pain she put me through, she drag my wig and naked me for public, dat na wetin make me react."
Di incident bin quickly go viral as airport security intervene. Videos wey later trend show as dem drag Emmanson comot di plane as her cloth tear. Di video make pipo para, reactions begin fly up and down.
Ibom Air and di Airline Operators bin impose a 'no fly ban on her'. Ibom Air press five count charges on her, wey include assault. Dem later withdraw di charges and lift di ban following di intervention of plenty Nigerians.
For di video, Emmanson wey claim say she be real estate consultant say she no know how to go from here, how to face di world, as she dey embarrassed to even go out, afta her naked body don go viral.
"Dem tear my clothes, expose my body, and pipo begin dey take videos. I felt humiliated. Like, di trauma dey so much on me bicos I no even fit go out freely anymore becos my body don go viral. Some pipo even turn am into stickers," she tok.
She say she no know how to face her family, friends and go on wit her business. She worry about her future afta dis incident.
Orange background

Try Our AI Features

Explore what Daily8 AI can do for you:

Comments

No comments yet...

Related Articles

Resident tok how bandits kill plenti worshippers for Katsina mosque, beg govment for help
Resident tok how bandits kill plenti worshippers for Katsina mosque, beg govment for help

BBC News

time19 minutes ago

  • BBC News

Resident tok how bandits kill plenti worshippers for Katsina mosque, beg govment for help

Bandits don attack mosque for Unguwan Mantau community, Malumfashi Local Govment Area for Katsina State, northern Nigeria, and kill plenti worshippers and injure odas. According to one resident wey follow BBC News Pidgin tok, na 25 worshippers di bandits kill and na five pipo dem injure. Di eyewitness wey no want make we mention im name say di attack happun around 6am for morning afta pipo finish dia Fijr prayer. "Around 5:45am, di gunmen meet pipo for mosque afta dem finish Fijr prayer, dem just open fire on dem. "Na immediately 25 pipo die, and more dan five odas injure, dem dey receive treatment for Katsina hospital now," e tok. E add say wen di attack dey happun, dem no get any help from security pipo. "Na afta di gunmen finish to kill pipo bifor security officers come. Dem snap picture and within two hours, dem don waka comot," e tok. E add say since afta di attack, pipo dey live for fear, and some don run comot from di community to save dia lives. "As I dey tok to you now, all my family no dey house again, dem don run comot for di community, pipo wey remain no plenti," e add. Di resident beg di state govment and security pipo make dem help bring peace for dia community. We dey update dis tori

Anambra authorities, police condemn treatment of corps member wey security operatives strip naked inside viral video
Anambra authorities, police condemn treatment of corps member wey security operatives strip naked inside viral video

BBC News

time3 hours ago

  • BBC News

Anambra authorities, police condemn treatment of corps member wey security operatives strip naked inside viral video

Di video of one young lady wey dem identify as corp members for Anambra state wey vigilante operatives bin assault tearing her clothes along wit odas don go viral. According to di video wey go viral, men wey wear mufti wit heavy guns bin enta into one compound beating a lady. Dem tear her clothes and drag her left and right till dem push her out. Wit di video wey dey go viral for social media, di security operatives wit dia guns bin join hand beat di young female corp member wit slaps, blows and di gril dey shout 'please' but dem no leave her. Di incident happun for Oba, Idemili South local govment area of Anambra State, and e don cause serious tok tok for social media. According to di police for Anambra state, na di Aguechemba vigilante group bin carry out di assault. Howeva, Anambra authority condemn di act sat na unfortunate incident wey no suppose happun. Anambra authority react to di corps members assault video Di special adviser to Governor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi don react to di trending video wia vigilante operatives bin assault di female corper and odas. E say di operatives bin dey carry out operation wen di incident happun but e dey veri sad say dat kain tin happun. "Wetin happun for dat incident dey veri unfortunate. We no rule out dis unfortunate incident wey happun, we get di report and di step we take be say we arrest di operatives wey dey involved for di act." "We detain dem, invite di victim wit di NYSC state coordinator. Den we say, our men wey go dat place, dia action dey unacceptable." Di special adviser to Anambra state govnor tok for di interview wit ChannelsTV say na men of di local security outfit Agunechemba bin carry out di operation. E say dem bin dey pursue some suspected cultist wey run inside di compound wey di mata happun. According to Emeakayi, Udo Ga-Achi na di operational code name wey di operatives dey take carry out di operation. E say di operation get di police, DSS, army, civil defence and all di security agencies for Anambra state but Agunechemba na di state security outfit wey be say na di law create of homeland security law create am. According to di community security adviser for Anambra state, na di law of di state empower di Agunechemba security outfit 'to enta any compound wey any questionable pesin run into wen dem dey pursue am.' E say di Agunechemba security outfit fit form squad for di purpose of tackling kidnapping, banditry, cultism, and any oda vices. For dis video wey dem naked di female corper and beat odas, e say di Agunechemba security outfit bin purse suspected cultist into di compound and dem begin search di building. E say na wetin carry di operatives go dat building be dat. "Di Agunechemba for Oba town bin dey chase group of cultist guys wey dey ride for motorcycle. During dat period, di suspected cultist run into one isolated area and into some houses." "Di operatives pursue dem into di compound, wia some pipo run into different houses and di operatives enta dia to bring dem out to screen and identify dem." Howeva, e condemn di action of di security operatives wia e tok say dat assault no suppose happun. Police react to assault of corp member Meanwhile, di Anambra State Police Command don condemn di sad incident wia vigilante bin naked di young female corpr member. "Di assault dey carried out by vigilante operatives. Following di incident, we don identify di suspects wey dey involved." According to di statement by di Anambra state police tok tok pesin, SP Tochukwu Ikenga, e say di reason why di case neva move forward since e happun na becos say di victim dey unavailable. E say dem don begin investigation into di case, and dem no go gree for any form of assault becos say na criminal offence under Nigerian law. "Any form remain criminal offence under di Nigerian Law and get di right to take necessary legal action to help di court proceedings while we dey wait for di victim." Police also cut warning give vigilante groups say make dem stop dey use brutality and abuse of authority during dia operation. We don reach out to di Anambra state NYSC make dem tok dia own side of di mata and wetin do di victim wey dem naked for di video. Also, we don reach out to di lawyer wey dey represent di young lady wey security operatives bin assault, to hear her own account.

'I dey shame, my reputation don go' – Ibom Air passenger Comfort tok
'I dey shame, my reputation don go' – Ibom Air passenger Comfort tok

BBC News

timea day ago

  • BBC News

'I dey shame, my reputation don go' – Ibom Air passenger Comfort tok

For di first time since di Ibom Air flight saga happun, di female passenger Comfort Emmanson wey dey di middle of di incident don tok her side of di tori. On 11 August, Emmanson bin go viral afta she chop accuse say she assault airline officials on board di flight and security officials wey lead to her arrest, prosecution, and no fly ban. Authorities bin later lift di no fly ban and free her of di charges. For inside one almost 12 minutes long video on her Instagram page, Ms Emmanson bin give detailed account of wetin happun on Sunday, 10 August, as she board di flight from Uyo to Lagos state. She say contrary to tori wey bin first trend say di katakata wey happun on board na bicos she no gree off her fone, no be true. 'I switch off my point' She allege say di kasala start wen one flight attendant wey she identify as Juliana, insist say she must switch her fone instead of di flight mode she put am. According to Ms Emmanson, she say she bin hold two fones, she off one but di second fone power button dey faulty. "I show her di fone and I tell her say di power button dey bad. She say I still fit switch am off through di settings. I say make she help me but she say she no go touch my phone. Wit di help of anoda passenger, I later manage to switch off both phones," she explain. 'I no be troublemaker' Emmanson claim say di kasala burst wen di same crew member no allow her come down from di plane wen dem land Lagos. "Wen we land Lagos, everybody bin dey come down from di aircraft but I go pee first. By di time I finish everybody don already go down. As I go pack my things say make I drop, di air hostess stop me and I ask her why you stop me? "She no tok she just look me wit bad eye. I pick my fone begin record. Dat na wen she push back inside di aircraft, drag my wig frontal, tear my clothes and break my necklace, and di pain bin dey unbearable. She also add say dem drag her outside, naked her for public and video her in di process. "My body outside, my naked body outside, plus di pain. Noe dey too much for one pesin to bear. I begin dey ask dem, 'Why you go do dat me?' You still video me again and put am out there." Emmanson say di thing pain her and she bin react out of anger afta dem assault her. She insist say she no provoke di attendant. "God know I no go ever hit elderly woman wey old enough to be my mother. Na di pain she put me through, she drag my wig and naked me for public, dat na wetin make me react." Di incident bin quickly go viral as airport security intervene. Videos wey later trend show as dem drag Emmanson comot di plane as her cloth tear. Di video make pipo para, reactions begin fly up and down. Ibom Air and di Airline Operators bin impose a 'no fly ban on her'. Ibom Air press five count charges on her, wey include assault. Dem later withdraw di charges and lift di ban following di intervention of plenty Nigerians. For di video, Emmanson wey claim say she be real estate consultant say she no know how to go from here, how to face di world, as she dey embarrassed to even go out, afta her naked body don go viral. "Dem tear my clothes, expose my body, and pipo begin dey take videos. I felt humiliated. Like, di trauma dey so much on me bicos I no even fit go out freely anymore becos my body don go viral. Some pipo even turn am into stickers," she tok. She say she no know how to face her family, friends and go on wit her business. She worry about her future afta dis incident.

DOWNLOAD THE APP

Get Started Now: Download the App

Ready to dive into a world of global content with local flavor? Download Daily8 app today from your preferred app store and start exploring.
app-storeplay-store